Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Saturday, 25 April 2015
NOLLYWOOD ACTRESS,CHIKA IKE SAY,NO MAN DON TOUCH HER WEBSITE FOR 5MONTHS
We no know wia di world dey face nowadays.
Wen naija miuzishan and writa,Etcetera talk am for im miuzik,"going crazy on twiter" say pipo don dey mad for twiter,we no take am sirios.
At di end of di day all wetin di guy yarn 3 years ago naim dey appun true true.
Pipo go wash clothes for house,dry am for twitter,
pipo go eat suya and beans dem go talk am for twitter,dem go buy okrika dress dem go talk am for instagram,dem go buy brassier for market dem go yarn about am for facebook,
Dem go shave dia armpit dem go talk am for instagram,
Abi we don dey mad ni?
Wetin you go call wetin nollywood actress,Chika Ike post for instagram?
She write say,"Bobos,e no easy o...five months na,
no man don touch her or play near her website.
she say she go jump enta bed go grab her pillow"
Na evritin we must talk about?
If u and yor wife do kerewa for bedroom,must u come talk am for facebook?
Wetin sef world pipo!!!!!!!!!!!!!
Friday, 24 April 2015
END OF THE ROAD?CHELSEA WON FORCE SOUTHAMPTON TO BUY MIKEL OBI
Chelsea don dey plan to offload Mikel Obi to Southampton so dat dem go fit buy dia strikar,Morgan Schneiderlin wey Southampton don put Ogbonge price of 25million pounds for him head.
Oyibo pipo say wen pesin caria don dey nosedive,dat is to say,
wen dem no too value u too much again,dem go use u dey play'
dem go use dey play kalokalo.
Di way wey di mata be now,Mikel be like carrot wey dem take dey bribe rabbit so dat dem go catcham and na wetin Chelsea dey try to do so dat dem go catch dia target,Morgan Schneiderlin.
Anoda club wey dey try to kolobi Schneiderlin since last year,na Arsenal.
Anyway,me I go siddon for fence dey watch who go buyam at di end of di day.
OFFICER DON MAKE ONE MAN BUSS CRY FOR KENYA AS GOVERNMENT NO GIVAM POLICE JOB BICOS OF TRIBE
Police recruitas for Kanduyi,Kenya don take back admission letta from one man bicos of him tribe.
Di man,Mr Mathew Rufassi don pass all di recruitment stage and dem kon givam letta to join Police Training College for Kibanjo.
But one Sinior Offisir later telam to return di letta bicos dem find out say,im na Teso pesin and na ten pipo from Luhyas and two pipo from Kikuyus naim di job wey remain dey for. As dem givam di letta,bifor he say make him dance galala to celebrate,naim offisirs call am back,Say,"wia you!,giv us di letta wey we giv you.We just find out say di job no be for Teso pipo".
Rufassi wey kon dey cry bicos of di way wey dem take turn him joy to sadness,say altho,him popsie na from Teso why him momsie na Luhya pesin but he no know any oda home pass Buguma bicos na dia dem for bornam.
Buguma Area Police Commandant,Charles Munyoli,confamam say,true true dem don withdraw di letta bicos dem dey share di jobs akordin to di 1999 population census for Kenya.
Wednesday, 22 April 2015
DIRTY ENJOYMENT: GOVERNOR FAYOSE AND BURUJI KASHAMU DEY BLAST AMALA FOR BUKA
Two PDP big names wey APC dey tire for dia mata,Govnor Ayodele Fayose and Senator Buruji Kashamu,hang out for iya basira buka and dem dey blast beta amala come use moet topam.
Di tin wey surprise me pass na how di table take dey dirty bicos e be like wia pigs for chop.
Dem say cleanliness naim next to Godliness but why di table come dey nyama nyama like dis?
is it dat we no get Govnors and Senators wey neat for naija again?
Dem be leaders?
If yes,were di examples wey pipo go follow?
JONATHAN DON GIVE HIMSEF QUIT NOTICE FROM ASO ROCK
Like tenant wey landlord give two weeks quit notice,President Ebele Jonathan don give imsef quit notice so dat Julius Berger go fit carry out renovation work for Aso Rock bifor di new Presido,Muhammadu Buhari and Vice Presido Yemi Osinbajo go take over di yard.
Akordin to one sombodi for Aso Rock,na two weeks dem give Julius Berger startin from next week to complit di work.
Di sombodi, also yarn say,if dem follow di plan,uncle Jona go pack go di glass house wey no far from di place wia im be dey stay so dat Julius Berger go dey do dia work dey go.
Also,akordin to tori wey dey reach our office,di only miuzik wey dem dey play for Buhari house now na, "Enter di Place" by 2face Idibia as di General don ready to pack 'enta di place' wey dem dey call Aso Rock for di next four years.
President Jonathan don alreadi start to dey pack im load afta INEC anounce Buhari as di wina of di 2015 presido election.
![]() |
| INSIDE ASO ROCK |
For di biginin of dis month,pipo see many bus wey carry plenti load dey comot for Aso Rock afta di election.
More investigashon show say di Federa Govment don complit renovation work for di Defence House wey dey Maitama district for Abuja and na dia, Buhari and Osinbajo go camp put fest bifor dem go swear dem enta govment for May 29.
Thursday, 16 April 2015
SEE SOME TING..RONALDO AND MESSI GO PLAY FOR Di SAME TEAM
Footbol fans for all over di world, una fit drink one cold pure water now to cool una mind bicos una prayer don get answer as Ronaldo and Messi go play for di same team against anoda team bifor di end of di year akordin to di oganizas of di match.
Dis two footballers wey don take skorin of goals to anoda level,go play for UEFA All Star match wit oda ogbonge stars wey base for Europe.
Akordin to one newspaper for Spain, Mundo Deportivo,two of dem go play for 'Team South' wey go include stars from La Liga, Italian league and French league and dem go play against 'Team North' and e go involve players from England, Russian league and Germany Bundesliga.
Akordin to di tori wey we gada, di compini wey dey market dis match don yarn UEFA evri evri about di match but na di date and were dem go play di match naim dem get to confam.
Dis two footballers wey don take skorin of goals to anoda level,go play for UEFA All Star match wit oda ogbonge stars wey base for Europe.
Akordin to one newspaper for Spain, Mundo Deportivo,two of dem go play for 'Team South' wey go include stars from La Liga, Italian league and French league and dem go play against 'Team North' and e go involve players from England, Russian league and Germany Bundesliga.
Akordin to di tori wey we gada, di compini wey dey market dis match don yarn UEFA evri evri about di match but na di date and were dem go play di match naim dem get to confam.
Wednesday, 15 April 2015
HALLELUYAH!!! TERRY G DON CUT HIM DADA TROWAY
![]() |
| TERRY G - new hairstyle |
Terry G,di bobo wey dey pafom wit plenti energi anytime he dey on stage,shock evribodi for intanet wen he sample him new look as he don clear di load comot from him head.
Anoda tory wey Terry G yarn us bifor be say,he don stop to smoke igbo but dat one naim i no fit garantee weda pipo biliv.
Seeing as dem talk am is beliving.
You don see hin new hair style but you biliv say, Terry G don stop to smoke trees?
Subscribe to:
Posts (Atom)






