MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 31 October 2017

FEDERA HIGH COURT FOR CALABAR DON GIVE ORDER TO NIGERIA NAVY MAKE DEM PAY ONE MR ETIM ASUQUO N75 MILLION SAKE OF SAY DEM BEAT CRAZE COMOT FOR HIM BODY


Di Nigerian navy must pay N75 million naira to one Mr Etim Asuquo Akpan afta court find dem guilty of beating,shooting and illegal torture.
Justice Inyang Ekwo of Di Federa High Court Calabar na yarn dis one during di court judgement.
He also direct Nigeria Navy to apologize to Mr Akpan for inside newspaper.

Monday 30 October 2017

TEE BILLZ DON TALK SAY NA DEVIL BIN DEY USE HIM BRAIN FRY AKARA BICOS HIM NO UNDASTAND WHY HE NEARLY LIVE HIM BIUTIFU WIFE,TIWA SAVAGE



Tiwa Savage hosband Tee Billz,don yarn tori pipo say na big mistake he niali make foram to eva tink of living him wife.
He say him no biliv say him bin won live biutifu woman like Tiwa Savage.
If you bin follow up,you go know say kasala bin buss bitwin dem two as Tee Billz niali komit suicide.
Di reason akordin to Tee Billz be say,Tiwa dey allow oda bobos torchlight her website.
But now dem don settle dia wahala and di only tin wey Tee Billz dey see now na Tiwa biuti.

Sunday 29 October 2017

FEDERA POLYTECHNIC OKO FOR ANAMBRA STATE DON BAN Di SCHOOL BOYS MAKE DEM NO CARRY AFRO AND BIA-BIA FOR FACE ENTA EXAM HALL AND MAKE Di GIRLS NO WEAR TROUSERS


Federa Politeknik Oko for Anambra state, don  arrange law on top di students head konsigning dia exam.
Di law now be say dem don ban di boys make dem no train Afro hair or carry bia-bia for face enta  face enta exam hall.
For di girls,dem ban dem make dem no wear trouser enta exam hall.
Akordin to di school oga dem, dem no go allow any student wey break di law write exam.
Many students of di politeknik wey follow tori pipo yarn talk say, e be like say di school oga dem don smoke ganja full dia brain base on say dem dey trit dem like sekondri school shidren.

Saturday 28 October 2017

SINGA AND PORT HARCOURT FIRST SON DUNCAN MIGHTY DON CONFAM SAY, HIM GO SOON LAUNCH HIN OWN CABLE TV STATION


Port Harcourt first son Duncan Mighty  don tell tori pipo on stage during di legend extra stout show for PH say, he go soon launch him own cable TV station.
Akordin to di bobo he say, many talen dey waste for di garden city and him go use di station show di world say talent full Port Harcourt.
Duncan Mighty say he don spend millions for di project alreadi and he blood dey hot to open di TV station veri soon.

Friday 27 October 2017

NAIJA MAN WEY GIVE SOUTH AFRICA MAN WIFE BELLE,DON BUY MERCEDES BENZ G-CLASS WAGON DASHAM MAKE HE FOR NO VEX


Wondas sha neva end.
Wetin we no go here for dis world.
One naija man for South Africa don buy Mercedes Benz dash one man make di man no vex sake of say he give di man wife belle.
Akordin to di naija man he say,he know say him do wrong o but him hapi say di man kolet di motor.
Dis one na pure sell out.
Di man don sell him wife,chai!

Thursday 26 October 2017

GHANA PRESIDENT NANA AKUFO-ADDO,DON CONFAM SAY DEM DON GIVE LICENSE TO TEAM CAPTAIN ASAMOAH GYAN TO RUN HIM OWN AIRLINE COMPANY 'BABY JET AIRLINES'



Dis mata large finish o.
Di captain of Black stars of Ghana,Asamoah Gyan, don get license from di Ghana govment to operate hin own airline,Baby Jet Airlines.
Ghana president Akodo, naim yarn and confam dis one on top one joinbodi siddon.
Asamoah wey him nickname na Baby Jet,Don play for France, England, China, and he dey Turkey dey play right now since July.
He make beta money afta he enta Arab land go make Arab money wen he go tap leda for yonda.
Asamoah Gyan don alreadi name di konpini wit him guy name 'Baby Jet Airlines'.
Respect,who big don big.

Wednesday 25 October 2017

IN CASE U NOR KNOW, FELA MAMA FUNMILAYO KUTI, NAiM BE Di FIRST WOMAN TO DRIVE CAR FOR NAIJA AND TODAY SOPOSE BE HER 117 YEARS BIRTHDAY



Funmlayo Ransome Kuti, Di woman wey born Fela, sopose selibrate her 117 years birthday today.
Bifor she die, she be tisha, politika campaigna,fighta against bad gofment and many odas.
And just in case you bin nor know, na she also be di first woman wey drive motor for Nigeria.
Dis famili dey rich in history no be small.
We for Ogakpatakpata say Twuale mama, kontiniu to rest in peace.

Tuesday 24 October 2017

PATO RANKING BIN TELL US SAY,HiM HAWK RAT POISON BUT NOW SINGA 'SOLIDSTAR' DON TELL US SAY, HIM ALSO SELL KPOF-KPOF AND PURE WATER FOR STREET


Evribodi inkluding miuzishans get tori of how dem take suffer bifor dem hama.
Some time ago, Pato Ranking tell us say,na rat poison him bin dey sell from place to place make small tin for dey him pocket.
Now Solidstar wey joinbodi wit Pato and Tiwa Savage sing dat song 'Wait' don yarn tori pipo hin own stori.
He say him hawk kpof-kpof and pure water to sorvive.
No be small tin.

U DON SEE Di WEDDING CARD WEY DEM WRITE IN PIDGIN ENGLISH?


Guy, if u neva see dis one bifor, today u go siam.
Di pidgin inglish wedding card don show face for Akwa ibom State and di tin make brain no be small.
Dis one show say we no dey craze to dey bring una news wit pidgin as pipo don dey yarn say,e don rish di time wey gofment go make pidgin inglish offisha language for naija afta dem see dis wedding card.

Monday 23 October 2017

JIDE KOSOKO,BIG OGA SIR FOR NIGERIA FILM DON TALK SAY, Di ONLY TING WEY HIM NO DEY TAKE PLAY FOR DiS LIFE, NA SLEEP


Evribdodi wit di one wey dey pain am.
Out of 100 pipo for Lagos, like 93 nor dey sleep pass 4 hours bicos of Lagos wahala.
Traffic dey one side,noise dey one kona,moskito dey do dia own,, how pesin won take sleep beta sleep?
But one pesin Jide Kosoko for nollywood Don yarn say, all dat one no concern am bicos he must sleep him sleep konplit. bicos him know wetin beta sleep dey do for bodi.
Akordin to Kosoko he say, pipo wey dey close toram inkluding film produsas know say, him no dey use sleep play.
He say him dey sleep at list 7 hours evriday and even tho you won givam money for bizness make he for no sleep, him go rejectam.
Sleep akordin to Jide Kosoko dey veri good.

Sunday 22 October 2017

ARM ROBBERS DON ROB BRT PASSENGERS FOR LAGOS


Arm robas don attack and rob passengers for inside BRT for Lagos on Sunday.
Di bus dey go from Sango,Ogun state to Oshodi for Lagos and dem attack di bus around toll gate area for Abeokuta/lagos road.
Di robas rish 30 akordin to pipo wey di ting appun for dia prezent and dem jump enta di bus like say dem be passengers but as dem enta,naim dem start to rob.
One carry gun, some carry cutlass, knives take attack di passengers.
Di conductor wey be woman escape and kon dey shout ole!  thief! thief!
Pipo for area kon come out dey porshoe dem and manage to catch three of di robas.
Dem niali beat one of dem die bifor police men long arrest dem and carry dem go.

ITALY GOVMENT DON GIVE ONE NAIJA GUY FROM EDO STATE PAPERS TO STAY DiA KONTRi AFTA HE FIGHT AND STOP ARM ROBBERS WEY GO THIEF FOR SUPERMARKET




Luck don shine for di life of one Edo boy wey fight and stop arm-robas wey enta supermarket to tiff.
CCTV camera rekord evritin wey appun and afta Italy gofment see di video,na so dem reward di bobo wit papers wey go make am fit stay di kontri witout hiding  again bicos dem later find out say him neva even get beta papers wey fit make am stay.
Tank God say dem no kill am.
Watch di akshon film for bottom hia...


Friday 20 October 2017

BENUE STATE PIKIN 2FACE, DON TELL TORi PIPO SAY, OUT OF ALL HIM SONGS, Di ONE WEY HIM LIKE PASS NA 'DANCE IN THE RAIN'


Africa miuzik Legend Innocent Idibia a. k. a 2face,Don yarn tori pipo The NET say, of all him songs wey him don sing, na 'Dance in the Rain' naim be him nomba one song.
Dance in the Rain dey him 2012 'Away and Beyond' album.
Many pipo for tink say 2face go talk say na Africa Queen base on say na dat song naim blow am but for wia,2baba say no Dance in the Rain.
Abi na bicos say him and Blackface dey quarrel on top Africa Queen naim make am no choose a
Anyway dat na tori for anoda day. fu

Thursday 19 October 2017

ANKARA GODDESS! CHIMAMANDA OR OMOTOLA, WHO Di ANKARA FIT PASS?


As I see dis pishor,my brain soft at once.
Fine babes. 
Stori writa Adichie Ngozi Chimamanda and nollywood big name Omotola, wear di same ankara dress and di ting dey swit eye.
E just be like say boys eyes won tear.
To you who di ankara fit pass? 

"PDP BE LIKE VOMIT, GOD FORBID! I CAN NEVA GO BACK TO PDP"... NA SO FORMA PRESIDO OBASANJO TALK


Forma khaki and sivilian presido Olusegun Obasanjo Don tell tori  pipo say, dia is no way him go take go back to him vomit.
Akordin to baba he say, PDP be like vomit and he can neva join dem again.
He say instead of am to join dem again, e kukuma beta make him dey one kona dey give advice on how naija go take beta.

Wednesday 18 October 2017

97% OF SONGS WEY NAIJA MUSICIANS DEY SING NAWADAYS NO GET ANY MEANING ACCORDING TO OMOTUNDE DAVID a. k. a LOLO 1 OF WAZOBIA FM


Omotunde Adebowale David a. k. a Lolo 1 of Wazobia FM Lagos,don yarn tori pipo say, na nonsense and robish miuzik naija miuzishans dey sing nawadays.
Akordin to Lolo, 97% of dis miuzik no get meaning.
She say wetin be bangdadadang, wetin be di meaning of skibidipapap and even Olamide Wo?
Akordin to Lolo she say all dis yarns na play, we just dey use dem  katch fun.
She say if you wan talk of miuzishans wey dey sing koret miuzik wey make sense,na for in those days.
She menshon pipo like Ebenezer Obey, Sunny Ade and Fela.
Many pipo don shook mouth on top dis mata for twita and dem say, di babe no lie at all.
Oya watch di video for hia...


Tuesday 17 October 2017

GHANA BIG NAME ACTOR MAJID MICHEL DON TALK SAY,HIM NO GO EVER KISS ANY WOMAN FOR FILM AGAIN BICOS AS A CHRISTIAN GOD GO VEX FORAM


One of Ghana biggest name for dia film industri,Majid Michel don yarn tori pipo say,him no go eva kiss any woman or film again bicos e go affect him kristian faith.
Bifor today,dis guy na baddest for di film industri as dem know am as supa lovaman but di bobo repent some years ago as e don turn pastor.

Monday 16 October 2017

BANKY W AND BIG BRODA NAIJA MC 'EBUKA',DON TELL TORi PIPO SAY 'KISS DANIEL' TOO SABi SING AND Di THING DEY BURST DiA BRAIN


Wizkid forma oga and baddest singa Banky W don praise Kiss Daniel as one of di best miuzishan for Naija and even di whole world.
Banky yarn dis one afta Ebuka di Big Broda Naija MC first praise Kiss Daniel on top twitter.
Beta talent no dey hide,e be like goldfish.

Sunday 15 October 2017

TODAY SUPPOSE BE "FELA" 79 YEARS BIRTHDAY BUT NO SHAKEMENT AS NAIJA MUSICIANS AND FANS DON GADA FOR AFRICA SHRINE DEY CELEBRATE AM



Di birthday of Afro beat king a.k.a Ebami Eda,Kalukuta republik Oga and worldwide Legend 'Fela',na today.
If no be di stupid death wey kolobi am take,he sopose selibrate him 79 years Birthday today.
Dem born Fela October 15,1938 for Abeokuta,Ogun state and he die afta he sick on August 2,1997.
No shakement as him sinior son Femi Kuti don lead Fela shidren,Naija supastar miuzishans and fans to selibrate am for di Felabration show for Africa Shrine,Lagos.
Di selibration don start since di biginning of dis week.
Happy birthday from us 'King fela'.

Saturday 14 October 2017

DON JAZZY JUNIOR BRODA,D'PRINCE DON TALK SAY,HIM GET PLANS TO PROMOTE HIM PIKIN MAMA FROM 'BABY MAMA' TO WIFE


Singa D' Prince wey be Don Jazzy junior broda,don tell tori pipo say,him get koret plans to marry di babe wey born him boy pikin foram.
Di baby mama bizness naim dey reign for many selibritis.
Selibritis like Davido,Ice Prince,Wizkid,Olamide and many of dem don give girls belle born but dem neva marry di girls.
But D' Prince don come out talk say,di koko for di mata na to promote him babe from baby mama to wife.
Nice one Prince.

Friday 13 October 2017

NEW MUSIC: MAC RICHMAN - KUWARA Y'KA


Mac Richman na from Delta state.
Di guy sabi play guitar and piano welwell and he also sabi play many oda miuzika instruments.
Naim write,pafom and also join produce twenti songs on top dis project.
Mac Richman na also film and miuzik video darektor.
No be lie say na kristian and gospel miuzik him dey sing.
Pipo wey don listen to him songs dey always talk say,him na badoo for di world of gospel miuzik bicos him songs dey follow Afro beat miuzishans dey drag first position.
Watch out for the full album wey di Mac Richman go reliz bifor di end of di year.
No let anybodi tell you stori.
One Love.

Download now

Thursday 12 October 2017

BIG HISTORY FOR LIBERIA AS FORMA WORLD FOOTBALLER OF Di YEAR,GEORGE OPONG WEAH DON BECOME DiA NEW PRESIDENT AFTA HE WIN Di LIBERIA ELECTION



Wen dem say no let ya dreams die,do evritin to make sure say di dream appun.
Forma world footballer of di year George Opong Weah wey finalli win di Liberia elections afta he fail two times.
Dia first woman president till today,Ellen Johnson Sirleaf,win George Weah wen he first contest but for January 16,2018 di same woman go hand ova to George Weah afta he win di new elections.
Na so so history dey follow dis man waka.
As a footballer wey don play for PSG,Ac Milan,Chelsea,naim be di first and only Africa footballer wey don win di FIFA World Player of the year award for 1995 and now,naim be di first forma footballer wey win election to bikom president of kontri.
History history,history.
Congratulabia George Weah.

Wednesday 11 October 2017

NOLLYWOOD BIG NAME OGA BELLO,DON TALK SAY,WEDA WOMAN NA GRADUATE OR NOT,SHE MUST RESPECT HIM HUSBAND


Oga Bello,baba for nollywood,don yarn tori pipo say if u like tall like okro,if woman like make she be graduate or not,she must stil dey bow down to him hosband.
He yarn dis one for Broadway Tv on top one joinbodi intaviu.
He say oyibo lifestyle naim dey worry many marage wey no dey last up to two years for hia.
Oga Bello say for obodo oyibo,u go see hosband and wife wey dey go restaurant go eat,dem no get time to cook for house.
Sometimes u go even see hosband wey go tell him wife say,make I take you out for lunch,make I arrange aftanoon wack for you.
Oga Bello say,na all dis nonsense some of us dey learn.

Tuesday 10 October 2017

SURPRISE! SURPRISE! SURPRISE AS BURNA BOY TALK SAY HIM HATE PASTORS AND PREACHERS AND Di WAY WEY Di MATA DEY GO,HIM GO BEAT ONE OF DEM ONE DAY


Bois wey no send church plenti and di way di ting be so,e be like say na Burna Boy be di Chairman of dat club as he don yarn say,him hate pastors and preachers like mad.
He say one day dey come wen he go use blow send one of dem to grave veri soon and him dey sure say Baba God go dey hapi.
He yarn dis one on top twita as dis one soprise us.
Wich pastor make dis guy vex?
Abi one pastor see wrong vision foram wey no work?
Take it izzi Burna dia is no morskito in heaven.
Izzi tiger.

Sunday 8 October 2017

POLICE DON ARREST 'ISAAC SUCCESS' Di SUPER EAGLES PLAYER WEY DEY PLAY FOR WATFORD FOOTBALL CLUB AFTA HE FOLLOW SOME 'OLOSHO RUNS GIRLS' FIGHT FOR ENGLAND


E be like say Village Winch dem don get di password of Super Eagles and Watford playa 'Isaac Success' afta he carry four ashawo girls and kon follow dem dey fight bicos dem no do wetin he want.
Oyibo law no dey like all those kain tings.
Bifor you go know wetin dey appun dem don throw you and ya bag back to naija make you go start ya life afresh again.
Isaac wey don play only one match for Super Eagles dey vex say di babes dm be scam afta he give all of dem about N1million but dem no do di bizness well.
He tell dem to givam him money back afta each of dem get alert of £500 wey be ova N200,000 but dem no gree.
Akordin to one of di babes,she say,Isaac Success dey shack bottle of Baileys to high him spirit wen dem reach room.
She say di four of dem naked and play wit Di bobo and afta sometime he kon dey vex say he want him money back.
Trust obodo oyibo,bifor you say siddon look na dog name,police don show and arrest Isaac Success.
We go bring una more tori about dis mata as e take drop.

Saturday 7 October 2017

DOUBLE WAHALA SINGA ORITSEFEMI,DON ADVISE ALL HUSBAND AND WIFE SAY,MONEY FIT CAUSE PROBLEM BUT MAKE DEM NO ALLOW 'KEREWA' BE PROBLEM FOR INSIDE DiA MARRIAGE


Hosband and wife dem,wia Una dey?
Oritsefemi don go mountain go bring one kain ogbonge advice on top marage mata o.
Akordin to Oritsefemi di Double Wahala for dead bodi singa,he say money fit cause ploblem for inside marage o but make husband and wife undastand demsef and make dem no allow Kerewa be ploblem at all.
He say man sopose dress near wife and know wen di tin dey hungri her and wife also need to always dey redi for kerewa anytime wey kongi hold her hosband.
Oritsefemi say di tin dey pain am wen he hia say lack of kerewa dey cause ploblems for some marage.
He say he beta make woman tell her hosband say, 'honey,u need to work welwell and make more money' instead make bedroom work cause quarel.

Friday 6 October 2017

POPULAR RADIO GUY ' DADDY FREEZE' OF COOL FM LAGOS DON TALK SAY,BABA GOD BLESSINGS NA FREE AND E NO DEY CONNECTED TO TITHE AND OFFERING FOR CHURCH


Dem go tell you for church say,if you nor pay tithe and offering for church,God fit no bless you.
Now radio pastor Daddy Freeze of Cool Fm,Lagos don talk say,no let any pastor disiv you about offering and tithe mata.
Akordin to Freeze he say,Baba God blessings no get anytin to do wit offering and tithe bicos Baba Godeh blessings na free he dey givam to pipo.
He say di biggest blessing wey God give us na Jesus Christ wey later die for cross and him no rememba anytime wey Jesus tell him pipo to pay bicos he die for cross.
He say make we also rememba di woman wit blood issue and ploblem and how di woman take spend all her money on top babalawos yet Jesus Christ still heal her sickness for free.
Daddy Freeze say,if tichas fit dey agree sometimes say dem teach us nonsense,why pastors no fit just gree say dem dey wrong?
Nor be me talk am o!
Na Daddy Freeze.

Thursday 5 October 2017

ONE NEW WICKED SICKNESS "MONKEYPOX" DON BREAK OUT FOR BAYELSA STATE


Nor be small ting o.
Afta one sickness anoda one go come out.
Ebola carry e wahala come,dat one go,now monkey pox don burs out come out for Bayelsa state as doctor and 10 oda pipo don get di disease.
God Abeg save ya shidren as we nor get pawa to save oursef.

Wednesday 4 October 2017

SINCE I WIN BIG BROTHER NAIJA,Di BIGGEST TING WEY I DON BUY WIT Di MONEY NA SHOES AND IF I WAN BUY I NOR DEY BUY ONLY ONE BUT PLENTi...NA SO "EFE EJEBA" TALK


Efe Ejeba di Big Broda Naija N25 million naira winna early dis year,don yarn tori pipo say di most xpensiv ting wey him don buy from di 25 milla wey Big Broda givam,na shoes.
He say afta di show,he dey kontat him frend steady for WhatsApp to bring shoes foram.
Akordin to di bobo if he won buy,him dey spend money buy plenti.
Efe also yarn say him get shoes pass clothes and he yarn all dis ones wen he do one small joinbodi intaviu wit Moet Abebe for Soundcity televishon.
Efe try use di money arrange one koret bizness bicos we no wan hia storis dat touch later.
Watch Efe video wit Moet Abebe for bottom hia...


Tuesday 3 October 2017

BASE ON SAY HE DEY ALWAYS PRAISE GHANA AND YAB NAIJA,NIGERIANS DON FIRE YABiS AND INSULT ON TOP Di HEAD OF SINGER 'MR EAZI' AFTA HE WISH NIGERIA HAPPY INDEPENDENCE



Naija na kontri wey be say, annoyance don full evribodi skin so if you won yarn,u need to check wetin u won yarn if e make sense bifor u open ya mouth.
If u dey follow up,u go don read Di many nonsense wey Mr Eazi dey yarn about Naija say Ghana miuzik swit pass Naija own just bicos of say he dey stay Ghana.
He even yarn say naim style Naija miuzishans dey use take sing nawadays.
Pipo like Pato Ranking and espeshali Eedris don blastam to shut up him mouth.
Afta he wish Nigeria happy independence on top twita,nor be small insult Naija pipo givam since he dey always yab Naija and praise Ghana.
Make we dey watch weda di boy go change.

Monday 2 October 2017

VERY SOON,ANY SCHOOL WEY NO DEY TEACH SHIDREN YORUBA LANGUAGE GO SUFFER AS LAGOS STATE GOVMENT DON DEY ARRANGE PLANS TO CLOSE DAT SCHOOL DOWN OR Di SCHOOL GO PAY FINE OF N500,000


In case u neva hear and you be school owna for Lagos, Lagos state House of assembly don dey arrange law wey go affect una if una no dey tish Di students Yoruba language.
Akordin to Di lawmaker wey carry dis Mata for head for di house of assembly,he say dem go close Di school down or dem go pay fine of 500k if dem no make tishing of Yoruba language for di state.
Akordin to di tori wey we gada,if Gofnor Akinwunmi Ambode sign Di law,naim be say wahala don start for anybodi wey no hear word.

Sunday 1 October 2017

FORMA ABIA STATE GOVNOR,ORJI UZOR KALU,DON TELL TORi PIPO SAY,BIAFRA OGA NNAMDI KANU DON RUN GO LONDON,SO MAKE NOBODY TALK SAY NIGERIA ARMY DON KIDNAP AM


Ipob Biafra followas don dey tell Naija gofment say make dem bring Nnamdi Kanu come out from wia dem hide am bicos na since wen dem go attack am for him papa house naim dem neva Siam.
Some even dey yarn say Nigeria soljas don killam but oga for naija army don talk say,dem no dey wit Kanu.
Right now,forma Abia gofnor Orji Uzor Kalu don talk say na lie,Kanu no dey wit Nigeria army as he don run go hide for London.
He say na Malaysia Kanu first reach and from Malaysia,he waka enta London.
Akordin to Uzor Kalu he say he call Nnamdi Kanu broda and dem telam say,Kanu dey London.
No Biafra pesin don confam wetin Kalu yarn as at wen we enta our Tori room.
We go bring una more Tori anytime e come out as e take konsign dis Mata.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...