MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 18 April 2016

OVA MY DEAD BODi!!! INSTEAD OF ME TO PLAY FOR ARSENAL,I GO RETIRE - DELE ALLI


Two enimis for inglish primia lig,Arsenal and Tottenham Hotspur,don see anoda reason to kontiniu dia hatred as Tottenham playa,Dele Alli don giv dem one strong bad belle yarnings.
Wen coppa90 askam during one joinbodi intaviu weda he go play for Arsenal if he get di chance,Dele Alli say he go hang hin boots and resign instead of am to play for Arsenal.
Gunners fans go don para tire for dis boy.
Dis two north London clubs hate demsef like cat and rat.
Tottenham dey sekond position,five points ahead of Arsenal for di lig table and e be like say dem go finish above di gunners for di first time for 20 years.
Na wa o,dis kain dia fight tire pesin.
Na dem naim sabi for yonda but sha make dem nor shoot demsef.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...