MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 30 November 2018

FOOTBALL FANS FOR CAMEROON DON ATTACK Di FAMiLi HOUSE OF DiA STARGIRL 'ENGANAMOUIT' JUST BICOS SHE MISS PENARiTi AGAINST NIGERIA FALCONS FOR Di WOMEN TORNAMENT FOR GHANA




Cameroon fans don take Africa football  backward afta dem go attack di famili house of dia female soccer star 'Gaelle Enganamouit' afta she miss penariti for dia semi final match for di women cup of nations against di Super Falcons of naija.
Akordin to di tori wey dey reach us,dem even dey throw stone to skata di house and dem live message give di famili say fem go come back come gidem wahala.
Too bad!

Thursday 29 November 2018

POVERTY DIE!...NA Di TITLE OF OLAMIDE NEW SONG WEY HE JUST RELEASE YESTADAY...POVERTY NA BAD THING TRUE TRUE


Olamide don release him new jam and he call am,'poverty die'.
Afta Olamide reliz some stubborn songs like 'WO and Science Student' for di past two years.
Make we dey watch weda Poverty Die go shine like di oda ones espeshali as poverty won bury pipo for dis kontri.

Wednesday 28 November 2018

17 YEARS OLD AND YOUNG GHANA ACTRESS 'MAAME YAA' DON TALK SAY,NOTHING FOR DIS WORLD GO MAKE HER FOLLOW BOY WEY NO GO FIT BUY HER CAR



Maame Yaa,di young Ghana actress don yarn tori pipo say,notin go eva make her friend boy wey no fit buy her car.
Di 17 years old babe say,she get problem wey she go like take care of like to get car and poor man no go fit buy am.
She say,evri woman deserve man wey go provide food foram, takia of am.
All dis tins na problem for poorman bicos to eat sef na problem foram.
so how he won take takia of her?

Tuesday 27 November 2018

PRESIDENT BUHARI DON INCREASE POLICE SALARY AND ALSO INCREASE DIA ALLOWANCE AND PENSION MONEY


President Muhammadu Buhari don promise to inkriz police pipo salary.
No be only dat one as dem go also inkriz dia pension and allawans money.
Uncle Buhari yarn dis one during di joinbodi meeting wey him get wit di Police Service Commission afta dem visitam for Abuja.

Monday 26 November 2018

CHIDINMA AARON OF ENUGU DON BECOME THE 2018 MOST BEAUTIFUL GIRL FOR NIGERIA AFTA SHE WIN THE AWARD FOR EKO HOTEL LAGOS YESTADAY



Chidinma Aaron don get new car,3 million plus house wey dem don pay for afta she win di  2018 most biutifu girl award for naija.
Dem do di award for Eko hotel for Lagos yestaday.
Na  Enugu she teprezent take win di award.
Some of di judges for di award Nollywood stars Mofe Damijo and Rita Dominic,Beat FM Olisa Adibua and di MCs of di day na,Ebuka and Kayla Oniwo.

Sunday 25 November 2018

FOR ASABA DELTA STATE,POLICE DON ARREST THE 14 YEARS OLD GIRL WEY STAB HER PAPA DIE FOR INSIDE SLEEP


For Cable Area for Asaba Delta state,police don arrest di 14 years old girl wey kill her papa for inside sleep.
Akordin to di tori wey we gada,her papa disiplin her for one offenand di tin kon vex her.
Wen evribodi don sleep,naim she get up stab her papa wit knife to pay back.
You dey life na you kill your papa,dat record no swit for ear at all.

Saturday 24 November 2018

DEM DON ARREST TWO STUDENT OF GOVERNMENT SECONDARY SCHOOL FOR LAFIA,NASARAWA STATE WIT GUNS


Yusuf Ibrahim and Tasiu Yusuf don enta police net afta dem catch dem wit gun.
Na di school discipline komiti katch dem and dem hand dem ova to di Nigeria Security and Civil Defense Corps.
Dem be students of Gofment Sekondri School for Lafia for Nasarawa state.
Meanwhy,di owners of di locker Abubakar Haruna and Abduo- Ruof Nora don run lost since dem dey find dem bicos na dem be di owns of di locker and drawer wia dem see di guns.

Thursday 22 November 2018

BURNA BOY AND SUPER EAGLES PLAYER LEON BALOGUN,DON DEY BEG NAIJA PIPO MAKE DEM NO BUY Di BLEACHING CREAM WEY AMERICA SELiBRiTi 'BLAC CHYNA' DEY CARRY COME LAGOS COME SELL


Super Eagles difenda Leon Balogun and singa Burna Boy don advise America model 'Blac Chyna' make she no carry her useless bleaching cream come Nigeria come sell.
Di bleaching na to take bleach your yansh and oda part of your bodi and we even hear say na 91k dem dey sell di Cream.
Burna and Leon say Black is Beautiful so diafor,you no need any kemika to take destroy your skin.
Many naija pipo don dey tell her and different top world tori pipo like BBC don carry di news.

Wednesday 21 November 2018

OBAMA DEY AMONG PIPO WEY PUSH ME COMOT FOR ASO ROCK..NA WETIN FORMA PRESIDO 'GOODLUCK JONATHAN' TALK BE DAT FOR INSIDE Di NEW BOOK 'MY TRANSITION HOUR' WEY HIM WRITE


Di 2015 election wey Buhari win don come and go but di man wey Buhari win for di election Goodluck Ebele Jonathan still dey vex for pipo wey make sure say him loose di election.
For inside di new book wey he write and launch for Abuja yestaday,Uncle Jona say,wetin Forma America presido Barrack Obama do am still dey pain.
He say Obama yarn am to him face for inside video make naija pipo choose new chapta for dia life thru di election.
Goodluck say,na only blind man no go undastand wetin he mean wit dat word.
He say e mean say make dem vote for new pesin.
As if dat one no  reach,he also send him seketri John Kerry come naija bifor di election make Goodluck no try robish as he dey plan to postpone di election.
And true true na so fear match Jona kuku leave di election timetable di way wey he take relizam bifor.

Tuesday 20 November 2018

ONE OF THE SWEETEST VOICE FOR RADIO FOR LAGOS 'TOSYN BUCKNOR' DON DIE AT THE AGE OF 37


Tosyn Bucknor,one of di veri sweet voice for radio for Lagos don kick di bucket last nite.
Her French husband of three years Aurélien Boyer, come back for work kon see say him wife don die.
Di ting send shock waves enta naija and her fans,friends, fellow workas,selibritis don dey send message of dia sadness and regret since di tori break.
Until her death,she make her name for Top radio Lagos as dia morning show prezenta.
She start her radio karia for Eko FM and do her IT wit Cool FM.
She bin dey work wit Inspiration FM Lagos presentli bifor di wicked hands of death draw her take.
Rest in Peace Area Mama.

Monday 19 November 2018

OBASANJO DON CARRY ONE JOURNALIST 'AKANDA ORO' GO COURT FOR ONE BILLION NAIRA BICOS HE RUBBISH HIM NAME AFTA HE TALK SAY,NA OBASANJO KILL BOLA IGE


Forma khaki and sivilian presido Olusegun Obasanjo don carry 'Akanda Oro' a.k.a Awikonko go court afta di man talk on top one radio program say na Obj kill Bola Ige,Harry Marshall and many oda pipo.
If you dey follow up,Bola Ige na forma Attorney General for naija.
Awikonko even talk say,make Obj swear wit Ogun juju say him no know anytin about those pipo wey die.
Obasanjo now don yarn say,di guy dey yarn puan and robish and for dat sake,him dey carry am go court to pay one billion naira for di damage wey he give he name.

Sunday 18 November 2018

ACTRESS 'SHIRLEY IGWE' DON TELL TORi PIPO SAY,NA DIABETES SICKNESS KILL HER PAPA,HER MAMA AND ALSO KILL HER AUNTIE


Shirley Igwes,naija nollywood actress,don yarn tori popo say,na diabetes naim kill her papa and her mama.
She also yarn say na dis same diabetes naim also kill her auntie.
She say diabetes kill her mama wen she be 13 years and her papa also die of same sickness for 2014.
As if di sickness enta agriment wit her famili, di antie also die from di same sickness of resent.
Na dis one make her launch her foundation 'daughter's love foundation' to take krate awareness for di sickness.
She say she dey surprise saygofment no take dis sickness sirios and fight am.

Saturday 17 November 2018

BIG BROTHER NAiJA WINNER 'EFE' DON TALK SAY,NA ONLY 75K REMAIN FOR Di N25million WEY HIM WIN FOR 2017


Di N25m prize money wey Efe win for di Big Broda Naija Show don almost finish akordin to di bobo imsef.
He say na 75k remain for di money.
Efe yarn dis one during di intaviu wey Hot FM arrange foram.
Di guy even yarn say na 100j bin remain but him and hin frends groove 25k comot for di money.

Friday 16 November 2018

BULLET FROM ONE POLICEMAN GUN WEY DEY SHOOT ANYHOW, DON KILL POPCORN SELLER FOR PORT HARCOURT


For Port Harcourt, bullet from policeman gun don kill popcorn seller wey dey hustle him own jejeje.
We neva still know di reason why di policeman dey carry shoot anyhow.
E appun yestaday for Emenike junction by St Andrew state school for Diobu,Port Harcourt.
Imagine,na so popcorn seller take die for nothing.
God our life dey your hand o.

Thursday 15 November 2018

DUNCAN MIGHTY DON BUY TOYOTA CAMRY CAR AS GIFT GIVE ONE GRANDMA (WIDOW) AFTA HE WATCH Di VIDEO OF WEN SHE DEY DANCE TO HIM NEW SONG 'MIEKERASO'


Make God kontiniu to bless anybodi wey do good for anoda pesin.
Duncan Mighty bin promise one grandmama and widow one bag of rice,goat,3 wrapper and 20k afta di video of wen she dey dance to him new song 'Miekeraso' come out.
Port Harcourt first son imsef Duncan Mighty later change him mind and kuku buy Toyota Camry give di woman, and e still dey posibo say he still buy the bag of rice and di other promise.
God bless you Duncan.

Wednesday 14 November 2018

NA ABOUT 60 MILLION PEOPLE FOR NAIJA,GET MENTA PROBLEM ACCORDING TO ABDULAZIZ ABDULAHI, Di PAMANENT SECRETARY OF THE MINISTRi OF HEALTH


Di pamanent seketri of di ministri of health for naija Mr Abdulaziz Abdulahi don yarn tori pipo say,almost half of naija population, get menta problem for head.
He say 30% of naija crowd naim dey kolo which is about 60 million from about 200 million pipo.
Abdulaziz yarn dis one during one joinbodi workshop for Abuja.
Why pipo nor go get mental problem wen gofment dey use pipo life play kalokalo?
From di way wey e be now,naim be say evri famili get at list one madman for naija.
Na wa o!

Tuesday 13 November 2018

NOLLYWOOD BAD BOY 'JIM IYKE' DON TELL TORi PIPO SAY,HIM DON KISS OVER 200 GIRLS FOR NAIJA FILM


Ji

m Iyke,if you no know about dat name for nollywood,naim be say you just start to watch naija home vidio yestaday.
Di tori now be say,Jim Ikye yarn tori pipo say him don kiss ova 200 girls for inside nollywood films.
We no fit mention all di names right now but one name wey we dey sure of 100% na,Rita Dominic.
Dem two dat year be like five and six for inside Nollywood movies.

Monday 12 November 2018

AYO BALOGUN a.k.a WIZKID DON YARN TORi PIPO AGAIN SAY,E NO GET PLAN TO MARRY AND LOVE ONLY ONE WOMAN BICOS HIM GET PLENTi GIRLFRIENDS


Ayo Balogun alias Wizkid,don yarn say,one woman no fit reach am bicos he get plenti women wey him love and dem lovam too.
Di bobo don alreadi get three boys from three different women and di way why him friendship wit Tiwa Savage dey go,she fit join di baby mama team of Wizkid.
Wen tori pipo askam weda he get any plan to marry,Star boy say e go hard bicos he get soft heart for many wome.
He also yarn say,any babe wey him dey follow,he dey letam know say him get anoda babe somewhere.

Sunday 11 November 2018

WIZKID PADDY AND FORMA OGA 'BANKY W' DON JOIN POLITICS AND HE DON DECLARE TO RUN FOR Di HOUSE OF REPS POSITION




Olubankole Wellington a.k.a Banky W,don join politiks as he don declare to run for di House of representative seat for Abuja.
He break di news on top him Instagram page and many of him fans and friends like Wizkid don throw dia support behind am.
Banky won reprezent di Eti-Osa constituency for Lagos.
For sometime now,entatainas,miuzishans and actors like Banky W don dey join politiks.
Some give up half way why some succeed.
Actors like Desmond Elliot and Tony 'one week' Muonagor dey reprezent dia constituency for di Lagos and Anambra state of house of assemblies.

Saturday 10 November 2018

GOOD PAPA: COMEDIAN AKPORORO DON BUY CAR DASH HIM FRIEND PAPA BICOS THE MAN GIVAM HOUSE TO STAY SOME YEARS AGO AND ALSO TREAT AM LIKE HIM OWN PIKIN



Comedian and singa 'Akpororo don buy car dash him friend papa sake of say di man take am like him own Pikin wen he stay wit dem.
Him Friend name na Gbenga.
Akpororo buy car dash him papa Mr Oluwole even though d problem wey di man dey try solve dis piriod na money to take buy TV.
But Akpororo surprise di man as di man hapi welwell and pray for Akpororo.
Dis life,if you do good na good go dey follow you.
Dis Akpororo boy ehn,I swear, di boy get klin heart.
Watch di video for bottom hia and see apiness evriwia...


Wednesday 7 November 2018

THE SATiFiKATE WAHALA WEY DEY HANG FOR 'OGA BUHARI' HEAD DON CONTINUE AS CAMBRIDGE UNIVERSITY SAY,NA ONLY BUHARI FIT ASK DEM TO RELEASE HIM CAMBRIDGE CERTIFICATE

WAEC during wen dem present him satificate toram
Afta many Nigerians say President Buhari WAEC result wey WAEC just release na fake,Cambridge univasiti don also chook mouth put.
Buhari bin attend Cambridge school too and now di school authoriti don yarn say,e no posibo for dem to reliz Buhari satifikate unless naim go use him mouth tell dem say, 'oya make una relizam' make shame katch bad pipo.
He go don sobmit him WAEC result bifor he enta dia school.
Now some pipo say,make Cambridge reliz di result make dem check weda di result na di same wit di one wey WAEC reliz.
Yawa dey o.

Tuesday 6 November 2018

GOOD NEWS! THE NEW HIV DRUGS 'GAMMORA' DON KILL 99% OF THE 'AIDS VIRUS' AFTA DEM TESTAM FOR HUMAN BEING BODY


Breakthrough don dey enta small small afta Israel researchers come wit new drugs wey dey kill 99% of the HIV virus afta dem try am for human being bodi.
Di name of di drugs na 'Gammora'.
The only problem now na how dem go take cure di remaining 1% so dat di world go selibrate dis achievement.
If dem no fit cure di 1%,di mata no go too sweet for ear at all.
E go be like pesin wey shit no clean yansh.

Monday 5 November 2018

HISTORY: TIWA SAVAGE DON BECOME THE FIRST WOMAN TO WIN 'THE BEST AFRICAN ACT' FOR THE 'MTV EUROPE MUSIC AWARDS' WEY DEM DO FOR SPAIN LAST NIGHT



Mavin Records and Stew Gang first lady Tiwa Savage,don create history as di first woman for Africa to win di best 'African Act' Award for the MTV Europe Music Awards wey dem do for Bilbao, Spain last night.
She win oda miuzishans like Fally Ipupa,Davido,Distraction Boyz,Nyashinski and Shekinah to pick dis award.
Other pipo wey don win dis award bifor too na 2face,D'Banj,Freshly Ground from South Africa,Davido,Alikiba.
Congratulations Iya JamJam.

Sunday 4 November 2018

COMEDIAN 'I GO DIE' DON TELL NIGERIA GOVERNORS SAY,ANY OF THEM WEY NO FIT PAY WORKERS Di N30,000 SALARY WEY DEM ASK FOR,MAKE HE RESIGN


One comedian wey don show for sometimes now say,any pains wey naija pipo dey pass thru dey affect am too,na 'I Go Dye'.
Afta di Nigeria Labour Congress (NLC) yarn say from now,na N30,000 dem want make federa gofment dey pay naija workas for di minimum wage,state gofnors don come out say,na N22,500 dem fit pay.
Di govnors say dia pawa no reach di 30k wey NLC dey ask for.
Comedian I Go Die don add him voice join di argument as him don advice di govnors say,any of dem wey no fit pay di 30k make he resign.
He say na insult say dem dey drag di 30k minimum wage bicos for di whole world na Nigeria workas suffer pass on to say,dem dey use dem work like Jacki.

Saturday 3 November 2018

EVERYWHERE STEW AS WIZKID DON BUY iMSEF N100 MILLION NAIRA 'LAMBORGHINI URUS' CAR




Evriwia stew,evriwia stew!
True true Wizkid don confam say him na koret stew afta he vex buy imsef N100 million naira Lamborghini Urus.
No be moin moin for pesin to carry dat kain money buy ride.
Large blessings.

Friday 2 November 2018

IF YOU NEVA HEAR,PDP DON DEY BOAST AGAIN SAY,DiA PESiN 'ATIKU' GO REDUCE FUEL PRICE BACK TO N87 FROM N145 IF HE WIN BUHARI FOR THE 2019 ELECTION


Na so dem help Buhari boast bifor 2015 elections say if we vote foram,he go reduce fuel from 87 naira to 40 naira but today,di price dey for N145.
Now dem don start again as PDP tori pesin Mr Kola Ologbondiyan don yarn say,if naija pipo vote for Atiku Abubakar for 2019,he go carry di fuel price back to N87.
In case you neva hear bifor,I just say make I tell you.

Thursday 1 November 2018

GHANA FOOTBALL STAR 'ASAMOAH GYAN' DON FIND OUT SAY,HIM WIFE GET ANODA HUSBAND FOR ITALY



Forma Ghana captain Asamoah Gyan blood don dey boil afta rumors come out say hI'm wife get anoda hosband for Italy.
Akordin to di tori,she don marry anoda even bifor she meet Asamoah Gyan.
Di tori wey we dey hear be day Gyan don say di marriage don over and he also want make dem do DNA blood test to know weda na him really get di three shidren wey she born foram.
Dis one loud.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...