MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 1 April 2016

E BE LIKE SAY BUHARI PLENTI TRAVELING DON DEY BRING BETA RESULT AS EUROPE DON LIFT BAN ON NIGERIA BEANS


I dey sospet say travel king,President Buhari,go soon start to dey boast say him nor dey travel for notin as di same Europe pipo wey ban naija beans for 2015,don play enta di kontri to see how dem go take lift di ban by june.
Wetin make dem ban di beans bifor be say,wen dem testam,dem find out say di chemical wey we dey put for di beans make e for nor quick spoil,plenti pass wetin we sopose dey put,so diafor,dat na poison.
Dis ban also affect oda goods apart from beans.
Dis pipo,come check weda we dey screen our farm products true true bifor e rish dia hand.
Di asosiashon wey dey in charge to make sure u nor buy fake drugs and bad food,NAFDAC, carry dem go lab go see di machine wey dem take dey test our food bifor dem carry dem go obodo oyibo.
Di way wey di joinbodi meeting take end,hope dey say by june dem go stat to dey buy our beans again.
But di ogbonge queshon wey i won ask be say,na so our beans don plenti rish for us to dey form giant?
E rish us to eat sef?not to talk of to sell giv abroad pipo?
No wahala,make i stop bifor gofment go turn my beta queshon to somtin else.
Na small tin dey make dem dey arrest pesin for dis kontri.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...