America first lady and Obama wife,Michelle don ansa di queshon wey Naija
born rapa,Wale ask her for one join bodi meeting to soport di Reach
Higher campaign and FLOTUS.
Wale askam say if she get anoda differen job,wetin she go like do?She ansa one time say;
She go like to be Beyonce.
As she dey yarn wit smile for her face,she even cane Beyonce dancestep from di song,'Single Ladies'.
Beyonce
and Michelle Obama don dey veri close for some years now and she even
paform for her 50 years birthday celebration last year.
No comments:
Post a Comment