MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 17 April 2016

Di FIRST PAPA AJASCO,PETER FATOMILOLA SAY,NO BEER WEY DEM PRODUCE FOR NAIJA WEY HIM NEVA TASTE


O boy,evribodi wit wia dey pain am.
rememba dis face for nollywood film,u go know say he always dey act as babalawo.
He name na Peter Fatomilola.
Dis man naim be di first Papa Ajasco for tv and wey diferen diferen pipo don act dat role today.
E get one tin wey him tell tori pipo wey make me shout.
Mista Peter Fatomilola say him and beer,be like 5 and 6.
E for kukuma beta make him build one beer factory for hin backyard since he yarn say him na sirios drinka.
Fatomilola say no beer wey dem produce for Nigeria wey him neva taste.
He even yarn say e get one time wey dem fly am go Jos for Gulder ultimate search 2.
He say for di two weeks wey him stay dia,dem dey givam two kartons of gulder evriday.
Peter Fatomilola say if him drink one karton,he go dash one karton to di sikioriti men.
Dis babalawo man say him nor dey use shack play at all.
Dis one sirios welwell.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...