MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 10 September 2016

LIL KESH SAY,ANYTIME WEN HE ASK FOR ALCOHOL FOR INSIDE PLANE,DEM GO DEY ASKAM HIN AGE AND NOW HE DEY ASK HIM FANS WEDA HIM STILL LOOK LIKE PIKIN?



First of all I blame di plane ownas for giving pasanger alcohol for inside plane.
Wot if di pasenga go folow di pilot dey drag for sky say hin won sidon for di pilot sit?
Anyway,Olamide product Lil Kesh don yarn say,anytime wen he tell flight attendants make dem serve am alcohol,na so dem go dey askam how many years him be?
He say dem go say make he show dem een passport make dem check him age.
Now di bobo don dey ask on top twita say,abi him still look like small pikin?
Dis lil Kesh sef!
U call yorsef little and you stil dey ask weda you be pikin.
First of all check di meaning of your name bifor we go ansa dat queshon.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...