Some pipo say Igbo dey giv dem inspirayshon,some say e dey gidem ginja.
Anyway I nor dey dia head to know weda na true or not but we know say police and NDLEA nor dey use eye see wia dem dey smoke or sell igbo.
For dis ekelebe to pose to snap pishor wit dis boy wey dey smoke lala,naim be say di boy get sense passam.
From di pishor,di police man dey veri hapi to dey di foto.
Gofment sopose arest di policeman and live di boy.
Wen dem say naija police bad finish,some of us dey argiu say na lie bicos we don see some gud ones too.
No comments:
Post a Comment