MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 3 April 2016

IGBESE! WIZKID LANDLORD DON GIVAM QUIT NOTICE FOR LAGOS THREE WEEKS AFTA HE BUY ANODA HOUSE FOR AMERICA ABI NA RENT SEF?



Dis na di same Wizkid wey we hia say he don buy haus for Los Angeles,Carlifonia,for Yankee dis month.
Wen we dey tell pipo say dis miuzishans we know dia lifestyle,pipo dey fil say na lie.
U go hia today say,"Mista A"don buy 200million naira haus for Lekki,tomorow u go hia say "Mista B don buy 500million naira yatch for water.
Out of 100 top miuzishans,maybe na only two get dia own haus and dat haus go dey for places like ikorodu and mowe for Ogun state.
Imagine Wizkid landlord don givam quit notice for hin haus for Ayinde Akinmade strit, Lekki phase one for Lagos and meanwhy tori pipo don dey say na Wizkid buy di haus bifor.
Tank God say I nor join dem talk am.
Wizkid dey kip my frend malice wey telam say instead of paying rent why he nor kukuma buy een own haus?
Na she fest tell me about di fake life wey most of dem dey liv bifor I kon later dey siam wit my korokoro eyes.
Wizkid house for yankee
Di pipo wey giv Wizkid di bunk,go di haus April 1 to giv Wizzy di quit notice leta.
Dem say na April 11 dem giv Wizkid to pack hin load.
I biliv say di reezin why dem dey vex for Wizkid be say,di bobo go buy haus for yankee and meanwhy he dey owe dem for naija.
Tori wey dey rish our backyard now be say,di Ojuelegba singa pipo,don already dey pack een loads small small.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...