MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday, 30 April 2015

AYIRI CELEBRATE 40 YEAR OLD BIRTHDAY WITH STYLE


Last saturday for Warri,home boy and billionaire,Ayiri Emami,di Akulagba 1 of Warri,celebrate im birthday wit style as he dash free kerosine and fuel to pipo.
He also commishon him gas station and  hin 911wackis joint.
Pipo wey dey there to nice up di birthday groove na Timaya,Bovi,Solid star,Harrysong plus him wife and shidren.
Check more pichors for bottom hia:


SOME PIPO WEY COLLECT FREE FUEL AND KEROSINE

OBAMA SENIOR BRODA,MALIK,SAY OBAMA BAD PASS PHARAOH


Malik Obama say him junior broda,Barrack Obama bihavior and karata dey get worse evriday by day since he bicom US president.
He say Obama no send weda him family pipo dey exist for Kenya.
Malik say,wen dia auntie,Zaituni,die for America,Barrack Obama no drop shishi to take transport di dead bodi back to Kenya bicos he say di transport too cost.
He say,he take dem one month to gada di money to carry her dead bodi go back to Kenya.
Malik Obama yarn all dis for one intaviu wit Joel Gilbert,di director of di film,"Dreams From My Real Father".

He say Obama mata don tire dem reach neck bicos he wicked pass nebukanezzar.
He say time don reach to find out who Barrack Obama real papa be sef, bicos, naim him step fada,Frank Marshall Davies character he carry.
He say him dey veri veri diasapointed wit Obama and he don notice all Obama yeye bihavior espeshally di way wey he treat him and dia late auntie,Zaituni,from di veri fest time wen dem  won swearram enta as he win election for 2008 to bicom di world most powerful man.
He even yarn say,anytime wen he won visit Obama for White House,na thru back door or nite dem dey allowram enta.
Di last tings wey Malik Obama yarn for di intaviu be say,him no expect to see him step broda,Barrack Obama as di America Presido dey prepia to visit Kenya for July.
Barrack Obama papa na from Kenya why he mama,Stanley Ann Dunham, na America woman.

Wednesday, 29 April 2015

SAMPLE! BUHARI AND OSINBAJO DEY SHACK TEA WITH N35 MILO


O boy una dey see wetin my eyes dey see for dis pishor wey di new Presido Muhammadu Buhari and our Vice Presido Yemi Osinbajo dey so? Check dia table well, u go see milo for inside one plate for kona.
A whole President dey drink tea wit N35 MILO?
Yahoo bois sef no go green make tea for dia dog wit N35 milo.
At least we no go dey hear, 2 billion for a year budget for only rice and beans for Aso Rock again.
Pipo don already dey say, e be like say di forma khaki head of state na di pipos president as e no get time to do like big man.
Even di house wey Baba dey stay be like ordinary pesin house bicos he simple finish.
Dis one wey be say na evri two two weeks fuel dey scars for naija and NEPA dey one corner dey craze dia own,we hope say e go do somtin about am since pipo don already dey say he no like corruption.
Anyway I go siddon dey watch di president and evritin for naija to know weda tins go dey beta afta Buhari don take over from may 29.

Tuesday, 28 April 2015

GRAMMAR KING,PATRICK OBAHIAGBON SAY WAEC SEIZE HIM RESULT TIRE



















Di king of big big grammar wey dey shake pesin brain foundation,Honourable Patrick Obahiagbon,don yarn say West Africa Examination Council,WAEC,take am play tire so tey he kon dey para.
Wen Punch newspaper askam weda him use all dis big big grammar di time wey im dey go skul,di Benin Chief say,yes o.
He say im use dem welwell for secondary skul and even univasiti.
He say infact,WAEC seize him O' level English language result three times but dem dey always dey release di oda subjects.
All dis time,him bin pass JAMB twice but WAEC no allowram enta univasiti bicos of di English wey dem dey seize.
Na di third one wey im do naim WAEC kon release.
Patrick Obahiagbon na di current Chief of Staff to Edo State govnor,Adams Oshiomole.

Saturday, 25 April 2015

NOLLYWOOD ACTRESS,CHIKA IKE SAY,NO MAN DON TOUCH HER WEBSITE FOR 5MONTHS


We no know wia di world dey face nowadays.
Wen naija miuzishan and writa,Etcetera talk am for im miuzik,"going crazy on twiter" say pipo don dey mad for twiter,we no take am sirios.
At di end of di day all wetin di guy yarn 3 years ago naim dey appun true true.
Pipo go wash clothes for house,dry am for twitter,
pipo go eat suya and beans dem go talk am for twitter,dem go buy okrika dress dem go talk am for instagram,dem go buy brassier for market dem go yarn about am for facebook,
Dem go shave dia armpit dem go talk am for instagram,
Abi we don dey mad ni?
Wetin you go call wetin nollywood actress,Chika Ike post for instagram?
She write say,"Bobos,e no easy o...five months na,
no man don touch her or play near her website.
she say she go jump enta bed go grab her pillow"
Na evritin we must talk about?
If u and yor wife do kerewa for bedroom,must u come talk am for facebook?
Wetin sef world pipo!!!!!!!!!!!!!

Friday, 24 April 2015

END OF THE ROAD?CHELSEA WON FORCE SOUTHAMPTON TO BUY MIKEL OBI


Chelsea don dey plan to offload Mikel Obi to Southampton so dat dem go fit buy dia strikar,Morgan Schneiderlin wey Southampton don put Ogbonge price of 25million pounds for him head.
Oyibo pipo say wen pesin caria don dey nosedive,dat is to say,
wen dem no too value u too much again,dem go use u dey play'
dem go use dey play kalokalo.
Di way wey di mata be now,Mikel be like carrot wey dem take dey bribe rabbit so dat dem go catcham and na wetin Chelsea dey try to do so dat dem go catch dia target,Morgan Schneiderlin.
Anoda club wey dey try to kolobi Schneiderlin since last year,na Arsenal.
Anyway,me I go siddon for fence dey watch who go buyam at di end of di day.

OFFICER DON MAKE ONE MAN BUSS CRY FOR KENYA AS GOVERNMENT NO GIVAM POLICE JOB BICOS OF TRIBE


Police recruitas for Kanduyi,Kenya don take back admission letta from one man bicos of him tribe.
Di man,Mr Mathew Rufassi don pass all di recruitment stage and dem kon givam letta to join Police Training College for Kibanjo.
But one Sinior Offisir later telam to return di letta bicos dem find out say,im na Teso pesin and na ten pipo from Luhyas and two pipo from Kikuyus naim di job wey remain dey for. As dem givam di letta,bifor he say make him dance galala to celebrate,naim offisirs call am back,Say,"wia you!,giv us di letta wey we giv you.We just find out say di job no be for Teso pipo".
Rufassi wey kon dey cry bicos of di way wey dem take turn him joy to sadness,say altho,him popsie na from Teso why him momsie na Luhya pesin but he no know any oda home pass Buguma bicos na dia dem for bornam.
Buguma Area Police Commandant,Charles Munyoli,confamam say,true true dem don withdraw di letta bicos dem dey share di jobs akordin to di 1999 population census for Kenya.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...