MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 14 April 2016

CHINA ABEG MAKE UNA NOR BORROW BUHARI ANY MONEY-FAYOSE


President Buhari biggest enimi,Gofnor Ayo Fayose of Ekiti state,don tell China say make dem no borow Nigeria any money.
Fayose say na bia-bia bank di money go enta at di end of di day bicos di money nor get beta plan.
PDP nomba one jaguda,Ayo Fayose yarn sense sha bicos I undastand why we stil dey borow money upon all di mouth wey we dey make say we be giant of Africa.
We don turn borow-borow giant.
I tink Buhari dey boast say he don save ova N2.3trilion for just three months tru di treasury singo account?
Naim be say he don save ova N10trilion naira for di 11 months wey he don rule.
He try bicos dis money na politishans dey shiaram take buy cars dash dia geh frends bifor but now wey di money dey Buhari hand,why he kon stil dey borow?

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...