MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 2 September 2016

OLAMIDE SAY HIM NOR FIT PAY ANY OBODO OYIBO MUSICIAN MONEY TO BREAK ENTA DIA MARKET BICOS,FELA NOR DO AM AND YET HIM MUSIC POPULAR ALL OVA Di WORLD


Just like many naija miuzishans dey do,Olamide say him nor fit pay any obodo oyibo miuzishan money to join am sing so dat hin miuzik go enta Yankee market.
Di Ybnl chairman say him be like Fela,him nor dey pay any yankee miuzishan for collabo.
Badoo say Fela miuzik go intanashona witout he nor pay anybodi for abroad to joinbodi witam sing, so diafor,hin own case nor go differen.
Olamide di young oga say,wit hard work and God grace,him miuzik go use hin leg waka enta di intanashona market.
Akordin to Olamide,"Fela nor do any intanashona collabo bifor dem rekognaiz am for yonda",so diafor,any Yankee bobo wey dey xpect hin money,go eat grass like Nebuchadnezzar first.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...