MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 7 September 2016

YOUR NOSE BE LIKE 'W'...REEKADO BANKS REPLY Di BOY WEY CURSE HIN ALBUM


Nor be small tin.
Some pipo go just go twita and Instagram dey go insult stars.
One bobo bodi don calm now since Reekado Banks reply am afta he curse di bobo.
He tell Reekado say hin album wey he just reliz dey top five most yeye album dis year.
He say Reekado album dey 'WACK'.
Di Don Jazzy boy nor waste time to reply am as he tell di boy say,"him nose be like di ''W'' wey start 'WACK'.
Who win na?
Next time he go tink bifor he curse.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...