MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 18 April 2016

BARBER SHOP: MEET Di BIUTIFU BABE WEY GET MASTA DEGREE FOR BARBING


Who go eva imagine say fine shenkess like Kenechukwu Ezeh go be barber?
Good bodi,good laff,,fine open teeth,fine shape.
Anyhow u won diskraib dis babe,u dey free.
Apart from barbing she go graduate next year 2017 from di depatment of co-operative and rural development from Enugu State Univasiti of Science and Teknologi.
Akordin to di babe,she say na her mama say she and her sista must Len one handwork and na she choose barbing for dem.
She say even tho she dey single,she nor dey find hosband wey go telam to stop di barbing work bicos her mama wey enkorrage dem to dey do di work nor dey mad.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...