MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 6 April 2016

YORUBA ACTRESS TOYIN AIMAKHU,SAY MAKE ALL BLACK BOBOS DEY DIA LANE BICOS NA WHITEMAN SHE WAN MARRY


Wen black pesin don see hin felow black as yeye color,naim be say problem dey.
E fit get wetin di pesin go don see bifor he see black as yeye color.
Nollywood yoruba actress,Toyin Aimakhu don yarn say na whiteman she go marry dis time around afta her fest marage wit Niyi Johnson kaput.
She say instead of her to marry blackmananshe go kukuma remain single.
She yarn all dis one on top her Tv show,'KUWTA'.
She say married women dey try wen u see wetin dem dey pass thru for marage.
She say make God giv her di pawa to marry anoda man again.
Toyin say she nor sure say she go fit pass thru di fire again if not she go marry whitey.
I hope say dis woman nor go go back to her vomit.
If she later go marry blackman again,tori pipo go finish her wit curse.
Anyway sha,na her life.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...