Some worwor women fit born fine pikin but make we yarn di truth,if man fine,woman fine,di chance say dem go born a veri veri biutifu and handsome pikin,dey dey veri high.
If u fine,u can't just carry born atutupoyoyo.
Flavour di baby oku singa wey like to dey whine waist for gehs,na fine boy and forma miss Nigeria and di nomba 2 baby mama foram,Anna Banner,na fine malawi too.
She born one fine dota for Flavour last August.
Like play,like play,di pikin don dey mature dey go.
Ova-fine don envelope di pikin.
Chai!
She fresh finish.
Flavour you beta nor carry cutlass o bicos nobodi carry for u o.
U don enta one chance wit dis fine baby.
No comments:
Post a Comment