MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 30 August 2014

PASTOR CHRIS OYAKHILOME WIFE SAY SHE DON TIRE FOR DIA MARRIAGE.

PASTOR CHRIS AND ANITA OYAKHILOME
Like play like play,Pastor Anita,di wife of Pastor Chris Oyakhilome,di owner and founda of Christ Embassy,say her mind don comot kpatakpata for dia marriage bicos she say her man dey sleep wit oda women and she also feel say dem dey trit her anyhow and reduce her power concerning di running of di church .
Sotey,she don even say she want divorce for court with Suit No FD14D01650,wey she go court arrange on April 9, 2014 at Divorce Section A, Central Family Court, First Avenue House, High Holborn, London, UK and na Attwaters Jameson Hill Solicitors naim dey handle di mata for her for court.
Dem don already get two gehs shidren,Sharon and Charlyn for di marriage.
Eldas of di church dem try to settle di mata but dem no fit bifor she go court and no be today dis rumor don dey ground b4 di gbege kon finally rich dis level.
Akordin to one eldaly man for di church,he say,Pastor don deny all dis tins wey im wife dey yarn say all na lie.he say na bad belle pipo dey try to scata dia home.
Christ Embassy na one of di biggest church and Pastor Chris Oyakhilome na one of di richest pastors for Naija.
For divorce mata,e be like futbol wey dem dey giv yellow card and red card.
Di court don already giv Pastor Chris "Decree nissi" wey be yellow card and if dem no fit solve di mata dem go kon givam "Decree absolute" wey be red card to complete di divorce case.

Thursday 28 August 2014

FEDERAL GOVERNMENT DON SHARE CONDOMS AND ADVICE EBOLA SURVIVERS MAKE DEM NO TOUCH WOMAN FOR 2MONTHS

EBOLA PATIENT GETTING ATTENTION
Di Federa Ministry of Health warn say smokers fit die young.Dat na one warning wey plenti pipo know about bifor but now,di Federa Ministry of Health don advise say,make any man wey survive Ebola nor sleep wit him wife or gehfrend for 2 months bicos even if your blood don free kpatakpata from Ebola,di virus dey hide for inside sperm.
Dr Bridget Okoeguale, Director, Department of Public Health, naim give di advice during di intaviu wey she do wit di News Agency of Nigeria (NAN) for Abuja on Wednesday.
Okoeguale say na di advice wey dey di book of di join bodi wey dey control Health mata for di world,World Health Organisation (WHO).
She say bifor dem release all di men wey sorvive dis Ebola sickness to go back to dia house for Lagos,dem make sure say dem pack plenti condom give dem incase dem no fit bear di congi.
Dr Bridget Okoeguale also yarn say afta dat 2 months,dem go test dem again to know weda di virus don leave di sperm alone make di sperm for leave im own life jejeje witout intafiarance.

MANCHESTER UNITED SUPPORTER DON WIN BIG MONEY BICOS SHE BET BY MISTAKE AGAINST MAN U


MK DONS DEY CELEBRATE DIA WIN AGAINST MAN U
For life dem say anytin can happen forget say some pipo mistake neva turn to luck.
One Manchester United fan wey her name na Hollie Griffiths don hammer for twitter on top di head of di klub wey she dey suport for one tirinrin mistake wey she make.
She win about 320,000 Tausand Naira wen she bet wit one kalokalo compini for twita wit just 600 Naira.
Di N600 sef na free she get am from di compini base on di way dem take dey give pipo some free money to take mark.
HOLLIE GRIFFITHS
She be won say Man U go win Mk Dons for dia Capital one match,but she kon do mistake type say (Manchester United 0,Mk Dons 4).
Now dat mistake don turn to happiness foram bicos she find out say she win N320,000.

Monday 25 August 2014

CHECK OUT THE DRESS WEY AMBER ROSE WEAR GO 2014 MTV VIDEO AWARDS

Oyibo na oyibo.
skoinskoin dey enta some of dem head welwel but dat ting wey you dey call skoinskoin fit dey normal for dia eye.
check out dis craze woman dress wey Amber Rose wear go 2014 Mtv video awards.
You like dis dress or you hate am?
AMBER ROSE

NOLLYWOOD OGA,CHARLES NOVIA DON BLAST NAIJA STARS FOR COPY COPY

CHARLES NOVIA
 Charles Novia,one big Oga for home vidio mata,don kontiniu to yarn im mind concerning diferent tings wey no supose to dey hapun bifor our korokoro eyes, bifor our pikin dem,bifor you and bifor me.
Di latest one wey im yarn na about di ice block water wey pipo dey turn for dia bodi for all ova di world and dem call am ice bucket challenge.
Di tin be say you go put ice block and water for inside bucket,kon turn am from your head enta your bodi and you go kon challenge anybodi wey you like make dem go baff wit ice block too.
Dis challenge na to take raise money for pipo wey get one kain disease wey dey afect brain and spina cord wey dem dey call Amyotrophic Lateral Sclerosis(ALS).
Many pipo don do dis ice bucket challenge including di richest man for di world Bill gates,Cristiano Ronaldo,Govnor of South Carolina Nikki Haley,George Bush,Lady Gaga,Emmanuel Adebayor and plenti oda stars.
Nollywood bobo,Charles Novia kon pour out im vexing mind on top twita say, Nigeria stars,miuzishans and actors don join dey do dis challenge and e dey pain am welwel for bodi bicos we get our own problem boku for hia.
He say Ebola dey one side dey scata area and dis our so call superstars like Genevieve,Davido,Don Jazzy,Charles Dallas,Iyanya,Fals,Eyo Henry,di twins Psquare and some oda ones,no fit snap photo wit ordinary hand sanitiser so dat our pipo go know say dem fit prevent Ebola wey don dey kpai pipo for hia even tho dem neva dey 100 pacent sure say dem get merisin wey dey cure am.
He say anytin wey oyibo pipo do naim we must do?if Beyonce do dat one,we go do,if Dr dre do dis one,we go do.
He say maybe naija pipo wey dey pour dis ice water for dia bodi bicos of di ALS mata for obodo oyibo,feel say na anoda type of dat moto wey dem dey call SUV.
Charles Novia kon end am wit joke say na im mind him just dey yarn sha,say anybodi wey e pain make e pour ice water for im bodi.

Sunday 24 August 2014

NOLLYWOOD OGA,CHARLES NOVIA DON BLAST NAIJA STARS FOR COPY COPY

MR CHARLES NOVIA
 Charles Novia,one big Oga for home vidio mata,don kontiniu to yarn im mind concerning diferent tings wey no supose to dey hapun bifor our korokoro eyes, bifor our pikin dem,bifor you and bifor me.
Di latest one wey im yarn na about di ice block water wey pipo turn for dia bodi for all ova di world and dem call am ice bucket challenge.
Di tin be say you go put ice block and water for inside bucket,kon turn am from your head enta your bodi and you go kon challenge anybodi wey you like make dem go baff wit ice block too.
Dis challenge na to take raise money for pipo wey get one kain disease wey dey afect brain and spina cord wey dem dey call Amyotrophic Lateral Sclerosis(ALS).
Many pipo don do dis ice bucket challenge including di richest man for di world Bill gates,Cristiano Ronaldo,Govnor of South Carolina Nikki Haley,George Bush,Lady Gaga,Emmanuel Adebayor and plenti oda stars.
Nollywood bobo,Charles Novia vex now on top twita were im for yarn dis one be say, Nigeria stars,miuzishans and actors don join dey do dis challenge and e dey pain am welwel for bodi bicos we get our own problem boku for hia.
He say Ebola dey one side dey scata area and dis our so call superstars like Genevieve,Davido,Don Jazzy,Charles Dallas,Iyanya,Fals,Eyo Henry,di twins Psquare and some oda ones,no fit snap photo wit ordinary hand sanitiser so dat our pipo go know say dem fit prevent Ebola wey don dey kpai pipo for hia even tho dem neva 100 pacent sure say dem get merisin wey dey cure am.
He say anytin wey oyibo pipo do naim we must do?if Beyonce do dat one,we go do,if Dr dre do dis one,we go do.
He say maybe naija pipo wey dey pour dis ice water for dia bodi bicos of di ALS mata for obodo oyibo,feel say na anoda type of dat moto wey dem dey call SUV.
Charles Novia kon end am wit joke say naim mind him just dey yarn sha,say anybodi wey e pain make e pour ice water for im bodi.

Friday 22 August 2014

NURTW SAY MAKE DANFO DRIVERS AND TRANSPORTERS NO CARRY OVER LOAD AGAIN BICOS OF EBOLA.


The National Union of Road Transport Workers (NURTW) on thursday don beg dia membas say make dem stop to carry ova load to avoid di spread of Ebola virus.
Weda na danfo,or drivas wey dey drive from state to state or even private moto,evribodi naim dem dey tell for dis ovaloading of pasengas mata.
Mr Kefas Dogonyaro, the Public Relations Officer of the union,talk dis one for di intaviu with the News Agency of Nigeria (NAN) for Abuja.
You know say wen driva carry ovaload,pipo bodi go dey touch oda pipo bodi and if pesin wey get Ebola dey inside dat motto,u fit get Ebola from am.
Mr Dongoyaro say drivas need to be careful and carry di numba of pasenga wey dem supose to carry depending on di kind of motto wey u dey use.
He even yarn say,even b4 Ebola carry e wahala come,dem don dey warn drivas make dem dey use dia brain do di norma tins.

Akordin to di tori wey we gada,he also yarn say,taxi driva plus im pasengas na five all of dem supose be for inside im moto and for inside hiace bus,evribodi no supose pass 18 pipo wey driva go carry.
He say dem go punish any driva wey no wear im tinking cap for dis mata and oda offense.
Mr Kefas Dogonyaro say di ministri wey dey incharge of transport and health(bodi mata),don hold join bodi meeting and dem go dey inform and tell pipo of how dem fit get dis disease tru ovaloading and oda ways.

JA RULE AND ASHANTI DEY COME WARRI CONCERT FOR OCTOBER 1ST

JA RULE AND ASHANTI
If you be pesin wey know about good miuzik like 10 years ago,naim be say you supose know about Ja Rule and Ashanti and dat dia jam 'Always on time' wey buss plenti pipo brain for di early 20s.
Dem reign dat year welwel no be small and since dat time pipo don see dem as koret miuzishans.
Wetin dey now be say,two of dem dey fly come Naija come pafom and na Warri dem go land for di show.
You know say for some years back Warri no kon be Warri again as b4 bicos of di gbege bitwin di 3 brodas for di ground,di Urhobos,di Ijaws and di Itsekiris.
One of di cities in those days for Naija wia groove use hand touch ground na Waffi as many pipo dey come from diferent pat of di kontri go catch dia groove for dia.
For sometime now,tins no come be as dem be bifor as many companis don relocate from dia bicos of di crisis wey hapun for 1990 someting.even nite life sef kukuma die but now evrytin don pick up again for di oil city,companis don dey come back,di govment don dey try to arange di place and plenti oda jollificashons. 
Di oganizas of dis show wey dem call "WARRI AGAIN" say,di reason why dem dey bring Ja Rule and Ashanti,na to let di world know say Warri don dey hapun again and na for October 1st di show go shele.
No be only Ja Rule and Ashanti go sing dat day as oda suporting miuzishans like Davido, Wizkid,Oritsefemi,Tiwa Savage,Dr Sid, Daddy Showkey,Iyanya, Seyi Shay,Yemi Alade and Flavour Nabania,go play enta Warri go show dem sef.

Tuesday 19 August 2014

JAMAICA BOBO WON COMMIT SUICIDE BICOS ZIP FM NO PLAY HIM SONG

IKON FOR INSIDE THE MAST
 Di Jamaica miuzishan wey nearly comit suicide wey im name na 'Ikon d link',don yarn say di rizin why he climb and threaten to jump down from di mast/tower/antenna of di radio station,Zip Fm for inside Jamaica, na bicos he want make dem hear di voice of many upcoming miuzishans wey dem no dey play dia miuzik for radio.
Akordin to wetin di bobo yarn wen dem intaviu ram,he say im carry im miuzik go di station make ZJ Liquid play am for radio but di gate man no gree make him enta and he no gree colect im cd.
Di bobo kon tire for evritin.He look up,look down,he say im hear Baba God voice say make he climb di Zip Fm antenna make dem for hear im voice and na exatly wetin im do be dat.
No be small tin o,as di bobo climb go up up,he kon dey shout say im go jump down from top of di antenna if dem no play e song.
IKON
Afta sometime,naim dem beg di guy to come down say dem go play im miuzik. Police come there,emagenci response squad come,dem kon finally bringam come down.
Ikon say no be planned work,nobodi send am.He say im do am for di talented upcoming miuzishans wey no get voice to fight dis fight,wey radio station no care to play dia miuzik.
Police arrest Ikon d' Link go dia station and dem kon later release am from jail and dem drop all di charges against am.

To watch di video of IKON on top of di antenna,make u click 'play' for bottom here:


Sunday 17 August 2014

NAIJA ENTERTAINERS SAY DEM DON READY TO CHANGE DI COUNTRY FOR GOOD THROUGH POLITICS





9ICE



If Arnold Schwarzenegger A.K.A Mr Commando,wey be baba for action film mata,fit enta politiks and rule di state of Carlifonia for Amerika for koret two tenior from 2003 to 2011,naim be say anytin can hapun for any entatayna wey won chuck bodi for inside politiks mata.
Wyclef wey be one of di biggest miuzishans for di world,try to be President of Haiti for 2010 but till today di election commiti no talk wetin make dem disqualify am but di tin be say,many Haiti pipo ready to vote foram.
Our tori pipo gada say,even Wyclef imsef yarn say,im sure say,wetin make dem disqualify am na bicos na Amerika him dey stay and Haiti election law talk say,who neva spend di last 5 years for Haiti,no fit kontest di presidential election. 
But anyway,right now,di way wey plenti Naija entatainers,miuzishans and Nollywood actors take dey announce nowadays say dem won enta politics don make pipo dey ask say weda dem mean am or dem dey joke.
Just last week,Julius Agwu,di man wey be say na comedy and to crack joke for pipo dey put food for im table,yarn say, he won kontest to bicom River state governor for 2015 and di bobo say im sirios say dis one no be joke.
No be only Julius Agwu don yarn im mind for dis politics mata,as some Nollywood big names don diclear say dem must enta politics weda lucifa like it or not.
Rememba say,Nollywood star and miuzishan,Tony Muonagor A.K.A Tony One Week,naim be di fest pesin for di entatayment industry wey contest for election and win.
TONY ONE WEEK
On di 26th of April,2011,Tony One Week represent ACN and Idemili North Constituency and win for di House of assembly election for Anambra state and as we dey yarn now now now,na di bobo bi di chief whip of di house.Anoda pesin wey contest dat year na,Mr Alex Eyengho wey contest for the Warri-South West Constituency for di Delta State House of Assembly election unda ACN umbrella but he lost to di PDP opponent.
As we dey talk so,madam for inside nollywood,Kate Henshaw,don yarn di world say she go kontest for di Federal House of  Representatives for Calabar Municipal/Odukpani Federal Constituency under PDP and we go hia di scores by October wey dem go hold di primaries.
Wot of Desmond Elliot nko?anoda nollywood big name,di bobo say he must to enta politiks too to serve di pipo.
Him papa na yoruba and he mama na ibo,so im dey free to kontest either for im papa side or im mama side.
Also last week,di Gongo Aso singa,Abolore Akande A.k.a 9ice,don come out yarn say,im go run for di House of Representatives for Oyo state.
Anoda bobo wey yarn im mind for dis politiks mata na Kennis miuzik star,Joe EL,wey say im go do politiks wen di time come.
We dey wish all dis pipo and evri oda entatayna wey dey dream to serve from dia root,di best of luck.#kpakam!
KATE HENSHAW
DESMOND ELLIOT

Friday 15 August 2014

LACE DON YARN SAY WIZKID,OLAMIDE AND DI REST NO DEY DI SAME CLASS WITAM

LACE

Lace wey e real na, Taiwo Agbohunsa,don yarn say Olamide and Wizkid bam welwel but he imsef bam finish too.
He say,no be say im dey do competishon wit anybodi o, but anytin any oda man can do,he can do it also.Di bobo yarn say,any kain good miuzik wey Olamide,Wizkid and di rest miuzishan dem do,imsef go fit do am too as he no see dem as rival and im enemy but as frends for di industry.
Lace just reliz one new jam 'Turn by Turn' and na Foxtrot records na dem be di compini wey sign am.
Di miuzik wey dem take know Lace na 'Se bi Wo' wey di bobo don sing b4 b4.
Lace also yarn say di miuzishans wey be say,anywia im hear dia miuzik,im fit shake bodi to til day brake na,2face Idibia,Akon and espeshialy di bobo wey black like ChaCoal,Wande Coal.
He say he won sing and be like dem and even sef do well pass dem.

Tuesday 12 August 2014

WAEC SAY PLENTI PIPO FAIL THE MAY/JUNE 2014 EXAM WELL WELL


 Dem say who no prepia to pass exam, dey prepia to fail di exam.
All di student wey write di May/June 2014 West Africa Sinior School Certificate examination WASSCE, almost fail finish akordin to di West Africa Examinashon Council,WAEC.
Akordin to WAEC dem fail Maths and English no be small like pesin wey get brain na empti kpangolo.
Di Head of National Office, WAEC, Mr. Charles Eguridu wey announce di result yestaday for WAEC office for Yaba,talk say,A total of 529,425 pipo, representing 31.28 pacent,naim skor more dan 5 credit.
Eguridu yarn say dem seize di result of 145,795 pipo wey represent 8.61 pacent bicos of expo and giraffing for di exam hall.he say dem dey stil dey investigate di mata and dem go send di report di Nigeria Examinashon Comiti,NEC for Novemba.
Akordin to ram,out of 1,692,435 student wey write di exam,na 791,227 student naim skor 6 credit and above and dat one represent 46.75pacent,and a total of 982,472 pipo wey represent 58.05pacent naim get 5 credit and above.
In his analysis, he said: “A total of 1,705,976 candidates registered for the examination, out of which 1,692,435 candidates, consisting of 929,075 male and 763,360 female candidates sat for  the examination.
Mr Eguridu for di caculation wey dem do say:"out of 1,705,976 pipo wey register to write di exam,na only 1,692,435 finally write di exam out of wish bois na  929,075 and 763,360 tausand na gehs



WAEC SAY PLENTI PIPO FAIL THE MAY/JUNE 2014 EXAM WELL WELL

 Dem say who no prepia to pass exam, dey prepia to fail di exam.
All di student wey write di May/June 2014 West Africa Sinior School Certificate examination WASSCE, almost fail finish akordin to di West Africa Examinashon Council,WAEC.
Akordin to WAEC dem fail Maths and English no be small like pesin wey get brain na empti kpangolo.
Di Head of National Office, WAEC, Mr. Charles Eguridu wey announce di result yestaday for WAEC office for Yaba,talk say,A total of 529,425 pipo, representing 31.28 pacent,naim skor more dan 5 credit.
Eguridu yarn say dem seize di result of 145,795 pipo wey represent 8.61 pacent bicos of expo and giraffing for di exam hall.he say dem dey stil dey investigate di mata and dem go send di report di Nigeria Examinashon Comiti,NEC for Novemba.
Akordin to ram,out of 1,692,435 student wey write di exam,na 791,227 student naim skor 6 credit and above and dat one represent 46.75pacent,and a total of 982,472 pipo wey represent 58.05pacent naim get 5 credit and above.
In his analysis, he said: “A total of 1,705,976 candidates registered for the examination, out of which 1,692,435 candidates, consisting of 929,075 male and 763,360 female candidates sat for  the examination.
Mr Eguridu for di caculation wey dem do say:"out of 1,705,976 pipo wey register to write di exam,na only 1,692,435 finally write di exam out of wish bois na  929,075 and 763,360 tausand na gehs.

PRESIDENT EBELE JONATHAN DON CALL THE LIBERIAN EBOLA MAN PATRICK SAWYER PURE "CRAZEMAN"

PRESIDENT GOODLUCK JONATHAN
 President Ebele Jonathan don yarn say di Liberia man,Patrick Sawyer wey bring Ebola sickness come Nigeria,na pure kolo.
He yarn dis one for di yearly Inter faith join bodi for Abuja.
He say im dey disapointed wit Sawyer behavior and he also tell Naija pipo say make dem coolu tempa say govment go stop di disease.Di President also yarn pipo wey attend di join bodi meeting say by tomorrow,im go work wit di 36 state govanors and dia health comishonas and provide dem wit evritin wey dem go use to take stop dis Ebola virus.
THE LIBERIA MAN PATRICK SAWYER WITH IM PIKIN B4 HE DIE OF EBOLA VIRUS
Oga Presido also yarn say im don follow di Ogakpatakpata,Dr Margeret Chan,wey dey in charge of World Health Organisation, WHO , yarn and she tok say,60 pacent of pipo wey catch Ebola na thru di burial of di dead bodi of who getam.Jonathan say naim make am always dey warn all di pipo wey like burial ceremonies pass anytin say make dem slow down say who don die don die and dem go bury demsef.
Oga Jona even tok say di Liberia man Patrick Sawyer sista na Ebola killam b4 Sawyer kon stat to do anyhow.he say Liberia govment say make he no comot for di kontri but di skoinskoin for im head dey pusham until he escape enta Naija and since dat time,naim di diziz we dey tacko.
Meanwhy,Federa govment don announce say na 10 pipo don get dis Ebola diziz and out of di 10,two don die and di rest dey resiv tritment.



Sunday 10 August 2014

EBOLA MATA AND EVERYTHING WEY YOU GET TO KNOW ABOUT AM

EBOLA MATA
EBOLA PATIENT

Ebola sickness,na virus dey cause am.
E dey make pesin dey sick welwel.Pesin wey get Ebola virus go dey comot blood from almost evri part of him bodi and almost evribodi wey get dis virus dey die.
As we dey talk so,E no get any injection and tritment wey dey cure ram.

HOW EBOLA FIT TAKE CATCH PESIN
1.Bat meat wey dem no cook don and bush meat dey giv human being Ebola.
2.For pesin to fit catch Ebola,e mean say pesin go touch anoda pesin wey dey sick of Ebola welwel or evritin wey resemble water wey dey commot from inside human being bodi like blood,spit,piss,sperm,sweat,milk from breast and any kind water wey dey commot from pesin bodi.
3.Nurse,doctor,family membas,any pesin wey dey take care of di pesin wey get Ebola and anybodi wey dey close to di pesin,fit catch dis deadly sickness veri easy.


Nobodi fit get EBOLA thru breeze or air.

HOW I FIT KNOW PESIN WEY GET EBOLA VIRUS?
Pesin fit carry dis sickness and nobodi go know say he getam for 2 to 21 days.
Bifor di sickness go show welwel for pesin bodi,na bitwin five to eight days.
E no dey catch pesin until di pesin dey sick welwell.

DI SIGNS TO KNOW SAY PESIN DON CATCH EBOLA VIRUS

.Fever
.Headache
.belle go dey run di pesin and e go dey shit waterwater shit
.Di pesin go dey vomit
.Di pesin go dey weak
.im joint and muscle go dey pain am
.Belle pain
.To dey chop no go dey hungry di pesin

Di signs to know weda pesin get Ebola fit play pesin wayo,bicos,e fit come in form of malaria,cold or catarrh.

Protect and take care of yoursef!

Dis Ebola sickness dey die and e no get power for were soap,bleach,sun or someting wey go dryam kakaraka dey.
Washing machine dey kill di virus wey enta cloth from sweat,milk from breast, or any oda ting wey come in form of water from bodi of di pesin wey get Ebola.washing machine dey kill evritin for inside dat cloth.

HOW TO PROTECT YORSEF FROM EBOLA


Make sure say u dey wash yor hands wit soap and water always.
Stop to get long throat for were bush meat and suya dey.
Make u dey use chemical wey dem take dey make somewere clean.use am dey clean your house and environment.
Nor dey dress near pipo wey dey sick.
Make you make sure di tins wey di sick pesin use,you sterilise dem,or you destroy dem or even sef,burn dem and troway dem veri well and make anybodi no use dem.
Make you no touch dead bodi.

Make you report anybodi wey get sign of Ebola.

Saturday 9 August 2014

SALT WATER DRINKING BICOS OF EBOLA FEAR, DON KILL 2 PEOPLE FOR PLATEAU STATE


If united nations,UN,neva dey mark world salt day bifor,naim be say Nigeria don remand dem to declare  August 8th as WORLD SALT DAY.
Dis one na bicos ova 70 million Nigerians take salt water baff and also drink am bicos of di false infomashon wey somebodi spread for facebook,twita and BB say,if u put salt for water baff and if u also put salt for water drink,e dey make di new killa disease EBOLA,see u run.
Dis EBOLA disease don kill ova 1000 pipo for West Africa and 2 of dis pipo come from Nigeria.
No be small tin yestaday as almost evribodi for Naija drink and baff wit salt on di morning of August 8 like say na swear catch dem and many pipo nor know say too much salt dey cause hypertension and e fit giv pesin heart problem.
Di sad news about di salt wey Naija pipo drink dat day be say,2 pipo don die from di salt wey dem drink for Plateau state and ova 30 pipo dey hospita dey take tritment.dat na only for Plateau and we hope say no new death case go hapun for any part of di kontri.
Out of 25 pipo wey our tori pipo follow talk for Lagos,na only 2 pipo talk say dem no shack salt wen evribodi dey shack am like ogogoro.
For Plateau state,one man wey im name na Atang Itse,dey go di same church wit one of di woman wey dis salt merisin kill, but im say him no too know di woman but na Saint Mary Catholic Church she dey attend like am.
Akordin to di tori wey we also gada,di oda man wey dis salt shacking kill,na one taxi driver for Jos.
We no too dey sure right now weda pipo for Aso Rock baff wit dis salt too but Federa Govment don come out dey tell pipo say na big lie say salt dey cure EBOLA virus but instead e go do more damage to yor bodi.
Di Minister of Information, Mr Labaran Maku, naim yarn all dis one so dat pipo go know say na robish infomashon dem hear and he kon warn pipo say make dem dey veri careful wit dia bodi.

Friday 8 August 2014

LAGOS STATE GOVNOR BABA RAJI FASHOLA DON REDUCE LASU SKUL FEES BACK TO 25K.

GOVANOR BABA RAJI FASHOLA FOR DI CONVOCATION
Di Govanor of Lagos state,Babatunde Fashola,don use im church mind carry Lagos state university,LASU,skul fees back to N25,000.
Fashola bin don inkriz di skul fees from 25K to bitwin 193K to 350K since 2011 and dis one kon make di LASU students cause plenti gbege cos of di inkriz.
Rememba say few months ago,lagos govment reduce di skul fees from around 34 pacent and 60 pacent but di student no stop as dem kontiniu to worry govment wit letas and protest say dem must stil reduce am.
Dem don carry protest go State house of assembly and di Govnor office plenti times bifor Fashola kon finally hear dia cry for di LASU 19th convocation ceremony wey di govnor attend yesterday for dia Ojo campus for Lagos.
Imidiatly di govnor announce di skul fees back to 25K,na so di news kon sugar di mind of di student and dia papa and mama as dem kon dey veri happy say Fashola don do di right tin.

Wednesday 6 August 2014

THE FRIENDS OF DI NAVY MAN WEY DEM KILL DON KILL DI SOJA WEY KILL AM



No be small tin as one navy man and one soja don kill demsef bicos of woman for outside one club for Apapa.
Di soja wey im name na Hilary go club wit im geh frend wey wear soja uniform go di club.As dem won enta club,naim di bouncas stop di babe to enta and ask her weda she be soja?
Dis one kon make di soja Hilary dey vex for di bouncas say "weda dem chop winch!who giv dem di right to question him geh frend?"
So one Navy man,Abdulahi,wey come club wit him geh frend too kon say make e settle di mata bitwin di bouncas and di soja,and na dia di mata kon tie wrapa and enta anoda level.
Di navy man say e dey wrong for di soja geh frend to wear uniform sha since she no be soja.
Akordin to pipo wey dey dia wey di mata hapun,di navy man vex slap di soja babe bicos she dey disrespect am and talk to ram anyhow.Dis one kon vex di soja,Hilary welwel enta im blood bicos dem slap im babe.
He kon bring out one sharp knife out and chuck di navy man Abdulahi and di bobo kon die. 
As Abdulahi navy frends kon hear say dia pesin don die,naim dem gada demsef kon beat di soja welwel so tey di sojaman kon die from di sirios beating.
One of di area pesin kon come call di police men dem for Apapa police division so dat di gbege no go spread pass like dat.
As dem come,dem arrest two pipo carry comot there.
Di police officer wey kon talk for di mata,ASP Lelma Kolle,talk say di gbege for di club hapun true true and as somebodi call dem from station naim make dem rush come.
He also talk say dem don transfer di mata go di State Criminal Investigation Department for Yaba and dem don also go put di two dead bodi for mortuary.

Tuesday 5 August 2014

LINDA IKEJI SAY BABA GOD DON BLESS AM EVEN THOUGH SHE NEVA ENTA CHURCH FOR ABOUT A YEAR.

LINDA IKEJI WITH SONI IRABOR
Di truth as dem talk am,dey bita pass bitaleaf.if u call and ask many pipo for phone say,"u go church last sunday?",plenti pipo go say yes even tho dem never go church for a long time bicos dem no won fall dia hand.even me wey dey report dis tori dey lie sometimes say I go church di day wey i no go.May Baba God 4give all of us wey dey lie.
But e get one ogbonge woman wey her name na Linda Ikeji,she be big madam for tori and blog mata.She no shame at all,at all to yarn say she neva enta church for ova a year now.
Di truth dem say,shall set u free and she no shake to tell naija pipo di truth.
Linda Ikeji yarn dis one and plenti oda tins on top of one join bodi intaviu wit one big ogakpatakpata for tori and radio mata,Mr Soni Irabor.
Dis intaviu hapun on top Inspiration Fm,92.3 for im program Soni Irabor Live.
Linda Ikeji also talk say,wen she fest stat blogging,(tori for intanet),she dey do free advert for companys until one of di company kon say No! awoof dey run belle,we want to dey pay u as u dey let pipo dey know about our bizness and na since den evritin take segemenge for Linda life.
Now she don turn to di biggest name for dis blogging bizness.
She also tell Soni irabor say she like Reggae miuzik welwel as she request for PatoRanking song,Alubarika.
FOR ALL DIS TORI AND PLENTI ODA TORI WEY LINDA IKEJI TALK ABOUT FOR DIS INTAVIU,MAKE U PRESS "PLAY" AND LISTEN FOR BOTTOM HERE:

                                                PART ONE

                                              PART TWO

                                               PART THREE

Monday 4 August 2014

LAGOS STATE AND FEDERAL GOVMENT DON VISIT TB JOSHUA AND SYNAGOGUE BICOS OF EBOLA.


If u neva hear about Prophet TB Joshua and im ogbonge church,Synagogue Church of All Nations bifor today,naim be say u neva hear anytin.
Pipo from Liberia,Syberia,Papua New Guinea,South Africa,Australia,Amerika,
Sierra leone,Ghana and all ova di world,dey visit Synagogue like say na dia backyard for miracle and for oda rizins and na dis one naim make Lagos and federal govment visit di church go tell di membas more about di new killa disease wey dey for town,Ebola virus.
Di Lagos State Commissioner for Health, Dr. Jide Idris,naim lead di rest govment pipo go meet TB Joshua sake of say plenti pipo from kontris like Sierra leone,Liberia,Guinea,Congo were dis Ebola don kill pipo welwel,fit won come for prayers and miracle and as a result of dis wahala,govment no want make dem dey come again till forda notice so dat dem no go carry Ebola enta Nigeria.
If u rememba,Ebola sickness naim kill di Liberia man Patrick Sawyer wey come Nigeria for one join bodi meeting last month and na for di First Consultants Hospital for Obalende,for Lagos im die.
TB Joshua wey resiv di govment visitors,kon tell dem say shakement no dey,say im hia wetin dem talk,say,instead of dem to come im church,him go kukuma travel go yonda go meet dem to do di work of God.
TB Joshua also yarn say,im go do evrytin wey govment talk bicos he love Naija welwel and he also talk say,even if dis Ebola virus wahala na rumor sef,e stil dey veri gud say make we all join hand togeda to make Nigeria beta.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...