MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 30 December 2015

Di MOMODU AND Di ADELEKE FAMILY DON SKATA INTERNET FOR GROUND BICOS OF DAVIDO AND BABY MAMA,SOPHIE FIGHT

Wot a way to end di year for tori pipo.
Tori pipo nor get to skata dia head just to find fresh tori as plenti to write don land.
David Adeleke aka Davido and him baby mama,Sophia Momodu don sign war on top di tin wey join dem togeda,dia pikin,Imade.
7 months old Imade,dey wit Davido family right now and dem say dem seize am from di mama bicos she nor dey take kia of di baby well.
Dem say dem run test for di pikin and find out say she dey suck ganja from di mama breast since bicos na so so ganja di mama dey smoke but di babe don deny say Davido lie for her head.
Di Adelekes say right now di pikin dey sick since all di igbo dey go strait to di mama breast as a result dem get fly di pikin go tritam.
But di Momodus wey ovation magazine owna,Dele Momodu be dia lida,say Davido and him family kidnap di baby and dem dey travel wit di baby and di mama nor know about am.
As we dey yarn like dis,imigration pipo for airport don seize di Adelekes passport make dem nor fit bend live di kontri.
Dele Momodu wey be Sophia uncle,get koneshon and Davido papa get money.
'Money power'and 'koneshon' don jam demsef.
Who go win.
Bifor I say make I write dis tori complit,more drama don come out as Davido and Sophia don exchange words tire for twita.
If nite nor quik reach,I go bring una all di tori.
Dis one na season 1 of dis drama,make I kross road go buy akara first.

NEW FADA KRISMAS FOR TOWN,WIZKID,DON DASH 4 FANS N1 MILLION

Krismas na di season of plenti rice,enuf stew,chicken murdering,boku joliment and also,krismas na di season of giving.
Supastar Wizkid,don show some fada krismas love to him fans for industry nite wey appun for Oriental Hotel,lagos.
Di Ojuelegba singa give N250k each to four fans wey sing een songs well witout missing any line.
O boy dis one na beta krismas for di fans so.

Tuesday 29 December 2015

SUPER EAGLES MIDFIELDER OGENYI ONAZI QUEUE UP TO BUY AKARA FOR JOS

Lazio of Italy and Super Eagles playa,Ogenyi Onazi,don rememba some of di wackis wey een dey miss for abroad.
As he enta for di krismas holiday e no soprise me say di bobo go line up to buy mama akara fried beans.
Di vice captain of di national team celibrate een birthday on krismas day and he arrange bags of rice and oda gift give some village pipo.
Make evribodi wey don pick dey give back.
Na so e sopose be.

WIA DIS ABEOKUTA MAN DEY CARRY CROCODILE DEY GO ON TOP BIKE?

Chai!
See my best meat!
As I dey siam,I dey swalow saliva.
Crocodile;chai!
Dat meat too swit.
Sias dis man just tie yam on top motorcycle dey carry am dey go wia I nor know.
Wia I fit see dis man for Abeokuta?
If na to buy di crocodile and di bike join,I nor mind.
E dey pain me o.
Crocodile tears don full my eyes rite now.
BooHooooo..buah,buahhhhh.


Monday 28 December 2015

DON JAZZY SAY HE GO RETIRE FROM SINGING WIT HIM FROG VOICE FOR 2016

Don Jazzy don yarn on top twita say,na to retire from singing by 2016 naim dey he mind.
How old Mavin boss Don Jazzy be wey he won retire from singing?
For real life,u say u neva rish 40 not to talk of yor football age.
Beta produca naim you be,I nor fit ask queshon for dat one but di singing sef kon inkriz yor GP.
If pipo nor love yor frog voice like dat,yor GP nor go dey wia e dey today.
Michael Jackson sing til he die at di age of 50, he nor retire.
Quincy Jones dey conduct,dey produce,dey arrange,dey compose,dey act,dey sing dat year and he neva stil retire at di age of 82.
Na only betday Quincy dey celibrate,he nor dey celibrate retirement.
If you retire who knows, one Don Quazzy fit spring up and take yor place and if u try to do singing comeback,pipo fit nor send u again o!
I know naija pipo o! Dem get bomb for head o.
Dem neva stil ansa Mocheddah,Olu Maintain,Mandators,Kelly Handsome and many odas afta dia comeback songs.
Ehen,I just dey yarn sha.
Make dis my smelling mouth nor land me for trouble o.

BREAKING NEWS: MOURINHO MANCHESTER UNITED SCARF DEY SELL LIKE PURE WATER OUTSIDE OLD TRAFFORD GATE NOW

Altho sha,na Luis Van Gaal still be di coach of Manchester United but di kain ugly futbol wey dem dey play for dis past few weeks ,don see dem dey loose anyhow like novice.
A hole Man U neva win match for di last seven games.
Now sack odour don dey smell for Van Gaal nose as pipo don alreadi dey yarn say na Mourinho wey Chelsea just sack,go replace am.
Ahead of di match bitwin Manchester United and Chelsea dis nite,pipo don dey buy Man U scarfs wey carry Mourinho face for inside.
Na pesin quik quik tink dis bizness so and pipo dey buy di scarfs like pure water.
Di handwriting for di wall clear rish.
Na judgement piroid for Van Gaal be dis.

EKPE! ABUJA BABE,KIMBERLY BIG IKEBE DON CONFUSE ONE WHITE GUY

Di tin wey yansh dey cause for dis world don tire me.
If to say na me dey junction dey preach di word of God,nobodi go send me.
Check dis foto wey Kimberly di Abuja big babe snap,u go see one white guy for di background wey don foget imsef sake of say he dey look beta Africa yansh.
I nor blame di whitey,who nor go like dis kain tin.

WATER NA WATER,E NO MEAN WEDA YOU DRINK PURE WATER-PATO RANKING

Pato Ranking di reggae,dancehall star don yarn say one singo differens no dey if u drink pure water or satchel water.
Di bobo say e nor go change anytin but just rememba respect yorsef and rememba di time wey tins nor pure for di bigining.
Nor be say u don hama now den sachet pure water don bicom shit for yor eye.

CHECK OUT FOTOS FROM OLAMIDE CONCERT #OLIC2

Di Olamide show for Eko hotel don come and go but di fotos last nite neva stil comot for pipo eyes.
Nor be small tin yestaday as di place full dey troway wit pipo.
Me I soprise as I kon dey ask mysef say,na small Olamide of yestaday kon dey gada dis kain crowd?
O boy respect God o.
Radio stars Dotun and Toolz, join Basketmouth for di mc.
See more of di show fotos for bottom hia:


CHECK OUT DI BIFOR-WEDDING FOTOS OF FLAVOUR MANAGER,BENJI WIT IFEYINWA

Any man wey find een wife,don find beta tin.
Highlife miuzishan,Flavour manager,Banjamin Omesiete,don find one for imsef.
Benji and een malawi,go do dia white wedding Jan 4,2016 for Enugu and many naija top artiste go play enta dia go show dia jersey nomba.
Congratubia in advance.
See more foto for bottom hia:

Sunday 27 December 2015

MADNESS KONTINIU AS TIWA SAVAGE WEAR 'RICE SACK' GO PAFORM FOR OLAMIDE SHOW

Na so okorowanta 'smelling biabia' craze take start for warri dat year bifor he kon turn sinior crazeman for town.
Now Tiwa Savage don dey plan to follow okorowanta footsteps.
Who know,she fit stil follow okorowanta FOOD'step as na picking food chop for dustbin di bobo like dat year.
Nor be her portion in Jesus name but wetin u won call di kain clothes wey Tiwa dey wear dis days go show?
Last Wednesday,she wear one kain craze woman dress for di"Access Mavin Concert".

Yestaday for Olamide show for Eko hotel,na sack of rice she wear go paform for stage.
Maybe she want make pipo for feel say she know wetin she do on Wednesday wit dat dressing naim make her wear sack clothes dis time around.
I dey feel say since Yemi Alade don take her crown afta she take break go born her pikin for July,she won claim her position back at all means.
Na di sack clothes go givam di position back or na good miuzik?
Time go tell.

ONAZI SHOWER GIFT FOR HIM VILLAGE PIPO HEAD FOR Di CHRISTMAS

Super Eagles midfielder,Ogenyi Onazi,don show love dis krismas to him village pipo as he don share gift and bags of rice giv dem.
Di bobo say im na testimony of di good work of God and since He send Him only pikin wey dem born on krismas day to share blood and die for all of us,he must aprishiate tam.
Just like Jesus christ,dem born Onazi on krismas day and he celebrate tam wit style.


BAD MARKET FOR BLEACHERS AS M.I SAY BIFOR HE GO MARRY ANY YELLOW GIRL,HE MUST SEE HER SMALL PIKIN PISHOR

Dis na pure bad market for gehs wey dey bleach as di short black boy,M.I don say bifor he go marry any yellow girl,he must see her small pikin foto.
Di Africa rappa nomba one singa,say some gehs get skills for bleaching so tey u nor go know weda dia color na atifisha since dem don tay for di bizness.

Di bobo yarn tori pipo,potpourri all dis one.
M.I say he nor dey for dat kain mata bicos he must know di truth about yor real color.
Nice one M.I but some gehs wey dia real color na yellow dey like dia man to dey veri tall.
You want geh wit real color why some gehs want man wey tall.
1-1 na draw.

Saturday 26 December 2015

FROM JANUARY 1ST,2016,FG GO REDUCE FUEL TO N85

Subsidy,subsidy,subsidy!
Dis subsidy talk I nor dey wan hearam for my ear.
Wen I dey grow up,I nor know anytin like subsidy yarns.
Since di yarns start na up up fuel price dey go.
Now Federa gofment say by January 1st dem go reduce fuel price from N87 to N85 bicos dem won remove subsidy.
Ok you don hear subsidy,dem say dem won remove you o.
Nor be talk am o,
Na minista of state for petroleum,Dr Ibe Kachikwu talk am.
We dey wait.


TIWA DON ENTA NEWS AGAIN FOR NONSENSE REASON

Siriosli I nor get anytin to yarn for dis mata.
Tiwa Savage open her korokoro eyes dress like dis for Mavin konsat for Eko Atlantic?
Pesin mama for dat mata.
If I talk na dem go say I don shack.
I live dis mata for una.
Super Eagles bin get teknika adviser dat year.
Yes I rememba,Clemence Westerhof.
So Tiwa hosband nor fit stand as adviser foram?
Yeye dey smell.

Friday 25 December 2015

YEYE MAMA: WIZ KHALIFA MAMA SAY NA SHE MAKE KHALIFA FALL IN LOVE WIT IGBO

For proverbs chapta 22 vas 6, di bible yarn say,Train yor pikin di way wey e soppose be,so dat wen he old dose tins go mastaram.
Wiz Khalifa mama go win di worst mama award for di hole world if dem do di award.
Di rappa mama don tell tori pipo say na she make her pikin love marijuana like pikin wey cartoon don take een brain.
Katie 'Peachie' Wimbush-Polk wey be Khalifa mama,say wen di rappa small,bifor she go go work and bifor Khalifa go go skul,dem go first rap Igbo smoke togeda and dat is why di pikin nor fit live di habit.
Dis na yeye mama wit yeye achivment.
For her mind na beta tin she ticham.
Mumu mama.

BOVI OWN DON PURE AS HE DON BUY HOUSE FOR LEKKI FOR CHRISTMAS

Nor fear,yor hustling go soon pure.
E nor go tay.
Bovi turn don rish and di bobo don tear one wicked haus for Lekki.
Linda Ikeji own na for banana island but Bovi say he own dey for groundnut island.lol
Congratulabia.

I TALK AM: TIWA SAVAGE DON REPLY FANS WEY INSULT HER BABY FOR INSTAGRAM

Plus all di xpensiv food stuff,no light,no money,no fuel and plenti oda no dis and no dat,di list tin wey naija pipo go hate pass na not to use dem dey play.
Tiwa Savage don bite more dan she fit chew.
Naija pipo dey dia own but wen she born,dem stil follow her and her hosband,Tee Billz tank God.
Wetin kon pain dem pass,na wen dem kon dey hide di pikin face.
To form Michael Jackson na by force?
Today,dem go show only di baby legs,tomorow dem go show di pikin bicycle.
Wen she finalli show di baby face today,some fans kon dey insult di baby.
She nor fit bear ram na she reply dem.
See dia fight on top Instagram for bottom hia:


LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...