MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 27 January 2015

CHAI! SEE GOVERNOR ROCHAS OKOROCHA DEY DANCE SHOKI

Dem say pipo  wey get sweet mouth pass for di world na politicians.is either dem dey tell u sweet sweet tins to buss yor brain so dat u go vote for dem or dem go use doings hold you for local just to get your vote.
If u see di kain shoki wey Govnor Rochas Okorocha of Imo state dance on Tuesday for APC campaign rally, u go fear.
You go even begin ask yorsef queshon say,"ehen, so dis big men know about galala and shoki too?
Yes! Di tin be say dem even know about di kontri problems more dan u but dem dey act blind from morning til nait.
Dem know say NEPA dey one corner dey craze dia own, dem know say mosquito dey follow us drag who get nigeria bicos of no beta drainage, dem know say pot holes don draw maps of africa full our road, dem know say naira dey fall yakata against di dollar anyhow, dem know say our mama dey suffer to buy kerosine bicos e scarce and e cost,den know plenti tins.
May God hep us.

Wednesday 14 January 2015

PRESIDENT GOODLUCK JONATHAN DON SIGN ORITSEFEMI


Mercies of di Lord neva still stop to dey come down on di Delta born bobo, Oritsefemi as President Jona don vex sign am as di official musician wey go dey follow am go anywhere wey him dey carry campaign enter.
During di president campaign for tafawa balewa square for Lagos for next month election, Oritsefemi scata evriwia wit im performance as even oga Jona stand up and join evribodi dey sing along to double wahala, di music wey don catapult Oritsefemi name enta evri area and evri kona for naija.
No be small tin as Jona and di crowd turn "double wahala for dead bodi" to national anthem for di ground.
Ol boy! Evriwia stand still for Oritsefemi as di crowd dey shout say dem want more but di time no kon dey enof since dem go do oda tins.
Wetin kon plate Oga Jona dada welwell na wen Oritsefemi kon sing "Great jonathan"di music wey im compose for di president.
Di president no fit bear di happiness, naim he alla say Oritsefemi must to dey follow am enta evriwia for all him join bodi waka to kontiniu as di president of Nigeria.
He say Oritsefemi teeth complete and he also yarn say di bobo na great musician.
Oritsefemi go dey di next campaign ground for Akure dis week to kontiniu from were he stop.

Wednesday 7 January 2015

N3000 DON MAKE ONE MAN WAKE UP FROM COMA


One Chinese man, Xiao Li,wey bin dey coma or deep fainting for ova a year now don recently wake up as one of di nurse for di hospital were im for dey receive treatment,sample ram 100-yuan (about N3,000 for naija money).
Xiao Li get dis problem wen he nor gree sleep for some days for one internet bar for Shenzhen, South China guangdong province for August 2013.
Na even last March here naim di guy start to dey respond to treatment.
As he see di money wey dey raise up, naim he stretch hand to pam am from di nurse hand.
Although sha he take am like 5 minutes to grab di money but di doctors say na sign say di guy dey improve and he don comot for coma wey im dey.
Doctors say e go still take some time for dis lucky man to fully recover bifor dem go finally discharge am from hospital.

Tuesday 6 January 2015

THE WORLD STRONGEST FOOTBALLER NA NIGERIA PLAYER ACCORDING TO FIFA

FIFA Don reveal di world strongest footballer for di world.
We dey proud say na naija boy, Adebayo Akinfenwa wey dey tap leather for AFC Wimbledon, England.
If u no believe, google ram yorsef or

You fit read more here>>>>http://www.bbc.com/sport/0/football/30693977


Monday 5 January 2015

CHINEKE! MISS BUMBUM BRAZIL DON INJURE SERIOUSLY FOR YANSH


If you be girl wey dey try to do surgery make your yansh for big, dis tori fit make you change your mind.
Can you imagine!
27 year old Andressa Urach wey carry 2nd for miss bumbum Brazil,nearly kpeme and she get to go do thanksgiving if she don comot for hospital.
No be small tin as her yansh kon dey rotten bicos di chemicals and fillers wey dem pack full her yansh after surgery kon dey cause anoda tin.
She don release horror pictures of di time wen dem dey givam life saving treatment for hospital.
Brazil don ovatake America as di numba one kontri of pipo wey carry plastic surgery mata for head.
Dis pictures go make u fear fear.





WE NEED DIS KAIN THICK PLAYERS FOR SUPER EAGLES TO SCARE DIA ENEMIES?

HE NAME NA DANNY SHITTU and HE GO BREAK YOUR BLOODY KNEE
TROWAY FOR NOTHING
Dia names na Danny Shittu and Adebayo Akinfenwa.
Dem be naija born and na dem be di two biggest and thickest players for England right now.
Danny Shittu of Millwall football club, na forma Eagles defender why Akinfenwa wey dey play for Afc Wimbledon,  neva play for naija bifor.
I rememba wen Cameroon dey suffer Super Eagles wit dia thick thick players.I rememba wen Mboma dem dey use big big bodi dey push dem Celestine Babayaro comot for road go score us goals and win plenti nations cup for our head.
In short, since Cameroon stop to use unripe plantain players, dia football don go down like tire wey nail chook.
So you feel say di Super Eagles of naija wey evribodi dey beat nowadays need Rugby muscle players like Danny Shittu and Adebayo Akinfenwa for our squad to put fear for other kontris mind?
Or you feel dia muscle na wash, say notin dey appun?






TIWA SAVAGE SHOW OFF HER BIG BELLE

Tiwa Savage don show us for instagram again how far her belle dey grow since she break di news for new year day of her pregnancy.
She step out dis time around wit her husband Tee Billz as two of dem attend #AliBaba new year day concert wey shele for Eko hotel.
She wear jumpsuit and e kon make her belle shoot out like balloon.
Dis belle don make di babe calm down as all di stage ginger go hold break small.
Mr and Mrs Balogun pose wit NFF Chairman, Amaju Pinnick

Sunday 4 January 2015

SERENA WILLIAMS MADLY IN LOVE WITH OYIBO BOY


Of all di fish dem wey full river, Serena Williams don choose dis oyibo pepper,Patrick Mouratoglou wey be her coach.
Di 18 times grand slam winner, Serena Williams don fall in love wit dis oyibo bobo and naim be her coach since Septemba 2012.
Serena wey be 33 years old land for Perth airport with her handbag and her boyfriend,44 years old Patrick to play di Australia open wey go start from January 11 and dem kon snap some kain pepper di haters for bodi kind of pictures.
Check dem out yorsef make u talk scores.




Saturday 3 January 2015

DEM DON CATCH KOGI OKADA RIDER WEN HE DEY DO KEREWA WIT MADMAN FOR BUSH

I

Chai! Notin we no go see!
Congy is a bastard!
Dem catch dis okada man wit a veri fine boboyish haircut for one bush wey near di kogi state universiti wen he dey do kerewa wit one mad woman.
Even Anyigba police station for di area confam say dis tori na true.
Nobodi know wetin dis okada rider won try to gain. Weda na rituals make am sleep wit di madman or im John Thomas naim just dey scratch am, we no know.
Tufiakwa!

Thursday 1 January 2015

HAPPY BIRTHDAY CHAZ B( Rest in Peace)


Death, make I tell u something. ..
*E no go beta for you*
As u say u no go allow pipo drink water put cup for ground enh, death..u no go die beta die.
Chaz B, you suppose to be a year older today but death just show say e no dey respect anybodi wen e draw u take for 22nd of November, 2014.
Di pipo wey yor program for radio,Sharing Life Issues change dia life, nor go forget u and Heaven go kontiniu to rememba u.

RIP Big name.
RIP Chaz B.

TIWA SAVAGE DON CARRY BELLE


Forget all di kwanta wey evribodi carry about Tee Billz and im wife, Tiwa Savage.
Di truth be say,nobodi fit predict wetin dey pipeline and nobodi know di importance of dia bedroom reach dem.
Dem say dem no dey drink panadol for husband and wife mata if not dem go use u take settle for bedroom and dis na wetin first lady of Mavin records,Tiwa Savage Balogun and Tunji Balogun just do so.
Notin we neva hear about dis dia marriage.
At a time sef,dem say Tiwa,dey do kelekele love wit Lagos big boy and pasona assistant to Govnor Babatunde Fashola of Lagos state,Folly Coker.
But di good news for di Balogun family be say di eminado singa and her husband don announce for instagram say she don get belle.
She yarn dis one immidiately pipo shout "happy new year" early dis morning and she kon backam up wit picture wey show say she don really chop belleful.
Tee Billz don alreadi get two girls from anoda woman but dis one go be di first pikin for Tiwa Savage.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...