MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 14 April 2016

POLICE DON FINALLY REKOVA CYNTHIA MORGAN WHITE RANGE ROVER SUV WEY ARM ROBBERS THIEF FOR LAGOS


Nor be yor portion.
Imagine wen arm robas gbask di only car wey u take dey see front,omo na die be dat.
Dat na wetin reggae miuzishan,Cynthia Morgan pass thru for some weeks as badboys tiff di babe range rover.

Di gud news now be say,di Lagos state police command don see di car for one mekanik workshop for Ojodu,Lagos.
How he take rish dia nobodi know but i know say di pipo wey get dat workshop don enta heavi gbege for police hand.
Dem nor dey tell pesin wetin dem dey use maggi for.
You kuku know how police problem dey be.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...