MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 7 April 2016

MAKE UNA READY UNA CANDLE,SAWDUST AND FIREWOOD BICOS NLC DEY PLAN TO STRIKE OVA NEPA BILL AND FUEL SCARCITY


If dem tell u or u xpirience di strike wey nearli quench dis kontri for Abacha piriod for 1994,you go know wetin I dey yarn about.
Di strike protest against di June 12,1993 election wey di hole world gree say MKO Abiola win klin klia.
As if dat one nor rish,Abacha kon put Abiola for prison and dis one kon make di strike worse.
PENGASSAN and NUPENG also dey unda NLC.
Na dem dey control di staffs of di oil industri and wen dem strike dat year,di result bad finish.
Dat strike last for 3 months and no single fuel for anywia.
Pipo trek tire.
Inshot,one of my frend trek from Lagos to Sokoto.
No kerozin,no gas,no fuel,no food.
Na firewood and sawdust pipo take dey cook dat year for gud 3 months and notin like dat don eva appun.
Dis one wey we get jaguda president Buhari for seat now and NLC dey plan to strike bicos of di new high NEPA bill and fuel scarcity,I hope say he nor go do like say e nor consign am.
Soja na soja for stuborness.
Forget weda e wear khaki or agbada.
For dis strike,NLC say dem go also use am protest against di govnor of Kaduna state,El Rufai and di bad laws wey he dey plan against dia Kaduna branch.
Naija need prayers.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...