MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 30 June 2016

YEMI ALADE DON YARN SAY, DEM BEYONCÈ NOR BETA PASS NAIJA MIUZISHANS BUT....


Awards wina Yemi Alade join some oda Africa miuzishan attend dis year BET Awards for Los Angeles.
She yarn on top Instagram say she hapi say she watch miuzishans like Beyoncé,Alicia Keys,Jennifer Hudson,Usher live on stage for one nite.
She say,one tin wey she notice be say,apart from say dis pipo tight,di diferens bitwin dem and naija miuzishans na,di opotuniti wey dem get pass us.
Ok o,we don hia.

KAFFY SELIBRATE HER BIRTHDAY WIT DOG STYLE PICHORS


Big time dansa,Kaffy dey selibrate her betday today and she reliz monkey style foto to take selibrate.
I hope say she don cook kip?
Nor be to pose like dog wey won tiff fish.
Hunga dey di town and wen baiday dey like dis,pipo go take advantage go blast wack make today own for comot.
Anyway,our tori room dey kongratulate u Kaffy.
Hapi betday.

Wednesday 29 June 2016

KATE HENSHAW DON WARN AKPORORO TO REMOVE HER NAME FROM HIN SHOW BICOS NOBODi TELAM BIFOR DEM PUT HER NAME FOR Di ADVERT


Nollywood big name Kate Henshaw,don warn comedian Akpororo to remove her name from hin show wit imidiate ifect bicos nobodi yarnam about di show bifor dem start to use her name and her face for di advert.
Her manager reliz di statement wey dem take giv Akpororo sirios warning on top Instagram.
Akordin to her,she say,e get wetin dem dey call RESPECT for di industri.
So e go beta welwell di moment pipo take note of dat tin wey dem dey call RESPECT.
She say make Akpororo nor tink say she be stupid pesin just bicos she dey open her 32 and she dey simpo.
So diafor,she don give 48 hours to di oganaizas of di 'Akpororo Vs Akpororo' show wey go appun for Eko hotel,Lagos next wikend to remove her name from all di advert.
Report wey just dey rich me now as I dey write dis tori be say,as a sharp guy,Akpororo don rosh apolojaiz to Kate Henshaw make dem for nor go katch winch on di day of di show.

Tuesday 28 June 2016

MISSING PESIN: ADAMAWA SINGA ADO DAUKAKA,DEY MISS AFTA HE YAB DIA POLITICIANS FOR HIM NEW SONG


Why e be say na only wen u praise politishan naim u fit be dia frend?
No wonda Fela nor get dia time.
He own na to enta shrine,wrap sontin,get inspirashon and yab politishans welwell.
Now Adamawa state miuzishan,Ado Daukaka don loss as him family don dey look foram for sometime now.
One of hin broda Atiku Mustapha say,hin dey sure say na bicos Ado curse polishans espeshali di ones wey dey di state hause of assembly for him new song,'Gyara Kayanka',naim make dem kidnapam.
For di song he yab APC politishans welwell say,no diferens bitwin dem and pipo wey dem replace.
Akordin to di tori,he comot for haus earli mormor of June 25 go mosque and till today he neva return.
He reliz di song on June 24 and on di 25 dem just kpake di bobo hide.
Altho di chairman of di konsign pipo of Adamawa pipo,Hussaini Bello,say,di missing of Ado Daukaka na pure robish and dem go do anytin to make sure di pipo wey dey bihind di mata,go sofaram.

Monday 27 June 2016

ORITSEFEMI DON FINALLi ARREST HIN FORMA MANAGER,DANKU AFTA HE THREATEN TO ARRESTAM SINCE JANUARY


Police is yor frend,na so dem talk am.
Oritsefemi don form frendship wit police on top hin forma manager head.
Yusuf Adepitan A.k.a Danku na di forma manager of Oritsefemi but dem dey kwanta siriosli since late last year.
Oritsefemi bin yarn us say een go arrest Danku and him mama since January bicos di bobo dey play am ojoro for many years anytime wey bizness come.
He also say,Danku dey use hin konpini name dey do bizness without him pamishon.
Femi say many shows money wey pipo pay enta him account as di manager,Danku don use evritin run.
Danku also tell tori Pipo some time ago say,naim pick Oritsefemi from Ghetto and change hin life.
Oritsefemi quik quik tell tori pipo says dat na big lie!
Akordin to di di double wahala singa,he say,na since 1996 for Sunday rendezvous him start to sing.
So nor be today he dey make money.
He say Danku even dey telam say him na een big fan dat time,so how he kon take pickam from ghetto?
Na di Lagos State Police Command for Muson senta,arrest Danku for 'Pencil Unbroken',di comedy show wey appun yestaday.
As at wen we dey report dis tori,Danku dey shine eye for di Zone 2 Police Command for Onikan,Lagos.
We go bring una more tori as e take enta.

NOLLYWOOD STAR DAKORE WON KILL PESIN WIT BEAUTY WIT EEN LATEST FOTO DEM


One of di most biutifu malawi for nollywood,Dakore Akande,don reliz some wicked pikchors to take oppress di street.
Dis kain biuti fit make hosband nor dey branch anywia afta he close from work.
Wey dem say pikin get nachora biuti,na Dakore.
She post some new fotos for Instagram and dem dey cause beta headache for dem boys.
Dia tinking don double.
E don tey wey dis babe fine sha.


Sunday 26 June 2016

BET AWARD WINA FOR Di BEST AFRICA INTANATIONA MIUZISHAN,BLACK COFFEE,OF SOUTH AFRICA SAY,NA WIZKID SOPOSE WIN Di AWARD

Black Coffee
Di BET Award wey appun last nite for Los Angeles,America,nor go di way wey many naija pipo want make e go as Wizkid loose di award to Black Coffee of South Africa.
Black Coffee don con out to yarn say di award for di best intanationa Africa artiste wey dem givam for fit Wizkid pasam bicos of wetin Wizzy don achiv since di biginnin of dis year.
Big names like Drake and R.kelly fichoram for dia jam.
Espeshali di 'one dance' song wey Drake arrange am put wey don brake many record for world inkluding America and Uk.
Oda miuzishans wey Black Coffee difit to win di award apart from Wizkid na,AKA,Cassper Nyovest,Diamond Platinumz,MsVee,Serge Beynaud and Yemi Alade.

SEE VECTOR NEW HAIR CUT WEY MAKE ONE GUY SAY HE NOR DEY RESPONSIBLE


Wetin pesin go do wey dem no go yarn?
U chop akara,dem go yarn,u eat popcorn drink water,dem go talk,u buy periwinkle dem go carry yor tori,u do manicure,dem go yarn full ground.
Naija rappa,Vector,post hin new hair cut for Instagram and one fan say he nor dey responsibo bicos of di hair style.
Vector sef nor kuku allow di guy go like dat as he telam say,dem nor dey write responsibo for face.
I fear naija sha.
For pesin own head again!


Saturday 25 June 2016

EVANGELIST AND BORN AGAIN RAPPA,LYNXXX,DEY SMOKE SHISHA 2 DAYS AGO AFTA HE DON ALREADi TELL US SAY HIN DON REPENT



Nor be by force to repent.
We dey our own jejeje wey rappa and forma Glo ambasador,Lynxxx tell us say hin don repent.
Dat is to say,na God he won sav now.
He even reliz one ogbonge kristian song 'Serve You' to take anouns him new life in Christ.
But wich one kon be dis shisha wey di bobo dey smoke?
He kon even dey blow heavi smoke comot for nose like say na hell fire he for buy di shisha.
Na for DJ Obi groove for Sao Cafè for Lekki,Lagos wia he dey try to brake enta Guiness book of records naim Lynxxx for dey smoke hin nose hot.
How we take dey sure say di bobo nor also drink beer full face for di place?
I stil dey wait for Lynxxx to show us were he dey for bible say kristian fit smoke so dat pipo go take am sirios say he don repent true true.

CHECK OUT Di FINE BABE WEY WIZKID DEY PLAY EXPENSIVE PLAY WIT FOR YANKEE (fotos)


All work witout play naim turn John-bull to olodo.
Na di kain mistake wey wizkid nor won make be dat.
Forma home base but now intanashona miuzishan,Wizkid,enta one joinbodi studio time wit fine 20 years old America-Jamaica singa,Justine Skye.
E be like say dis two pipo go soon reliz one song togeda but wetin katch pipo eye na di gum bodi pishors wey dem take.
Na so Romeo and Juliet own take start.
Na mango Romeo go plock for dem Juliet backyard.
From dia naim love take hookah.
Make we dey watch weda Wizkid go skip di malawi or he go hookam for throat.


Friday 24 June 2016

DEM BOO RAPPA 50 CENT COMOT FOR STAGE FOR ATLANTA BUT Di BOBO REFIUZ TO COMOT


Evriday nor be krismas as dem talk.
50 Cent go dey wish say wetin appun toram some days ago,nor eva appun at all as dem use brain remind am say,2016 nor be 2003 wen he miuzik skata evriwia
Di bobo wey be one of di most susesful rappa for di world,resiv cold tritment for stage from fans afta dem boo am to comot for stage for Hot 107.9 betday selibrashon for Atlanta but di bobo nor gree comot.
As dem stop hin jam so dat oda miuzishan like T.i and Jeezy go get chance pafom,naim 50 Cent para.
He say,Soo,just one minute wey remain foram to comot for stage,naim dem dey disrespetam like dat?
Di guy yoyo say,him nor dey comot for stage bicos of dat.
He curse dem welwell nor be small as he even dey call dem modafoka.
All dia curse kuku dey carry modafoka.
He say make Hot Fm stop to play hin miuzik,say he nor send dem.
He say YouTube dey dia.
But lastlast he still comot for stage.


Thursday 23 June 2016

N11 BILLION DEBT: AMCON DON READY TO SEIZE 'SILVERBIRD GALLERIA' FROM BEN MURRAY BRUCE TODAY


Di Asset Management Corperation of Nigeria (AMCON),don dey readi to take ova three konpinis wey belong to Senator Ben Murray Bruce and hin brodas bicos of N11 billion loan wey dem collect from union Bank.
Dem neva fit pay back and AMCON don readi to take ova di konpinis today inkluding Silverbird galleria for Ahmadu Bello Way,Victoria Island,Lagos.
Last week di Federa High Court,Lagos giv orda for di take ova.
Oda Ben Bruce brodas wey join for dis debt na,Guy Murray Bruce,Michael Murray Bruce and Jonathan Murray Bruce wey be Ben Bruce first son.
Make we dey watch to see how di mata go end today.
O boy,see debt!
Na heavi gobe be dis one.

Wednesday 22 June 2016

REFEREE DON GIVE PLAYER RED CARD FOR SWEDEN JUST BICOS HE MESS FOR FIELD


Wen playa kick playa like say na animal dem dey kick,refri can givam red card.
Wen playa insult refri,he go get red card.
Wen playa slap anoda playa,wen playa use hand dey play ball instead of  leg,all dis na red card ofens.
Wetin I nor kon know be say,wen u mess for field,na red card ofens.
Adam Lindin Ljungkvist wey dey play for pershagen,get red card from di refri for division 9 match.
Di refri,Dany Kako,don first givam yellow card and he givam anoda yellow card WICH is equal to red card bicos di bobo reliz one hot mess.
Akordin to di refri,he say him givam red card bicos Adam Lindin poposeli mess loud and dat kain tin nor gud for hin oponent.
So anytime wey mess dey kash any Super Eagles playa,he beta hol di mess til he rish haus if not,na red card straight.

ASOSIATION OF NIGERIA DJs,DON FORGIVE TERRY G AFTA HE APOLOGIZE FOR Di SLAP WEY HE GIV DJ JIMMY JATT BOY


Dem say wen cobwebs unite,dem fit tie spider.
Afta naija djs unite to fall Terry G karia bikos of di hot slap wen he giv DJ Phriz for Comedian Bash show,di bobo don act fast to save hin karia.
Afta Terry G slap DJ Jimmy Jatt boy,DJ Phriz just bicos he nor givam more beat to kontiniu hin pafomans for stage,di nackam akpako miuzishan apologize to di DJ asosiashon afta dem konklud say dem nor go play hin miuzik again.
Now di asosiashon don look up,look down and konklud say dem don forgivam bicos of God.
Di lesin hia now be say,di same pipo wey giv u polish to take shine yor shoe,fit stil kramp di Polish from yor hand.
So make we len how to respect pipo position so dat dem go respect our position too.

Tuesday 21 June 2016

UDUAGHAN DAUGHTA MARRIAGE DON KRASH LIKE PACK OF CARDS


Baba God I pray to u say make dat tin wey dey skata pipo marage,nor near our area.
Afta 4 years of marage togeda,forma Delta state gofnor,Doctor Emmanuel Uduaghan dota,Orode and her hosband Ryan Okpu,don knock.
Orode don tell court say she nor want again bicos dem nor fit settle dia wahala.
Dis two pipo wey dey stay America,marry for 2011 and dem get two shidren from di marage.
One boy and one geh.
Wit all di money,even rich pipo fit krash too?
Respet God.

Monday 20 June 2016

BIG REGGAE STAR BUJU BANTON,DON GRADUATE FOR INSIDE PRISON FROM NEWYORK UNIVASITI


Reggae miuzik legend and Grammy award winna,Mark Anthony myrie a.k.a Buju Banton,wey dey serve 10 years for prison for America bicos dem vidioram dey taste cocaine,don turn graduate and get masta digree for Miuzik Bizness Management for di Univasiti of New York.
Buju don nearly serve finish as dem go relizam for first week of disemba,2018.
Buju Banton wey be one of di best reggae miuzishan,get dis satifikate for inside prison and na gud tin say nor go dia go be mumu.
Apart from dis one wey him don get,di Jamaica star say him don pass anoda test to study politics and ekonomiks.
Di Grammy award wina,Buju Banton say,enimis canot stopam to bikom wetin he won be.

Sunday 19 June 2016

ONE CHANCE: BREAD PRICE FOR NAIJA GO INKRIZ AKORDIN TO BAKERS ASSOCIATION


Babalawo say make gofment bring goat for sakrifice,gofment say na lie,na human being head dem go  bring.
Weda na di juju wey gofment dey serve dey make us dey sofa for dis kontri,I nor kon know.
Wetin u won kon call dis kain plenti nonsense sofa wey pipo dey sofa for naija?
Price of evritin don inkriz even bifor gofment inkriz fuel price inkluding bread.
Wetin kon make bread sellers won re-inkriz bread again?
Akordin to Chief Simeon Abanulor wey be di chairman,masta bakers and caterers,he say di price of sugar and flour don inkriz so diafor,dey demsef go inkriz bread price.
He yarn tori pipo all dis one for one joinbodi meeting for Umuahia on Friday.
Nor be anybodi fault.
God dey on our case.

Saturday 18 June 2016

YEMI ALADE DON YARN SAY,OMAWUMI TALENT GIVE HER MIND TO BIKOM WHO SHE BE TODAY


Evri miuzishan and selebriti dey always look back and tell u who inspirate dem for di job wey dem chuz and Yemi Alade don yarn tori pipo di pipo wey giv her mind for di industri.
Yemi Alade wey win plenti award on top di miuzik parol last year,say na Omawumi be one miuzishan wey she study welwell wen she dey grow up.
Dat is to say she like Omawumi style bicos di style inspayaram to do big tins like her.
Rili wen you watch Yemi Alade for stage,u go see small Omawumi bihavior for inside am.
Anoda pesin wey Yemi pick as sombodi wey givam inspirate dis time from obodo oyibo,na Beyoncé wey appun to be my first cousin.
Beyoncé na anoda craze for talent espeshali for stage and I nor soprise say Yemi pick her.
We hope say di yong ones go also look up to Yemi Alade tomorow too for inspirashon.

Friday 17 June 2016

PATIENCE OZOKWOR Alias MAMA G,DEY VERY SICK AKORDIN TO TORi WEY WE HEAR


We neva know how true dis tori be yet but di tori wey land for our backyard now be say,Mama G wey her ril name na Patience Ozokwor,dey veri veri sick rite now and dem don admitam for Aisha Speshalist hospita near LUTH for Idi Araba for Lagos.
Akordin to di tori,di sickness strong sotay na her sista naim carry Mama G all di way from east enta Lagos.
We stil dey try to find out weda dis tori na true.
We pray make e nor be true.
If na true,Mama G get well quik and kontiniu to join hands put Nollywood for world map.


Thursday 16 June 2016

JUST LIKE BIAFRA RADIO,BOKO HARAM DON START DIA OWN RADIO STATION


Na wa o.
I be tink say Federa Gofment say dem don dey win di war against Boko Haram?
I nor kon know who we go biliv.
You say you dey win yet di oda side dey skor strong strong goals.
Just like Nnamdi Kanu Biafra radio,Boko Haram sponsors don open dia own radio for dem too.
Na on top 96.8 dem dey yarn from and dem dey operate from Tolkomari for inside Cameroon.
Dis kain mata go don dey giv Federa gofment anoda round of headache.
Make we see how dem go take hando di mata.
So so wahala evriwia.


FORMA FAT STAR,LEPACIOUS BOSE,DON HALA SAY 'FATNESS NA BASTARD!' ON TOP INSTAGRAM



Mehn,woteva dis fine malawi do to take slim down like dis,I hail her.
One of naija top female comedian,Lepacious Bose,don sampo us anoda of her old pishor.
Di first pesin wey dis her new figures dey soprise pass,na Lepacious Bose hersef.
Evritime naim she dey look mirror dey tank Baba Godeh for saving her from di 'Plenti Flesh Club'.
E get one of her old pishor wey she see yestaday wey make her shout say,'Fat na Bastard!'.
Who nor go nor know.
Dem say if your shoe size na 44 and dem sell 46 giv you,make u dash gofment di extra size just like Lepacious Bose wey dash gofment her extra fat.
I swear if dis malawi enta show glass,dem go buy her one time bicos she look take away wit dis her new shape.
Her name rili rili work for her.
Di stori of di Orobo to Lepa go kontiniu for a long time as far as she nor read her old textbooks.

Wednesday 15 June 2016

COMEDIAN BOVI,DON TELL ONE PASTOR WEY WANT FREE SHOW FROMAM SAY,NOR BE Di PASTOR GO CHOOSE Di SHOW WEY HIM GO DO FREE



Bovi,one of di top comedian for Nigeria,don ansa one pastor wey want make he kon crack joke for hin church for free say,e nor go work.
Bovi say to play free show dey hin blood but naim go use hin hand choose wich show he go pafom free for di oganaizas.
Well sha,I nor know weda di pastor for use anoda style take enta Bovi or Bovi nor just like di way wey dem take yarnam di koko.
But me I be witness of one show wey di bobo pafom for free for Oriental hotel and since dat time,I respet am pass many of our stars wey dia eye shook pass anytin wen he don rish money mata.

Tuesday 14 June 2016

GENEVIEVE DEY OWN 18K FOR GOWN WEY SHE BUY AKORDIN TO KINGSLEY FOR LEKKI BUTIK


Nawadays,di quikest way to rish dis supastars wey ova biziness dey tie down na tru Facebook,Twita or Instagram as one bobo don yarn Genevieve say make she pay her debt.
Akordin to Kingsley Ejikeme for Lekki,he say Genie buy gown of N98,000 for dia butik but pay 80k, to balance 18k.
Di bobo say since dat day wey Genevieve drive comot,he neva use hin two eyes siam.
He say he don do evritin to rish di nollywood big name but who sai!
Di bebe don folow briz comot.
Genevieve wia u dey?u beta come clear yor name.
Dem don baff yor name wit mud o.
U must yarn for dis mata wey dey ground so.
If dis tin na true di mata get as e be o.

WATCH HOW GENEVIEVE DEY SHAKE WETIN HER MAMA GIVAM


Wetin Genevieve dey selibrate again!
I know say her birthday na biginnin of May.
Abi na nollywood home vidio?
Somtin dey tell me say na her birthday selibrayshon but na now she post di vidio on top Instagram.
Well,I just like di way wey she dey roll dat tin sha.
Join me watcham for bottom hia..


Monday 13 June 2016

2PAC SLEEP WITH WHITNEY HOUSTON AKORDIN TO WHITNEY FORMA HUSBAND BOBBY BROWN


One of America top miuzishan Bobby Brown don akiuz hin forma wife and 'grade A' miuzishan Whitney Houston of sleeping wit rappa 2pac.
Bobby say 2pac toshlight hin forma wife website wen both of dem dey alive.
Both Whitney and 2pac don die some years ago but her mainest bobo dat year,Bobby Brown say she sleep wit 2pac.

Bobby yarn dis one for one short book wey he dey plan to reliz soon.
None of dis two pipo dey alive to deny or difend demsef.
Apart from dis sleeping wit 2pac akiuzment,Bobby Brown also say nor be only man Whitney dey sleep wit she dey sleep wit woman too.
Di only pikin wey Bobby and Whitney get togeda,Bobbi Kristina,die last year.
I go stil bring una any tori wey konsign di mata wen e drop.

CHINEKE! SEE PISHOR OF WIZKID AS HE USE DOLLAR DEY KLIN YANSH FOR TOILET


O boy dis wan pass me o!
Notin go make dis Wizkid pishor nor brake di intanet today.
Na di front page of Fab magazine naim carry dis pishor.
Di pishor of wen he dey poopoo for toilet,kon readi to use pound sterling tissue to klin yansh.
Dis one bow me o.
Na style be dis or just promo?
Well,u go blame am.
Na evritin wey dey available u take dey draw atention wey u turn selebriti.
Na wetin u chop u go shit.

2PAC SLEEP WITH WHITNEY HOUSTON AKORDIN TO WHITNEY FORMA HUSBAND BOBBY BROWN


One of America top miuzishan Bobby Brown don akiuz hin forma wife and 'grade A' miuzishan Whitney Houston of sleeping wit rappa 2pac.
Bobby say 2pac toshlight hin forma wife website wen both of dem dey alive.
Both Whitney and 2pac don die some years ago but her mainest bobo dat year,Bobby Brown say she sleep wit 2pac.
Bobby yarn dis one for one short book wey he dey plan to reliz soon.
None of dis two pipo dey alive to deny or difend demsef.
Apart from dis sleeping wit 2pac akiuzment,Bobby Brown also say nor be only man Whitney dey sleep wit she dey sleep wit woman too.
Di only pikin wey Bobby and Whitney get togeda,Bobbi Kristina,die last year.
I go stil bring una any tori wey konsign di mata wen e drop.

Sunday 12 June 2016

ACTOR AND MIUZISHAN BABA DEE,DON BLAST DAVIDO SAY,LIKE SAY HE GET BETA YORUBA TRAINING ,HE NOR GO INSULT DELE MOMODU


Sound Sultan sinior broda,Baba Dee,don arrange some knockout punch giv Davido sake of say he disrespect jonalist and politishan Dele Momodu.
He even yab Uncle Dele for inside di Bad,Badoo,Baddest song wey Falz for fichoram.
Dele Momodu bin get kwanta wit Davido on top say hin korzin,Sophie,born for Davido but two of dem na cat and rat.
Just yestaday,Baba Dee don come out to yarn say Davido nor try for di mata wey dey ground so.
He say for naija,we dey selibrate pipo wey dia way nor pure too mosh.
Baba Dee say Yoruba boy wey dem giv beta training,dey get respet for hin eldas if not,smallie like Davido nor go open hin mouth dey insult big name like Dele Momodu.
Di guy don yarn hin own.
We dey wait to know weda Davido go pick any sense for dis Baba Dee mesage.

RASTA FLAVOUR CARRY HIN TWO DAUGHTAS FROM TWO DIFEREN BABY MAMAS


Selebriti baby dadi,Flavour Nabania,don show us say him dey on top of di game as he carry hin two daughtas from two biuti queen.
Sandra Okagbue and Anna Banner na di two malawi wey born for di highlife singa.
Dem nor dey buy wisdom for market.
Di way wey Flavour take dey manage di situation go soprise many pipo.
I hope say e go kontiniu like dat.
I nor won hia say one of dem brake bottle dey porshoe di oda one say,one tin do one tin,one tin.

Saturday 11 June 2016

CHECK OUT DIS HIGH HEEL MOTORCYCLE SHOE


Abeg make una hep me ask di pesin wey do dis high heel motorcycle shoe.
Him name na Danladi Ibrahim from Kaduna state.
I nor fit shout for dis one wey dey ground so.
Di gud tin about dis one be say nor be made in China.
Di bobo bin try to use hin talent do sontin but I stil like to know wetin dis bike dey carry.

Friday 10 June 2016

BREAKING NEWS! FORMA SUPER EAGLES COACH,SHUAIBU AMODU DON DIE DIS MORNING



Wetin dey appun Baba God?
Three days afta forma Super Eagles coach Stephen Keshi die,anoda forma Super Eagles coach and Keshi forma oga,Amodu Shuaibu,don die early morning.
He just turn 58 years for April.
Akordin to tori wey enta our news room,dem say Amodu konplain of chest pain Friday nite and he later die for hin sleep dis morning.
Amodu Shuaibu naim be di first naija born coach to kwolifai us for World Cup but bad belle pipo for NFA nor allowram near di World Cup wey take place for Japan and Korea for 2012 as dem replace sam wit Bora Milutinovic.
Amodu naim be di prezent NFF teknika direktor bifor he kick di bucket dis morning.
Make he gentle soul rest in peace.

91.1% OF TIN TOMATOES WEY WE DEY USE COOK FOR NAIJA NA FAKE AKORDIN TO TOMATO PASTE MANUFACTURERS


I nor soprise for dis tori bicos di rate wey diferen tin tomato kon take full market,u go know say bad pipo don put hand for inside.
Now,tomato paste manufachoras don yarn di House of Representatives joinbodi komitis for healthcare savisis and drugs say 91.1 pasent of tin tomatoes na fake for dis kontri.
Some of di tomato konpini wey atend di joinbodi meeting na,Dangote farms,Erisco food limited and Savanna farms.
I kon dey tink anoda tin again o.
Make e nor be say bicos tomatos don kost,now dem won use brain do am make we for stop to use di last hope wey be tin tomatoes.
Why dem nor yarn dis fake tin tomato tori since wey evritin dey norma?
Anyway,make I nor use da' one take worry mysef.
E beta say I don pass di tori to una akordin to how di manufachoras asosiation yarnam.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...