MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 8 September 2016

MUSIC STAR,TIMI DAKOLO SAY,THINKING OF HIM SHIDREN SCHOOL FEES, DON DEY MAKE AM GET WHITE HAIR FOR HEAD



To take kia of yorsef alone nor easy not to talk of shidren but for di life wey we dey live,you nor fit run fromam.
Wen shidren won go back to school afta dia holiday,na dat time many papa head to swell up.
Miuzik star,Timi Dakolo,leg don dey shake like who get malaria as he yarn say,school fees time don rish again for him shidren.
For di kakulayshon wey di bobo do for inside dat paper wey u dey see so,e be like say one of di pikin school fees na 300k.
Timi say na half cold coke him take dey digest di tinking wey di school fees kpalava don put am.
Nor worry Timi,God wey giv di shidren don alreadi provide for u to arrange dia mata.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...