MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 2 April 2016

OMOTOLA SAY NEPA NA BIG 419 AND LAGOS STATE GOVMENT NOR GET SENSE BICOS NA ONLY TO DEY KOLET TAX DEM SABI


Nollywood actress,Omotola,don dey para sirios para for NEPA and Lagos State gofment.
She say one of di bigest scam and 419 for dis kontri na NEPA.
She yarn say she dey pay NEPA bill and she dey pay taxes but yet she buy gen to dey get light and also provide sikioriti for hersef.
She say NEPA own na to dey bring bills yet no light,why Lagos state gofment own na to dey worry for tax like Agege fly.
Omotola also yarn say,who go payback all di money wey she dey pay for tax?all di sikioriti wey she dey giv hersef,di generator,fuel,road and many oda tins wey she dey spend money for.
E be like say day just dey brake for Omotola area.
We don dey konplane since di day dem born us.
Sorry,welkom to our club of konplane. 

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...