MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday, 22 April 2015

JONATHAN DON GIVE HIMSEF QUIT NOTICE FROM ASO ROCK


Like tenant wey landlord give two weeks quit notice,President Ebele Jonathan don give imsef quit notice so dat Julius Berger go fit carry out renovation work for Aso Rock bifor di new Presido,Muhammadu Buhari and Vice Presido Yemi Osinbajo go take over di yard.
Akordin to one sombodi for Aso Rock,na two weeks dem give Julius Berger startin from next week to complit di work.
Di sombodi, also yarn say,if dem follow di plan,uncle Jona go pack go di glass house wey no far from di place wia im be dey stay so dat Julius Berger go dey do dia work dey go. 
Also,akordin to tori wey dey reach our office,di only miuzik wey dem dey play for Buhari house now na, "Enter di Place" by 2face Idibia as di General don ready to pack 'enta di place' wey dem dey call Aso Rock for di next four years.
President Jonathan don alreadi start to dey pack im load afta INEC anounce Buhari as di wina of di 2015 presido election.
INSIDE ASO ROCK

For di biginin of dis month,pipo see many bus wey carry plenti load dey comot for Aso Rock afta di  election.
More investigashon show say di Federa Govment don complit renovation work for di Defence House wey dey Maitama district for Abuja and na dia, Buhari and Osinbajo go camp put fest bifor dem go swear dem enta govment for May 29.

Thursday, 16 April 2015

SEE SOME TING..RONALDO AND MESSI GO PLAY FOR Di SAME TEAM

Footbol fans for all over di world, una fit drink one cold pure water now to cool una mind bicos una prayer don get answer as Ronaldo and Messi go play for di same team against anoda team bifor di end of di year akordin to di oganizas of di match.
Dis two footballers wey don take skorin of  goals to anoda level,go play for UEFA All Star match wit oda ogbonge stars wey base for Europe.
Akordin to one newspaper for Spain, Mundo Deportivo,two of dem go play for 'Team South' wey go include stars from La Liga, Italian league and French league and dem go play against 'Team North' and e go involve players from England, Russian league and Germany Bundesliga.
Akordin to di tori wey we gada, di compini wey dey market dis match don yarn UEFA evri evri about di match but na di date and were dem go play di match naim dem get to confam. 

Wednesday, 15 April 2015

HALLELUYAH!!! TERRY G DON CUT HIM DADA TROWAY

TERRY G - new hairstyle
Di wind of change don blow reach di house of naija craziest miuzishan and di akpako masta,Terry G, as di bobo don give up hin dada for low cut.
Terry G,di bobo wey dey pafom wit plenti energi anytime he dey on stage,shock evribodi for intanet wen he sample him new look as he don clear di load comot from him head.
Anoda tory wey Terry G yarn us bifor be say,he don stop to smoke igbo but dat one naim i no fit garantee weda pipo biliv.
Seeing as dem talk am is beliving.
You don see hin new hair style but you biliv say, Terry G don stop to smoke trees?

Tuesday, 14 April 2015

SEE WETIN TONI BRAXTON WEAR GO GROOVE WITH HER CHILDREN

Dem realy talk am say if yeye won smell e dey smell finish.
America singa,Toni Braxton attend UNCF evening groove wey dem organise for stars wit her two bois shidren,Denim and Diezel on sunday April 12 for inside Atlanta,Georgia.
Di kain see tru dress witout bra wey she wear naim kon tire pipo as dem dey wonda say as mama weda she supose dress like dat.
Make i no yarn too much.
Check out di pichors for yorsef.
You go happy if yor mama dress like dis?





DAVID TAM WEST SAY BUHARI GO REDUCE FUEL PRICE TO 40 PER LITRE


Forma minista for Petro mata,Tam David West,don tell Naija pipo say, dem fit sleep wit dia two eyes close and expect jolliment bicos him biliv say new presido,Buhari go reduce price of fuel from 87Naira to N40 wen he start work from May 29.
He yarn dis one wen vanguard call am for telefone to talk for some kain mata wey concern us.
He say forget mata for mathias,no shakement bicos hin no wetin Buhari go fit do. 
Tam West wey be petro minista unda Buhari khaki regime for 1984 yarn say, di new presido go bring fresh confidens to di oil industri and he also yarn say baba na strait forward pesin bicos im know am like di back of im leg.
Di forma Oga for petro mata say Muhamedu Buhari go build new refanaries make fuel and kerosine for dey yanfuyanfu for poor pipo to use bicos no beta govment go like to dey see di pipo dey suffa.
David Tam West say no need to look far bicos naija get all wetin dem need to make life beta.
Anoda tin wey im yarn be say e don tey wey Buhari dey tell evribodi say hin nor won hear subsidy mata for him ears.

Thursday, 9 April 2015

CRISTIANO RONALDO DON SCORE 300 GOALS FOR REAL MADRID IN 7 YEARS


If player skor 20 goals for one season for him club bifor,na big achivment but di level wey Ronaldo and Messi don take di skorin of goals mata reach,don pass be careful. 
Dis two football wizard dem dey skor over 50 goals evri season for di past five years.
Just last night for di match wey Rayo Vallecano and Real Madrid play,Ronaldo skor im 300 goal for Madrid out of 288 match wey he don play for di club since he join dem for 2009 from Manchester United.
Di club of forma Super Eagles goalkeeper,Wilfred Agbonivbare wey die of cancer for january,Rayo Vallecano,no get answer to Ronaldo goal for di 68minute as he nod Dani Carvajal cross enta net.
Just on Sunday here,Ronaldo skor five goals for one match as Real Madrid beat Granada 9-1.

Di TING WEY TINUBU TALK ABOUT OBA OF LAGOS AFTER HE YARN SAY IBOS GO PERISH FOR LAGOON


Naija new President,Muhammedu Buhari,don beg Igbo pipo make dem forgive Oba of Lagos,Oba Akiolu Rilwan,afta im misyarn say any Ibo Pesin(Omoibo) wey no vote for APC and Ambode as Govnor for Lagos,go perish for Lagoon.
Buhari yarn dis one on tuesday wen he visit Lagos for APC rally.
He say make dem forgive di Oba make peace for reign. 
Anoda pesin wey yarn for di rally na former Lagos State Govnor and APC national leader,Bola Tinubu.
Tinubu say make pipo forget wetin dem write for motor bodi enta motor, bicos di Oba yarnings nor represent dem bicos him no be APC memba.

Tinubu also yarn say naim be di fest yoruba govnor wey apoint Ibo man as comishona for Lagos.
He say since PDP loose di president election to APC,dem don dey yarn dust just to drag APC name enta wetin di Oba talk so dat e go affect Ambode make he for loose di election.
He say Ifeanyi Ubah and anoda big name for PDP Bode George,no know wetin dem dey talk.
Jagaban,di nickname of Bola Tinubu also talk say,wetin Ifeanyi Ubah go do for Oba Akiolu palace in di fest place?
He say weda di Oba na politician?He say di Oba role na to unite all di parties weda na PDP,APC or even sef SDP.
He also ask Igbo pipo one question say,"Govment no dey pay dia shidren school fees join for di free education"?
Di forma govnor say one spelling competition wey dem do one time na Ibo boy,Ebuka from Anambra state naim win and dem sendam go Switzerland computer shool and also Obafemi Awolowo Univasiti.
No be only dat one Oo, as Ebuka also rule Lagos for one day as Govnor. 
He also talk say dis Ebuka kon later bicom executive for Oando and he dey Canada now.
He say even sef,na Ibos naim win di spelling competition three straight times.
He say anoda boy,Felix also go Switzerland and OAU and dem no deny am him scholarship bicos say him na Ibo boy.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...