MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 31 March 2016

PRISON NEWS: MY PIPO,U DON HEAR SAY HOLLAND DEY CLOSE DOWN DIA PRISON BICOS OF LACK OF CRIMINALS?


Mehn!dis tori na di veri tori o.
Why many kontris like naija prison dey full troway,Holland don konclude plans to close down 5 more prisons afta dem close down 19 for 2013 sake of say kriminals nor dey worry dem again.
Infact,di problem of empti cells bad so tay,na Norway dem for carry 240 prizinas to stay inside dia prison.
If dem close dis prisons down,almost 2000 pipo go loose dia jobs.
Out of dis pipo,na only 700 di gofment go hep wit job for anoda dipatment.
For naija,u nor need kriminals bicos,inosent pipo plenti welwell for jail.
I rememba some years ago for Warri,police pick me and my frend for street 7 O'clock in di evening for no rizin go put for cell.
For odnari stroll wey wey we dey stroll,dem arrest us.
Why prison nor go full for hia,wen he be say innocent pipo plenti pass kriminals for naija prisons.
Lucky Dube know wetin he sing dat year wen he say dem nor dey build schools again,na so so prison dem dey build.

Wednesday 30 March 2016

GOD FORBID! TUFIAKWA! SUPASTAR PRAIZ,SAY NO GIRL GO GET BELLE FORAM UNTIL HE MARRY


Praiz,di bobo wey sing dat koret jam,rich and famous,don yarn say,him nor need any baby mama for een life.
We know many stars for dis kain baby mama parol like 2face,Wizkid,Davido,May D,Flavour and plenti odas wey give girls belle bifor daybrake.
Wen tori pipo askam say,Praiz,you dey plan to get baby mama veri soon?
Di bobo shout!"God forbid bad tin!if na swear I rejetam in Jesus name!
All dis tolotolo gehs una don hia o!
If una dey find supastar wey go giv una belle,Praiz nor dey among.
Di bobo don yarn us say na marage bifor shidren,naim sure pass.

GUN MAN! DAVIDO TAKE GUN FROM MOPOL HAND AND SHOOT BIRD MAMA


Abeg anybodi wey see Davido baby mama uncle,Dele Momodu,make he telam say Davido don Len how to dey shoot afta dem kworel.
Davido fest show us wia him for wear odnari boxa dey eat rice bifor he kon show us di ak47 wey hin take dey play.
Di bobo put hin shooting pratis on top snapchat and naim mopol sikioriti gun di bobo take dey do dis xpensiv joke.
I dey even tinkam sef weda e dey right for di mopol to giv gofment gun to Davido take dey do dis robish?
We hope say inspektor genera of police go edukate us on dis mata.

Monday 28 March 2016

BOBMSHELL! DEM GIVE JONATHAN CHANCE TO RULE,HE MESS AM UP..GOD PUNISH HIM PAPA-MAJEK FASHEK


One of di most talented miuzishan to come out from naija,Majek Fashek,don blast forma presido Goodluck Azikiwe Jonathan.
During Majek pafomans for Ay Easter groove for Eko Hotel dis morning,di guy yab Uncle Jona say dem givam chance to rule,he mess up.
Majek say na God go punish hin papa!
As for Buhari,di reggae miuzishan say dat one na kolo.
He say Buhari na General,imsef na General,so im get to soport di General.
If nor be say Majek Fashek paform well for Ay live,pipo for fil say na mad yarns di guy dey yarn.
Now wey di man don yarn he own,e dey left for u to look back by yorsef weda na true say uncle Jona fall our hand wen he get di chance.

Sunday 27 March 2016

BYE-BYE TO WAR AS EX MILITANT LIDA,TOM ATEKE DON SETTLE BLACKFACE,2FACE TOGEDA WIT FAZE


Forma oga-militant for Niger-Delta,Tom Ateke don settle di kasala bitwin Blackface and 2face as dem don agree say 'e don do'.
Di joinbodi meeting appun for een haus for Okrika,Rivers state.
For di ground,Faze, di ted memba of dia group Plantation Boys dat year, also join for di peace meeting and di three of dem agree on one tin,'peace'.
Recently,Blackface bin akiuz 2baba of tiffing een song and tori pipo nor fail to do dia work as dem write aboutam tire.
All of dem shake hands,laff and shack togeda for di ground.
Now wey Tom Ateke don settle Blackface and 2face,make I hurry go settle Blackface and Wizkid bifor nite go rish weda tori pipo go carry my stori for head like lakpalakpa.
Wizkid na one of di miuzishan wey Blackface also akiuz of tiffing een song.

TUFIAKWA! SOUTH AFRICA BABE DEY BEG DAVIDO FOR INSTAGRAM MAKE DI BOBO SLEEP WITAM JUST FOR ONE NIGHT



Omo,pipo nor get shame for eye again o.
I nor dey soprise again espeshali wen u watch di kain tins wey pipo dey put for intanet nowadays.
Imagine one babe for South Africa wey her name na @Sne_Pearl for Instagram,put Davido pishor for her page,kon dey pray and beg Davido to sleep witam for just one night.
She even use Yoruba write some lines and as if dat one nor rish,she kon dey call Davido 'Baby Jesus'.
Wen one of her folowa askam say why she won pakam giv Davido,she reply di pesin say she born shidrens for di naija supastar.
Na all dis kain robish dey make dem Davido dey misbihave more and more.
Ehn!
No singo shame!
May God diliva di babe from di spirit of ashawo.

Saturday 26 March 2016

JAMB QUESTION SINGA SIMI,DON YARN SAY SHE DEY TIRE TO BAFF


Simi,dat babe wey buss enta di stage wit dat swit song Jamb Queshon,don yarn tori pipo say di tin wey dey vex her pass na wen baff time don rich.
She say nor be say she hate to dey baff but she like to dey do plenti tins at once.
Simi say if u enta baffroom,u nor fit do any oda tin apart from to baff only yor bodi.
She say she fit dey brosh her teeth sometimes,at di same time,she fit dey press computa or even read join.
Na dat kain life naim di babe say she dey like.
If u dey among all dose pipo wey dey go toilet kon dey press phone as u dey offload,Simi na yor kain pesin.
Or,if u dey among dose kain pipo wey bifor dem go cook finish,dem don alreadi chop di food finish on top fire,Simi na yor type bicos una like to do two or three tins at once.
I hail una.

Friday 25 March 2016

SEE YOR VICE PRESIDENT DAUGHTA.SHE WORWOR OR SHE FINE?

Wetin man go do?
Wen dem enta position,all of a sordin dia shidren go turn celibritis.
Weda dem worwor or fine,weda dem get strong face or not,weda dem rob make-up or sand,weda dem get kokonut head or not,amebor pipo go dey folow dem upandan.
Oya see yor vice presido Yemi Osinbajo pikin,Kiki Osinbajo.
How u siam?
Di babe try or not?




YANSH DANCE: SEE AS ANNIE DEY PLAY WITH 2face MUMU BUTTON (VIDEO)


Dis babe try sha.
At list she don try to stop 2face from giving girls belle anyhow.
If na bifor,who dat girl be for yor area?
2face for don play enta dia backyard go plock mango.
From mango,dat babe go land for mataniti home.
But wit dis kain backie dance wey een wife,Annie Idibia dey givam for dis vidio,di bobo go don kpror small for kurukere waka.
I nor soprise say di mesage wey Annie send go 2baba mumu botin make di guy dey laff.
Oya Watcham for bottom hia....


WIZKID NA BABA NLA,I NOR UNDASTAND WHY UNA DEY COMPIA ME WITAM - REEKADO BANKS


Di pesin wey start dis argument for twita go don draw bodi take and pem for kona dey watch how pipo dey blast Reekado Banks.
Di pesin say Reekado Banks beta pass Wizkid.
O boy,if u see di blasting wey Reekado dey resiv from left right and senta,u go know say pipo wicked for dis kontri.
One say pesin wey kompia Reekado to Wizkid say,dat kain kompia be like who dey kompia iPhone 6 to Nokia 3310.
One even say di nomba of Wizkid songs wey don skata evriwia,plenti pass Reekado Banks fans.
Shuu!naija!wetin!
Now Reekado Banks don come out to yarn say make pipo allowram to soak him garri and groundnut jejeje bicos na pipo like Wizkid giv dem di liva to enta di industri.
He say na disrespect to Wizkid if dem dey compiaram to di Ojuelegba singa bicos di guy na one of di greatest.
I nor know wetin dem want make Reekado yarn again o.


SABI BOYS! NIGERIA BEAT BRAZIL AGAIN!


Di nationa team don show Brazil again say for U-23 level,we know how to take dem do yeye as we beat dem one kondo for dia own backyard early dis morning for one frendli match to take prepia demsef for di olympics wey go start for August.
Dem play di match wen many naija pipo stil dey sleep bicos our midnite for hia na dia evening for yonda.
Ubong Ekpai naim score di only goal of di match wen di match just dey 3minutes.
Brazil try tire to ikwolize but our goalkipa,Emmanuel Daniel katch all dia ball like say him do juju.
E get wia dem play di match rich,Brazil fans kon dey soport us as dia team disapoint dem.
Dis na di sekond time wey naija dey beat Brazil for U-23 as we don hama dem for Atlanta 96 olympics by 4-3 wen Kanu Nwankwo use dia goalkipa take do yeye.

Thursday 24 March 2016

UNA GO KONTINIU TO SUFFER TO DEY GET FUEL TILL ENDING OF MAY AKORDIN TO MINISTA OF PETROL, IBE KACHIKWU


Ol boy dis change neva rich one year o.
I go change and relocate go America go meet my famili if e kwantiniu like dis.
Sometimes I dey ask mysef say wetin I dey do hia sef and all my famili pipo dey obodo oyibo dey use snow dey play.
Anyway,make I gist una di latest news as di minista for petrol mata,wey also be NNPC general manager,Ibe Kachikwu,don yarn us say una go sofa to get fuel for anoda extra two months bicos een nor be majishian.
He yarn dis one during di joinbodi meeting wey him and president Buhari get wit association of gas and petrol staffs NUPENG and PENGASSAN for Aso Rock,Abuja.
Di minista say make we even tank God bicos na miracle say we dey see small buy for filling stations sef.
He say gofment employ am to work but dem nor employ am as majishian and na jejeli dem go take solve di plenti issue wey full ground.
He say make I yarn una make una chilax say afta sometime di problem go solve.
Wen dat time don rich,I hope say he nor give anoda twist to di gist?
We sidon dey watch.

LOVE NWANTITI: OMOTOLA HUSBAND TATTOO HER NICKNAME,"OMOSEXY" FOR HIM MUSCLE



Love na biutifu tin as dem yarnam.
If u nor jealous actress and nollywood big name,di sexy and biutifu Omotola and her husband swit marage togeda,naim be say notin fit make u jealous again for dis life.
Even if small gbege play enta dia union,u kan neva notice or know bcos of how dis two pipo don manage demsef veri well.
Dem don get four shidren togeda and  di tin stil dey shack her hosband like shakitibobo as he draw Omotola guy name "Omosexy" for him muscle.
Di babe naim reliz dis pikchors hersef as dem mark dia 20 years of marage togeda and also di captain betday.
Congratulabia to dem.

Wednesday 23 March 2016

OKOKOBIOKO!!! SEE MACHINE WEY FLAVOUR TAKE DEY OPPRESS WIT PHYNO



Dis boys dey mad o!
Shuo! Dis kain machine wey be like fish motor wey Flavour Nabania take dey oppress him area na wa o.
Flavour drive een Chrysler prowler and putam on top Instagram to pepper Babylon dem eye.
Phyno sef sidon for di pasenga side of di car and dem dey plasta di street togeda but I soprise say nobodi dey di street.
Abi dem don turn Michael Owen or na environmental sanitation day dem enta street?
Anyway make dem enjoy demsef na dem time.
Life is swit.

PETER PSQUARE DON FINALLY LOCATE DI GIRL WEY CRY BUCKET FULL MAKE PSQUARE NOR BREAK UP



Okay o!
Fishaman don katch fish.
Peter,one half of di twins wey make up Psquare,don finalli see di girl wey cry bucket full sake of say she nor want make Psquare seprate.
Peter use torch and kandle dey look for dis babe since and he don finalli siam.
Now wey bros don locate di babe and he tell us on top Instagram,Oya wetin dey next?
I hope say nor be wetin I dey tink sha.

FUTURE AGBEROS! SEE DIS 2 TO 3 YEARS OLD PIKIN DEM WEY DEY SHACK DRY GIN

Wetin dis kontri dey turn to?
Wen we small like dis,if our mama buy us biskit,we dey crawl enta di next street go call our friends to join us celibrate and naim make us grow up as gud shidren wit respet and beta karata.
My grandmama dey sell plenti drums of ogogoro in dose days but we nor dey near wia di ogogoro dey bicos of how dem bring us up.
Imagine dis two smallie dem wey dey shack satchet dry gin!
None of dem don pass 3 years.
Chai!one na even girl sef.
At dis kain age dem don already dey kolo.
Tell me how dem nor go turn agbero wen dem grow up wen dia head don alreadi dey toch for dis age.
I blame dia papa and mama wey nor know demsef.
My prayer for dem na make dem nor carry gun wen dem grow.

Monday 21 March 2016

FINALLY,DIA HEAD DON STOP TO TOUCH AS PSQUARE AND DIA BRODA DON SETTLE DIA GBEGE






Now all of dem don go back to Instagram and agree on one tin," famili first."
Dem say kolomenta na inside head e dey stay as di heads of Psquare and dia sinior broda,Jude,don stop to touch.
Afta about 3 months of quorel,di spirit of oneness don enta dia bodi.
Peter nor be Paul bin yarn on top twita for January say,dia elda broda,Jude,must to stop to be dia manager but Paul say no way een biliv in famili.
Play play play,na so di mata take sirios.
Dis one go say,na dis one naim he head nor koret,dat one go say,na dat one head dey shake.
Tank God for dia life as dia head don straight back as three of dem don gree say dem dey stupid.

BREAKING NEWS!!! BIG TALENT,NOMORELOSS,DON DIE DIS MORNING


Nigeria entatainment industri don record one big loss as Miuzishan,comedian,mc and multi talented guy, Olumuyiwa Osinuga aka Nomoreloss,don die dis morning for one hospita for Opebi,Ikeja,Lagos.
Reports wey we gada be say,di Iyawo Asiko singa bin dey sick since January bifor he give up di ghost dis morning March 21,2016.
Many pipo don konfamam inkluding een frends and een manager,Joyce Ize-Iyamu.
May his soul rest in peace.

UPON SAY DOLLAR DEY USE NAIRA DO YEYE,DIS GIRL STILL GET TIME DEY CRY SAY MAKE PSQUARE NOR SEPERATE(VIDEO)


Na wa o.
So dis babe rili beg her frend make she vidio how she take dey cry say make Psquare nor break up?
Wondas shall neva end.
Dollar don yeye our naira for ground,pure water na N10 now,one seed of candle na N30 now and dis babe stil get time to dey cry say make Psquare nor seperate.
Dis babe get plan.

Watch di vidio for bottom Hia...


FOTOGRAFA DON CARRY 2FACE GO COURT FOR N120MILLION ON TOP FOTO MATA


One fotografa,Emmanuel Okolo don carry 2face go di Federa High Court bicos he nor see een kompini name on top di foto dem afta 2face put dem for een own website.
Di bobo don tell court say,for dat alone,him want make 2face pay am N120million.
Him snap di foto dem for 2face and Annie wedding for Uyo,Akwai ibom.
Emmanuel say,out of di 355 foto wey een give 2face,dem write 2faceonline.com on top 148 foto.
He say di agreement na for 2face and him wife to write een kompini name,papilonmexy films for di foto bodi but somtin else dem write on topam.
But 2face and een lawya don say make pipo nor mind di guy bicos na fence he jump enta di wedding.
He say nobodi givam any kontract to snap pishor,na carry snap een do for Uyo.
Ok na,make we dey watch wetin go appun for di case.

Sunday 20 March 2016

SHUO! SHUO! SHUO! FANS NOR ALLOW SUPERSTAR "RONALDO" DRINK TEA PUT CUP FOR GROUND (VIDEO)


God abeg allow me get half of dis kain lifestyle wey pipo don choose for Cristiano Ronaldo.
Choi!
See as di bobo mata thick as fans nor even allowram drink een tea as dem won use selfie take kill di bobo troway.
Oya watch the vidio hia....


CYNTHIA MORGAN DEY ASK UNA WEDA MAKE SHE NAME HER ALBUM "24"?


For 24hours now I dey comb di intanet to look for beta tori to serve una and I come across dis one now now.
I visit di dancehall mama, Cynthia Morgan Instagram page and I jam dis tori.
She write say afta dis her album wey she dey plan to throw out,una go undastand her beta.
She say for di 24years wey she don spend for life alreadi,why some pipo stand gidigba by her side,sleep katch some pipo for her mata.
She say for dis reason alone she dey ask weda make she call di album "24"?
Well,dis one na queshon for di fans.
But if u ask me,24 nor be bad idea.
I go Sidon for my fence dey view.
Anytin she call di album,una go see di aproko for hia.

FORMA OYO STATE GOVNOR,ALAO AKALA,DON TELL ONE JONALIST SAY HE DEY VERY STUPID TO ASKAM WEDA HIM DEY BLEACH

Alao Akala
Fela wia u dey?
Heaven or ......?
Dat yor bleaching song,'yellow fever',don dey make brain again o.
Na small tin remain,one jonalist for chop beta hot slap from Alao Akala just bicos he ask simple queshon.
Di tori man ask di forma Oyo state gofnor say, "chairmo,u dey bleach"?
O boy,if u see di para wey Alao para for di jonalist ehn,fear go katch u.
"U dey mad!wich kain stupid queshon u dey ask me?
I be like who dey blich for yor eye?
U buy bliching krim for me?
My wife and my shidren come complain for u?
If u won write dis tori,make sure u write say,I talk am say u dey veri stupid to ask me dat kain nonsense queshon!"
Choi!dis na high grade para o.
Di forma gofnor even vex raise een singlet up make di jonalist see een belle and bodi.
"Dis na bliching?
U don see di krim wey I dey use dey blich?
Stupid boy!u know me wen I black bifor?"
Para get class o and dis one na highest.
Oga govnor,abeg take am easy o,na wen tori pipo don ask queshon finish bifor dia eye go kon clear say queshons get boundary.
Any jonalist wey bin go Saddam Hussein office wen he dey alive, kon go smart askam say,"Presido,how many pipo u don send yor boys to kill for u since u dey office?"
Chineke!
Na koret Egusi soup dem go use u take prepia for vultures to wack wit beta cold beer for dem to push yor meat down.
Look di forma gofnor pikchor yorsef sha weda di man dey blich true true.

Saturday 19 March 2016

POLICE DON ARREST ONE MAN BICOS HE MARRY WIFE WITHOUT Di BABE PAPA AND MAMA PERMISION


Policemen for Dolphin police division for Ikoyi,don alreadi dey call one 30 year old Ugo Madugba woman kidnapa bicos he marry Nono Orji witout say her popsi and momsi nor apruvam.
Na Nono hersef naim postam on top facebook make pipo hepam as she claim say police won poison her husband for inside prison.

She say sake of say she nor gree marry di man wey her Popsie and Momsie dey forsam marry,naim make dem arrest Ugo.
Akordin to Nono,she say police nor gree allow her hosband to see him famili and frends.
Even him lawya kpakpa sef don try tire to siam but police dey blockam.
Akordin to sombodi for di police ground,dem say dem go transfer di mata go Lagos state C.I.D office for Panti bicos dem don dey look dat Ugo Madugba wit krimina eye.

Friday 18 March 2016

YAWA RACE: TONTO DIKEH DON RUN LIVE D'BANJ KOMPINI,DB RECORDS


Dis one wey evribodi dey comot for D'banj record kompini so,I hope all is well wit di koko garri sella?
Just 5 days ago,Db records produca,Deevee live D'banj and now di sugar wey dey rush from Tonto Dikeh for Db records don stop akordin to di nollywood star.
Weda na forma nollywood star I go call her sef,I nor kon know bicos Tonto,di newest mama for town,nor dey appear for new home vidios again for some time now.
Tonto announce say she nor dey work wit D'banj again yestaday and we nor dey soprise bicos since she marry Churchill,she don drop many tins.
Weda she don drop di big tattoo wey dey her back na dat one I neva know.

Thursday 17 March 2016

FORGET SAY I BE BABA FOR FUJI MIUZIK,I GO SHAME PIPO WEY FEEL SAY I NOR FIT BLOW WITH HIP HOP MIUZIK - OBESERE


Live mata for mathias my guy.
You fit yarn yor own,Fuji singa Obesere don yarn him own.
Di guy don yarn say since na hip hop miuzik dey reign now,he must to reliz 18 track hip hop album.
As u dey read dis tori,Obesere don alreadi shoot di vidio for one of di hip hop song,'Ebele Suwa' and he fichor di ogakpatakpata of Ybnl,Olamide.

Obesere say,him na jack of all trade,so diafor,him don readi to shame pipo wey dey fil say dem plant him placenta on top only Fuji miuzik wit dis hip hop album.
Oda Fuji miuzishans wey don try dia hands on hip hop na,Saheed Osupa and Pasuma Wonda.
No wahala Obesere,we don hia evritin wey u yarn about yor hip hop dream.
Sofa make u nor disapoint plenti pipo like my grandpapa wey get koret ear for hip hop miuzik.

Wednesday 16 March 2016

ONE FAN DON REPORT DERENLE TO INSPECTOR GENERAL OF POLICE BICOS OF EEN YEYE GAY BIHAYVIOR



Akordin to one man for twita(profajayi), he write to inspektor genera of police say di kain pichors wey mc and tv star,Derenle dey post on top intanet,show say him na gay,so diafor,di police force get to investigate tam.
For dose of us wey nor know,gay means,man wey take man take do lova instead of woman or woman wey dey frend woman instead of man.
Gofment don put law say anybodi wey dem katch on top dis kain mata,go enta prison for 14 years.
Di king of akpola and lover of stori building shoes,Derenle,naim let us know about di report as he retwit @profajayi twit.
Derenle reply dis tori on top Instagram say,him dey look for new haters as di old ones don dey lovam.
He say even di new ones wey dey availabo nor get swag.
Many pipo espeshali for dis kain kontri wey pipo stil biliv in Africa korchor small,hate Derenle lifestyle but di bobo nor send anybodi papa mesage as di kraze dey inkriz evriday.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...