MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 4 February 2016

FEDERA GOVMENT DON YARN SAY,HUNGER GO KILL EVRIBODI FOR NAIJA BY 2050 IF WE NOR TAKE FARMING SIRIOS

AUDU OGBEH
Oga for food and farm mata,Chief Audu Ogbeh wey be di Minista of Agrikochor,don yarn say,34years from now,if we nor use our church mind take farming sirios,hunga go take our eye see pepper.
Di minista say 34years from now wey be 2050,naija population go don rish 509million pipo and if we kontiniu like dis,we go hiaram.
He say food like kasava,yam,corn,vegetables,rice,beans,okro,onions,garri,kpofkpof,malu and plenti oda food,get boku bikos of di population wey go ova boku by 2050.
Di forma PDP nationa chaman,Audu Ogbeh, yarn all dis one wen he dey difend di 2016 budget.
He say naija get di pawa to do wondas wit farming bikos evritin dey wit us.
He also yarn say him don write leta to state gofment make dem take dis farming bizness sirios,if not,we go kash winch.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...