MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 7 February 2015

2FACE SAY MAKE GOVERNMENT INTRODUCE PIDGIN ENGLISH ENTER SCHOOLS

2baba don yarn say make govment use dia church mind and introduce pidgin langua enta naija skuls espeshally all dose skuls dem for villa.He yarn say all dose smallie for villa na pidgin english be most of dem second language,so for dat rizin,e good make govment introduce am to develop dia yarnings and to use am transfer knowledge to dem since dem undastand di language like a,b,c.
2face yarn all dis one on top dia join bodi talk for MTV Base wey dem dey call #Choose Or Lose Round table wey go start dis friday.
2face yarn say,dem fit employ some pidgin professors like you and me,pipo wey sabi di pidgin english langua reach ground.
He say dis na di only way wey dem fit take reduce di gap bitwin pipo wey dey use big big grammar and pipo wey dey soak pidgin language.




Wednesday 4 February 2015

OSINBAJO DON PLEDGE TO GOD NOT TO THIEF PUBLIC SERVANTS MONEY


Di man wey go bicom di second in command for naija just incase General Muhammadu Buhari win next weekend presidential election,Profesor Yemi Osinbajo don say,if you no go believe am for  anytin at all make u believe am for only one tin.
He say if he bicom di vice president,he can neva touch government money.
He say if dem like make dem givam Central Bank key,im no go touch govment kobo lailai.
He yarn all dis one yestaday on top twitter.
He say him don enta agreement wit Baba God say im no go tiff govment money bifor and afta.
Many pipo go say na lie lawyas take dey chop why many pipo go won biliv all dis kain talk if na pastor talk am.
Profesor Yemi Osinbajo na lawya and sinior pastor at di same time for Redeem christian church of God,RCCG.
You biliv say dis man no go touch gofment money if im oga,Buhari win Goodluck Jonathan for di election of who go bicom Nigeria presido for 2015?

ABOMINATION! ROBBERS DON ROB 60 YEARS OLD WOMAN OF PLACENTA


Two robbers run out of ideas yestaday for Agboju area of Lagos as dem snatch bag from 60 years old mama hand.
Di placenta of di baby boy wey her daughta just deliver for hospital dey inside di bag.
Money and some oda tins also dey inside di bag.
Di woman wey her name na Mrs Onwumere bin dey go troway di placenta but she kon stop for Agboju market to buy ingridients to take prepia pepper soup for her daughta base on say she just born.
All dis drama appun around 9 PM and mama sef dey veri sad for wetin di robbers do toram.
Na pipo wey dey around dat nite na dem kon gada money give di woman wey she take finally buy di pepper soup tins.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...