MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 5 April 2016

BLAME GAME AGAIN AS OGA BUHARI SAY NA Di 16YEARS WEY PDP RULE PUT US FOR SUFFER


Abeg make I call dis president Oga Buhari today weda di real change go start.
Yes we gree say PDP forma presidents mess di kontri up inkluding di "I nor get shoe wen I small president", Goodluck Jonathan.
But Oga Buhari di konplain don too mosh.
Start yor own work make we see.
Di rizin why u win Goodluck na bicos pipo tire for PDP and di way wey dem rule dis kontri.
So wich one be all dis talku talku?
 Why I dey yarn like dis be say,yestaday again for Abuja,Buhari say na PDP rule of 16 years naim put  us for dis hungry,fuel scarcity and many more kasala wey we dey face.
He say upon say oil sell for ova 100dollars per barrel,we nor get anytin to show foram.
He also yarn say we nor use our church mind take manage di ekonomi.
I agree witam sha bicos almost evri beta tin wey we get na bifor PDP enta pawa.
All di refineries,all di beta bridge dem,all di small time wey pipo like me enjoy for dis kontri,na bifor PDP come.
Buhari we don hia all wetin you talk,you win.
Oya start to work or I go come take ova from u first tin tomorow morning.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...