MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 15 April 2016

7 YEARS FOR PRISON DEY SMELL FOR WIZKID HEAD AS LINDA IKEJI DON CARRY DIA WAHALA TO POLICE OGA OF LAGOS


Afta court sentens nollywood oga madam, Ibinabo Fibrisima to 5 years for jail,I don dey fear for Wizkid siriosli.
Di gbege wey he get wit Linda Ikeji fit landam for jail for 7 years akordin to lawyers bicos of di thretin wey he thretin to beat di babe.
For naija book of law,na seven years ofence be dat.
Wizkid and tori quin Linda Ikeji,dey kworel for sometime now and di kworel enta gear5 two weeks ago.
Linda bin carry Wizkid sekond baby mama tori for her blog and di bobo nor hapi wit her at all.
Two weeks ago,Linda Ikeji join oda tori pipo carry di quit notice stori wey Wizkid landlord givam.
Di Ojuelegba singa vex welwell for Linda so tey he tell Linda say anywia he katch Linda he go beat her injor.
He also yab Linda say she get smelling website and she be old mama witout hosband.
Tori wey dey rish our backyard now be say Linda don carry di mata rish Lagos state komishona of police table.
If dem nor seto di mata bifor he rish court,na sorry for Wizkid be dat.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...