MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 9 August 2014

SALT WATER DRINKING BICOS OF EBOLA FEAR, DON KILL 2 PEOPLE FOR PLATEAU STATE


If united nations,UN,neva dey mark world salt day bifor,naim be say Nigeria don remand dem to declare  August 8th as WORLD SALT DAY.
Dis one na bicos ova 70 million Nigerians take salt water baff and also drink am bicos of di false infomashon wey somebodi spread for facebook,twita and BB say,if u put salt for water baff and if u also put salt for water drink,e dey make di new killa disease EBOLA,see u run.
Dis EBOLA disease don kill ova 1000 pipo for West Africa and 2 of dis pipo come from Nigeria.
No be small tin yestaday as almost evribodi for Naija drink and baff wit salt on di morning of August 8 like say na swear catch dem and many pipo nor know say too much salt dey cause hypertension and e fit giv pesin heart problem.
Di sad news about di salt wey Naija pipo drink dat day be say,2 pipo don die from di salt wey dem drink for Plateau state and ova 30 pipo dey hospita dey take tritment.dat na only for Plateau and we hope say no new death case go hapun for any part of di kontri.
Out of 25 pipo wey our tori pipo follow talk for Lagos,na only 2 pipo talk say dem no shack salt wen evribodi dey shack am like ogogoro.
For Plateau state,one man wey im name na Atang Itse,dey go di same church wit one of di woman wey dis salt merisin kill, but im say him no too know di woman but na Saint Mary Catholic Church she dey attend like am.
Akordin to di tori wey we also gada,di oda man wey dis salt shacking kill,na one taxi driver for Jos.
We no too dey sure right now weda pipo for Aso Rock baff wit dis salt too but Federa Govment don come out dey tell pipo say na big lie say salt dey cure EBOLA virus but instead e go do more damage to yor bodi.
Di Minister of Information, Mr Labaran Maku, naim yarn all dis one so dat pipo go know say na robish infomashon dem hear and he kon warn pipo say make dem dey veri careful wit dia bodi.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...