MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 8 April 2016

BIGGEST WONDA EVA! MAN TURN TO COAKROACH AND HE HOOK FOR MOTOR TYRE WHEEL AFTA HE TURN BACK TO HUMAN BEING


Dis one pass magic o.
Who nor biliv say bad bad winch pawa dey bifor,if u see dis pikchor,u go biliv die.
Dis man dey trap for tyre rim afta he turn to kockroach or one small animal akordin to pipo wey dey dia.
Dis big wizard from Cameroon,forget wia he hide put dat nite.
Wen day brake,as he say make he turn back to human being,na inside motor tyre rim he find imsef.
He nor only wake up inside di rim wheel,he also wake up wit hin Cameroon jersey.
If dis kain one turn to moskito kon suck human being blood,he don be for di pesin be dat o.
Na once di pesin go turn to kpanla.
Baba God save yor shidren.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...