MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 6 September 2016

NOLLYWOOD ACTRESS FADEKEMI MOMOH DON TALK SAY,NOR BE SIN WEN PESIN WEAR NOSE EARRINGS GO CHURCH


Nollywood actress Fadekemi Mommoh don yarn say,if pesin wear nose earrings go church,nor be sin at all.
She dey reply her fans wey comment on top her pishor wey she post.
Some of her fans bin tell her say,e for beta make she stop to wear earrings for nose.
If not for anytin,dem say make she nor dey wear ram enta church but she kon reply dem say,to wear nose earrings nor be hin be di koko  but our mind,our goodness and our love to our neighbors naim mata.
Fadekemi see nose earrings as somtin wey dey add more fineness to her biuti and she say e don tay wey she dey wear ram,nor be today sontin.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...