MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 11 December 2015

NO LOOK UCHE FACE!!! LOOK DI FACE OF DI MOST UGLY MAN FOR ZIMBABWE WEY USE WORWOR TAKE WIN $500

If dem tell u say somebodi go use worwor take win award u go biliv?
Dis na di tori of Maison Sere,di 42 years old man wey win di most worwor man compitishon for Zimbabwe.
$500 naim follow di award and I dey sure say many fine gehs for yonda go dey die for dis man mata now.
Mr Sere later yarn tori pipo say,him dey veri hapi for di title bicos di last compitishon,na nomba four position he carry.
He also tank all di pipo wey chuzam as di most ugly man for Zimbabwe.
But di compitishon later tie wrappa as di man wey carry second,William Masvinu,accuse di judge dem of ojoro.
William wey don win di compitishon three times bifor,say naim dizav to winam again bicos him worwor pass who carry first.
Dem givam $100 for di second position make he take see front.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...