MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday, 18 November 2018

ACTRESS 'SHIRLEY IGWE' DON TELL TORi PIPO SAY,NA DIABETES SICKNESS KILL HER PAPA,HER MAMA AND ALSO KILL HER AUNTIE


Shirley Igwes,naija nollywood actress,don yarn tori popo say,na diabetes naim kill her papa and her mama.
She also yarn say na dis same diabetes naim also kill her auntie.
She say diabetes kill her mama wen she be 13 years and her papa also die of same sickness for 2014.
As if di sickness enta agriment wit her famili, di antie also die from di same sickness of resent.
Na dis one make her launch her foundation 'daughter's love foundation' to take krate awareness for di sickness.
She say she dey surprise saygofment no take dis sickness sirios and fight am.

Saturday, 17 November 2018

BIG BROTHER NAiJA WINNER 'EFE' DON TALK SAY,NA ONLY 75K REMAIN FOR Di N25million WEY HIM WIN FOR 2017


Di N25m prize money wey Efe win for di Big Broda Naija Show don almost finish akordin to di bobo imsef.
He say na 75k remain for di money.
Efe yarn dis one during di intaviu wey Hot FM arrange foram.
Di guy even yarn say na 100j bin remain but him and hin frends groove 25k comot for di money.

Friday, 16 November 2018

BULLET FROM ONE POLICEMAN GUN WEY DEY SHOOT ANYHOW, DON KILL POPCORN SELLER FOR PORT HARCOURT


For Port Harcourt, bullet from policeman gun don kill popcorn seller wey dey hustle him own jejeje.
We neva still know di reason why di policeman dey carry shoot anyhow.
E appun yestaday for Emenike junction by St Andrew state school for Diobu,Port Harcourt.
Imagine,na so popcorn seller take die for nothing.
God our life dey your hand o.

Thursday, 15 November 2018

DUNCAN MIGHTY DON BUY TOYOTA CAMRY CAR AS GIFT GIVE ONE GRANDMA (WIDOW) AFTA HE WATCH Di VIDEO OF WEN SHE DEY DANCE TO HIM NEW SONG 'MIEKERASO'


Make God kontiniu to bless anybodi wey do good for anoda pesin.
Duncan Mighty bin promise one grandmama and widow one bag of rice,goat,3 wrapper and 20k afta di video of wen she dey dance to him new song 'Miekeraso' come out.
Port Harcourt first son imsef Duncan Mighty later change him mind and kuku buy Toyota Camry give di woman, and e still dey posibo say he still buy the bag of rice and di other promise.
God bless you Duncan.

Wednesday, 14 November 2018

NA ABOUT 60 MILLION PEOPLE FOR NAIJA,GET MENTA PROBLEM ACCORDING TO ABDULAZIZ ABDULAHI, Di PAMANENT SECRETARY OF THE MINISTRi OF HEALTH


Di pamanent seketri of di ministri of health for naija Mr Abdulaziz Abdulahi don yarn tori pipo say,almost half of naija population, get menta problem for head.
He say 30% of naija crowd naim dey kolo which is about 60 million from about 200 million pipo.
Abdulaziz yarn dis one during one joinbodi workshop for Abuja.
Why pipo nor go get mental problem wen gofment dey use pipo life play kalokalo?
From di way wey e be now,naim be say evri famili get at list one madman for naija.
Na wa o!

Tuesday, 13 November 2018

NOLLYWOOD BAD BOY 'JIM IYKE' DON TELL TORi PIPO SAY,HIM DON KISS OVER 200 GIRLS FOR NAIJA FILM


Ji

m Iyke,if you no know about dat name for nollywood,naim be say you just start to watch naija home vidio yestaday.
Di tori now be say,Jim Ikye yarn tori pipo say him don kiss ova 200 girls for inside nollywood films.
We no fit mention all di names right now but one name wey we dey sure of 100% na,Rita Dominic.
Dem two dat year be like five and six for inside Nollywood movies.

Monday, 12 November 2018

AYO BALOGUN a.k.a WIZKID DON YARN TORi PIPO AGAIN SAY,E NO GET PLAN TO MARRY AND LOVE ONLY ONE WOMAN BICOS HIM GET PLENTi GIRLFRIENDS


Ayo Balogun alias Wizkid,don yarn say,one woman no fit reach am bicos he get plenti women wey him love and dem lovam too.
Di bobo don alreadi get three boys from three different women and di way why him friendship wit Tiwa Savage dey go,she fit join di baby mama team of Wizkid.
Wen tori pipo askam weda he get any plan to marry,Star boy say e go hard bicos he get soft heart for many wome.
He also yarn say,any babe wey him dey follow,he dey letam know say him get anoda babe somewhere.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...