MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 9 September 2016

COMEDIAN AY SAY,PIPO SAY HIM JOKES NOR FUNNY,MEANWHY ALL HIM SHOWS DEY FULL TROWAY AND YET HIM FIRST FILM DON PUT HIM NAME FOR GUINESS BOOK OF RECORDS


Ayo Makun a.k.a Ay,don blast pipo wey nor dey givam di respet wey him dizav for di comedy industri.
Di Delta state univasiti graduate say,dem say hin jokes dey dry and yet anytime wen he arrange any show,di hall dey full skata.
As if dat one nor dey enof,Ay say him first film wen he arrange,30 days in Atlanta,don enta Guiness book of records as di highest selling movie.
I nor know about una,but anytime I watch Ay show and him jokes,na so so laff I dey laff.
Just like e hard to see fine arm robber,maybe comedians nor sopose to dey too handsome.
Ay why u sef go dey handsome?
Next time rob charcoal for face bifor you climb stage weda dis pipo go see true yarn if na only for day sef.
How pesin won funny pass again?

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...