MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 8 April 2016

JAMB QUESTION SINGA,SIMI SAY,IF SHE FIT DO KOLABO WIT JUJU KING, EBENEZER OBEY,SHE GO BUSS CHAMPAGNE


Dat babe wey hate jamb queshon die,Simi,don yarn say her dream na do kolabo wit Juju miuzik supastar,Chief Ebenezer Obey.
Di fine malawi yarn say di time wen she dey grow up,Chief Obey miuzik dey do am tirinrin for bodi and di miuzik inspaya her welwell.
She also yarn say anoda pesin wey she get plenti respect for again na,King Sunny Ade.
On top Fuji mata,Simi say if dem giam chance,one pesin wey she go like run tins wit na Pasuma Wonder.
E show say she sabi beta tin as dis one nor be bad idea at all.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...