MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 10 April 2016

ORITSEFEMI FANS DON BLASTAM TO STOP BLEACHING AFTA DI BOBO POST ONE YELLOW PAWPAW PICTURE FOR INSTAGRAM


Naija pipo nor get joy at all mehn.
Di same pipo wey turn Oritsefemi fans afta he giv us dat ogbonge miuzik 'Double Wahala',na di same fans dey giv di bobo sirios heat for instagram.
Dem say Oritsefemi bodi dey white like potato,dat is to say,he dey bleach.
Afta Oritsefemi post one fresh pishor for instagram,he use di pishor take wish een fans fresh day and beta tins but wetin di fans see for di pishor diferen from wetin he tink.
Dem say make he stop to bleach.
One babe even call Oritsefemi boiled chicken afta she see di yellow pawpaw pishor.
Dont mess wit yor fans bicos dia bad mouth bad pass bomb.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...