MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 22 April 2016

CONGi NA BASTARD AS COURT DON SENTENCE 70 YEARS OLD MAN TO PRISON FOR 7 YEARS BICOS HE RAPE TWO SCHOOL SHIDREN


Wetin konji dey cause for dis world mehn,na only God go save us.
Imagine,one 70years old man for Osun state wey congi nor allow rest as he rape two skul pikin of 13 and 14 years.
Dis man even get title for him vilage as di Loja,Araromi Otokobo but who say kongi nor fit hol' chief too?
Anyway,di man Chief Moses Adeniyi,carry di student wey dey trek go house afta dem close from school wit hin car,straight to di hotel were he lodge.
Afta he torchlight di gehs dem website for di hotel,he kon use one piece of klot take klin dem up and warn dem say dem go die if dem tell anybodi.
Wetin make di tin easy be say,Chief Adeniyi know d gehs dem bifor as na dia forma neighbours.
How di sikrit kon take come out be say,sombodi do amebor to one of di gehs mama say dem see one man wey carry her pikin for inside car.
Forward match,na di mama go skul go find out who carry dem wit car.
Fear nor let di gehs konfess since di chief tell dem say dem go die if dem yarn.
But afta dia tishas gidem mind say notin go appun to dem,Dem kon finalli konfess.
Afta all dis drama,lawya and judge,Kudirat Akano for Osun state high court,sentence Chief Moses Adebiyi to seven years for prison.
Dis na veri good judgement as na bad example di man set.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...