MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 1 January 2015

TIWA SAVAGE DON CARRY BELLE


Forget all di kwanta wey evribodi carry about Tee Billz and im wife, Tiwa Savage.
Di truth be say,nobodi fit predict wetin dey pipeline and nobodi know di importance of dia bedroom reach dem.
Dem say dem no dey drink panadol for husband and wife mata if not dem go use u take settle for bedroom and dis na wetin first lady of Mavin records,Tiwa Savage Balogun and Tunji Balogun just do so.
Notin we neva hear about dis dia marriage.
At a time sef,dem say Tiwa,dey do kelekele love wit Lagos big boy and pasona assistant to Govnor Babatunde Fashola of Lagos state,Folly Coker.
But di good news for di Balogun family be say di eminado singa and her husband don announce for instagram say she don get belle.
She yarn dis one immidiately pipo shout "happy new year" early dis morning and she kon backam up wit picture wey show say she don really chop belleful.
Tee Billz don alreadi get two girls from anoda woman but dis one go be di first pikin for Tiwa Savage.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...