MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 7 April 2016

DIRTY BOY! SEE DI BOY WEY GO FLEX BABE WIT TEAR-TEAR BOXER(Foto)


Tins dey appun o!
How dis boy bodi dey do am as he dey wia dis kain boxa?
Wit N200 you go see chip boxa buy but dis mumu boy nor know say fotografas full hin back as he tiatia boxa dey show and meanwhy, di bobo busy dey yarn di babe dust.
Nor be only boys o dey mad for dis kain tin o.
Some gehs pant worse pass like dis.
As dem wear skirt and trauza take kova bodi,u kan neva know wetin dey.
Since evribodi dey wear normal clothes dey waka for road,nobodi go fit know who dey crase until u find out one day.

Dis boy na big disgrace sha.
Why he nor kuku come make i dasham 12 boxers out of di 600 boxas wey I get instead of to disgrace us like dis?
Ewu!
Animal boy.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...