MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 22 August 2014

JA RULE AND ASHANTI DEY COME WARRI CONCERT FOR OCTOBER 1ST

JA RULE AND ASHANTI
If you be pesin wey know about good miuzik like 10 years ago,naim be say you supose know about Ja Rule and Ashanti and dat dia jam 'Always on time' wey buss plenti pipo brain for di early 20s.
Dem reign dat year welwel no be small and since dat time pipo don see dem as koret miuzishans.
Wetin dey now be say,two of dem dey fly come Naija come pafom and na Warri dem go land for di show.
You know say for some years back Warri no kon be Warri again as b4 bicos of di gbege bitwin di 3 brodas for di ground,di Urhobos,di Ijaws and di Itsekiris.
One of di cities in those days for Naija wia groove use hand touch ground na Waffi as many pipo dey come from diferent pat of di kontri go catch dia groove for dia.
For sometime now,tins no come be as dem be bifor as many companis don relocate from dia bicos of di crisis wey hapun for 1990 someting.even nite life sef kukuma die but now evrytin don pick up again for di oil city,companis don dey come back,di govment don dey try to arange di place and plenti oda jollificashons. 
Di oganizas of dis show wey dem call "WARRI AGAIN" say,di reason why dem dey bring Ja Rule and Ashanti,na to let di world know say Warri don dey hapun again and na for October 1st di show go shele.
No be only Ja Rule and Ashanti go sing dat day as oda suporting miuzishans like Davido, Wizkid,Oritsefemi,Tiwa Savage,Dr Sid, Daddy Showkey,Iyanya, Seyi Shay,Yemi Alade and Flavour Nabania,go play enta Warri go show dem sef.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...