MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 24 August 2014

NOLLYWOOD OGA,CHARLES NOVIA DON BLAST NAIJA STARS FOR COPY COPY

MR CHARLES NOVIA
 Charles Novia,one big Oga for home vidio mata,don kontiniu to yarn im mind concerning diferent tings wey no supose to dey hapun bifor our korokoro eyes, bifor our pikin dem,bifor you and bifor me.
Di latest one wey im yarn na about di ice block water wey pipo turn for dia bodi for all ova di world and dem call am ice bucket challenge.
Di tin be say you go put ice block and water for inside bucket,kon turn am from your head enta your bodi and you go kon challenge anybodi wey you like make dem go baff wit ice block too.
Dis challenge na to take raise money for pipo wey get one kain disease wey dey afect brain and spina cord wey dem dey call Amyotrophic Lateral Sclerosis(ALS).
Many pipo don do dis ice bucket challenge including di richest man for di world Bill gates,Cristiano Ronaldo,Govnor of South Carolina Nikki Haley,George Bush,Lady Gaga,Emmanuel Adebayor and plenti oda stars.
Nollywood bobo,Charles Novia vex now on top twita were im for yarn dis one be say, Nigeria stars,miuzishans and actors don join dey do dis challenge and e dey pain am welwel for bodi bicos we get our own problem boku for hia.
He say Ebola dey one side dey scata area and dis our so call superstars like Genevieve,Davido,Don Jazzy,Charles Dallas,Iyanya,Fals,Eyo Henry,di twins Psquare and some oda ones,no fit snap photo wit ordinary hand sanitiser so dat our pipo go know say dem fit prevent Ebola wey don dey kpai pipo for hia even tho dem neva 100 pacent sure say dem get merisin wey dey cure am.
He say anytin wey oyibo pipo do naim we must do?if Beyonce do dat one,we go do,if Dr dre do dis one,we go do.
He say maybe naija pipo wey dey pour dis ice water for dia bodi bicos of di ALS mata for obodo oyibo,feel say na anoda type of dat moto wey dem dey call SUV.
Charles Novia kon end am wit joke say naim mind him just dey yarn sha,say anybodi wey e pain make e pour ice water for im bodi.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...