MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 30 January 2019

TANZANIA STAR 'DIAMOND PLATNUMZ' DON DEY BEG DIA GOVMENT MAKE DEM DECLARE HIM MARIAGE PUBLIC HOLIDAY MAKE ALL HIM FAMILY MEMBERS FIT ATTEND



Diamond Platnumz don kneel down dey beg di Tanzania gofment make dem declare him marriage day as public holiday so dat him famili membas go fit liv work attend di marriage.
Although him bin don get Pikin wit him baby mama bifor but now him don decide to marry him Kenya model girlfriend Tanasha.
Him bin fix di marriage for Valentine day but bicos Tanasha mama go dey work dat day,him kon shiftam go front small make di babe mama fit show for di ground.

Monday 28 January 2019

IF YOU BIN DEY LOOK Di 50 YEARS OLD YORUBA ACTOR 'FUNSHO ADEOLU' WIT BADBOY EYE,HE SAY U NO TRY AT ALL BICOS HIM DEY CHURCH KWAYA SINCE 1982


One ting about film be say,if you dey act bad pesin role,pipo go dey see you as bad pesin for real life.
One bobo wey no sabi quick laff for film Funsho Adeolu,don yarn tori pipo say,him na gentle man for real life even tho say dem dey look am wit badboy eye bicos of film.
Di popular 50 years old nollywood Yoruba actor also yarn say,na since 1982 him join kwaya for church.
Nice one sir but you join kwaya no mean say you no fit still be bad boy.

Sunday 27 January 2019

AFTA ACTRESS LIZZY ONUWAJE CONFESS SAY SHE NO DEY WEAR PANT AGAIN BICOS OF YAHOO BOYS RITUALS,ANODA ACTRESS'NAZO EKEZIE' SAY,SHE DON STOP TO WEAR PANT TOO


Nollywood actress Nazo Ekezie say she don stop to wear pant bicos rumors don full town say guys mostly yahoo guys dey use girls pant do rituals make maga for dey pay wella.
Dis one dey come few days ago afta anoda nollywood actress Lizzygold Onuwaje also confess say she don stop to wear too bicos of di same reason.
Wen dis drama go end?

Saturday 26 January 2019

SINGA 'MR EAZI' DON CLEAR PIPO SAY,E DEY WRONG WELWELL FOR ANYBODi TO THINK SAY HE GET TEMI AS HIM GIRLFRIEND BICOS OF HER PAPA FEMI OTEDOLA BILLIONS



Leg over singa Mr Eazi,don yarn say,him no dey afta billionaire Femi Otedola money as pipo dey talk.Femi Otedola daughta Temi,na Mr Eazi girlfriend and pipo don dey yarn say,na di girl papa money he dey afta but Eazi say anybodi wey dey tink like dat get sef worth issues.

Wednesday 23 January 2019

SINGA 'NINIOLA' WEY BE THE SENIOR SISTA TO 'MY PAPA NO BE DANGOTE SINGA 'TENI,DON BUY JAMB FORM GIVE 30 STUDENTS


Niniola don use her foundation and office 'Adopt a child education'take buy Jamb forms for 30 pipo.
Dis na veri good behavior and koret example to copy.
If you dey follow up,Niniola na sinior sista to di babe of di moment 'Teni' and two of dem don show say talent dey dia famili.

Tuesday 22 January 2019

FEDERAL HIGH COURT FOR ABUJA DON STOP EFCC FROM ARRESTING FANI KAYODE AND YINKA ODUMAKIN UNTO THE FAKE NEWS WEY DEM SPREAD SAY,EFCC DON ARREST CHIEF JUSTICE ONNOGHEN


A division of di federa high court for Abuja don stop EFCC from arresting PDP FANI Kayode and Chief Yinka Odumakin afta di two of dem carry fake news say EFCC and DSS don go Chief justice of Nigeria Walter Onnoghen.
If you dey follow up you go know say Federal gofment bin get ploblem wit Onnoghen unto say dem say he get some kain wuruwuru bank accounts and he no declare all him propatis wey him get afta dem make am Chief Justice.

Sunday 20 January 2019

FALZ DON YARN TORi PIPO SAY,THE REASON WHY HIM NO DEY GO CHURCH NA BICOS,ANY CHURCH WEY HIM GO THE PASTOR DEY LIKE INTRODUCE AM TO CHURCH MEMBERS BICOS HIM NA STAR


Falz the badt guy,one of naija baddest rapper don say make pastors focus on wetin go make dia membas know God beta instead of dem to dey worship supastars.
Some days ago,Falz mama Funmi Falana dey pray make God touch Falz heart make him bigin go church.
Falz imsef don come out to say no be say him no be Christian but him stop to dey go church bicos anytime wen him go church,na so pastors go telam to stand up make evribodi rekognaiz say supastar dey church.
He say di ting dey make am shame and no be wetin dem sopose to dey do be dat.
The bobo say wetin impotant pass na make di pastors kontiniu to dey teach di membas di word of God wey dem go use take see front.

Friday 18 January 2019

APC FOR IMO STATE DON SUSPEND GOVERNOR ROCHAS OKOROCHA OF IMO STATE BICOS DEM SAY HE GET DIRTY KARATA AGAINST THE PARTY


APC national chairman Adams Oshiomole don approve di suspension of Imo state gofnor Rochas Okorocha akordin to di letter wey di Imo state chapter of di APC caretaker komiti chairman Prince Marcellinus Nlemigbo sign.
APC suspend Rochas on top wetin dem dey call 'gross anti-party activities' and dis one mean say,him karata dirty towards di party even tho say naim won reprezent di party for election to take pick Imo West Senator.
If you dey follow up,you go don hear wen Rochas say,him dey support Buhari but he no deg support APC for Imo bivos dem no gree choose him Inlaw to bikom di next govnor.

Wednesday 16 January 2019

RIHANNA DON CARRY HER OWN PAPA GO COURT UNTO SAY HER PAPA DEY USE HER COMPANY NAME TAKE RUN HIM BIZNESS


Obodo oyibo way of life diferen from our own welwell.
If you neva hear,supastar miuzishan Rihanna don carry her papa Ronald Fenty go court bicos her papa dey use her kompini brand 'Femty' take dey run him own bizness.
Wetin I notice here too be say him papa name na Ronald Fenty and her kompini name na Fenty.
Nor be her papa sopose dey vex say she use him name take open her kompini?
Rihanna na ya papa try make una settle

Monday 14 January 2019

NOLLYWOOD ACTRESS LIZZY ONUWAJE DON YARN TORi PIPO SAY,SHE DON STOP TO WEAR PANTS BICOS DEM SAY YAHOO-YAHOO BOYS DEY THIEF GIRLS PANTS DEY DO RITUALS NAWADAYS


If your babe dey wear pant bifor and all of a sudden she nor kon dey wear again,my broda, she don put you for di list of pipo wey she dey fear.
If you dey follow up,you sopose don hear wetin dem say yahoo -yahoo boys dey use girls pant dey do now.
Dem say na rituals dem dey use dem do now make dem for hama.
Base on dis one naim make nollywood actress Lizzygold Onuwaje yarn say,she don stop to dey wear pant now bicos she dey fear make anybody no go kidnap her pant take do juju.
She say wetin rili make her cross heart say she don give up on wearing pant be say, she hear say,some guys attack some group of girls wey dey comeback from church and dem force dem to pull dia pants.
Lizzy say,for pipo like dem wey dey spend most of dia time for hotels base on dia work,dem need to dey kiafu bicos hotel workas fit go thief dia pant bifor dem come back from location.
Dis one weak me I swear.

Saturday 12 January 2019

FELA PIKIN 'SEUN KUTI' DON YARN TORi PIPO SAY,LIKE SAY HIM PAPA STILL DEY ALIVE,BY NOW,HE FOR DON BE PRESIDENT OF NIGERIA



Bifor Fela die,he no join politiks and dat na one ting wey all of us know.
But now one of his Pikin Seun Kuti don yarn tori pipo say,like say him papa dey alive,he for don be President of Naija.
Well I no know weda Fela for enta politiks or not but one ting wey I dey sure of be say,if Fela bin dey alive,di yabis against bad and kworopt leaders for kontiniu.
Ask Babangida,Obasanjo and Oga Buhari weda I dey lie.
Dem know di man karata pass me.

Thursday 10 January 2019

BRAZIL COURT DON STOP WORLD STAR 'RONALDINHO 'NOT TO TRAVEL COMOT FOR BRAZIL UNTO SAY HE DON DEY BROKE AND PLENTY DEBT DEY HIM HEAD


Dis sopose to be lesson to pipo like Boxing champion Floyd Mayweather wey dey feel say him billions long and he no fit go broke for life.
Former two times world footballer of di year Ronaldinho of Brazil long money don dey finish as court for Brazil don stopam from living di kontri unto say,big debt dey di guy head.
Dem don seize him and he broda passport make dem no fit comot for Brazil bicos dia kompini dey owe debt afta dem break some gofment environmental laws.
Ronaldinho sopose enta Dubai go run one or two shows dis week but di mata affect di waka.

THE BOY WEY DAVIDO DASH N1 MILLION NAIRA DON USE THE MONEY TAKE BUY KEKE NAPEP



Di way wey naija ekonomi dey go,if you manage get small money no get sense,you no fit get sense again till you die.
Di boy wey Davido dash 1million one naira some days ago don use di money take arrange Keke Napep for imsef.
Di bobo show say him na wise man.
At list di boy show say sense full him brain box.

Wednesday 9 January 2019

WONDAMENT FOR LAGOS AIRPORT AS DEM DON ARREST THE EGUSI WEY ONE MAN DON ARRANGE FOR BAG DEY CARRY GO LONDON



For Lagos airport no be small drama appun as airport authorities don stop one man from make he no carry him egusi follow bodi enta London.
Di man para for dem no be small as he no gree for dem.
If you go Lagos airport,you go see say dem still dey settle di mata.

Tuesday 8 January 2019

DEM DON ARREST THE EGUSI WEY ONE MAN DON ARRANGE FOR BAG DEY CARRY GO LONDON


For Lagos airport no be small drama appun as airport authorities don stop one man from make he no carry him egusi follow bodi enta London.
Di man para for dem no be small as he no gree for dem.
If you go Lagos airport,you go see say dem still dey settle di mata.

Monday 7 January 2019

AFTA BURNA BOY WIN FOUR AWARDS FOR THE SOUNDCITY AWARDS,HIM MAMA DON TELL THE WORLD SAY MAKE DEM EXPECT MORE MADNESS FROM HIM PIKIN FOR 2019


For di Sound city MVP Awards wey dem do ova di wikend,one artiste clear almost all di awards.
Yes Burna Boy hardwork and talent finally pay off as di bobo win four awards dat nite.
Him mama naim reprezent Burna.
Infact she steal di show dat night as she say Burna Boy travel out of di kontri.
Wen she climb stage go collect di awards,she thank di organizers say dem do well to rekognaiz him pikin talent.
She say 2019 go stew finish and make we expect more madness from Burna Boy.
Wen your mama stand gidigba for your back,why you no go succeed?
Beta style.

Sunday 6 January 2019

PASTOR ADEBOYE DON WARN HIM RCCG CHURCH MEMBERS SAY,FROM NOW ON,DEM GO ARREST ANY PESIN WEY DRESS ANYHOW COME REDEMPTION CAMP GROUND


Yoopi and slay queens boys and girls,in case una neva  hear,di General Ovasia of Redeemed Christian Church of God,Daddy G.O Pastor Enoch Adeboye don dey draw him church membas ear say,na high grade kasala dey await anybodi wey dress like mad pesin come di redemption camp church for Lagos/Ibadan expressway.
Pastor Adeboye say from now on,anybodi wey dress anyhow come church,police no go waste time to arrest dat pesin.
E don red o!
Make I sidon for fence dey wait wetin Daddy Freeze go yarn on top dis mata.
He fit no be basket mouth but he get somtin to yarn for tings like dis.
Make I kontiniu to wait like dog wey sidon dey wait for bone.

Friday 4 January 2019

NIGERIA POLICE DON RECEIVE 242,455 APPLICATIONS FOR 10,000 VACANCIES AFTA OGA BUHARI SAY MAKE DEM EMPLOY MORE POLICE



I bin tink say Naija police dey on a steady insult level as pipo always dey blast dem say,Di police force no get head.
My queshon now be say,who be di 242,455 pipo wey apply for di 10,000 vacant police work if na true say our ekelebes no dey try?
If you dey follow up,you suppose don know say,President Buhari bin approve make gofment rekrut 10,000 policemen make dia work fit dey eazi.
Di way wey di mata be so,e mean say,out of evri 24 pipo wey submit aplicashon,dem go take one pesin.

Wednesday 2 January 2019

NO BE SMALL CURSE AND INSULT Di BOBO WEY YARN ON TOP TWITA DON RECEIVE AFTA HE TALK SAY,WIZKID BETA PASS FELA



Some pipo say na di wrong igbo wey di boy smoke make am talk say Wizkid sabi sing pass Fela,some say,e be like say dem pour raw ogogoro for di guy soup,some even say di bobo dey look for cheap populariti.
Up till dis morning some pipo still dey yabam but di truth be say some few pipo still soportam sha.
No be small confusion dey boy set on top twita afta he rate Wizkid higher dan Fela.
We as guys wey sidon on top fence dey watch evribodi on top di mata,dey wait wetin Wizkid go yarn las las for dis tori wey dey skata evriwia.

Tuesday 1 January 2019

BURNA BOY VEX COMOT FOR STAGE AFTA DEM STOPAM NOT TO SPRAY FANS MONEY FOR THE 'ONE LAGOS FIESTA' GBEDU


Anoda drama naim appun for di one Lagos fiesta gbedu last nite as Burna Boy vex comot for stage.
Him vex live stage sake of say radio man Olisa and him gang stopam not to dey spray fans money.
Dis one vex Burna Boy as he waka comot for stage.
If you dey follow up you sopose know say,2018 na Burna Boy year as he bless di industri wit koret koret gbedu for fans to take follow up.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...