MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 30 April 2018

BOKO HARAM DON DEY COLLECT TAX MONEY FROM Di TOWN AND VILLAGES WEY DEY UNDA DiA CONTROL FOR BORNO AND YOBE STATES


Tori wey dey rish our tori room be say,one break away branch of Boko Haram don dey kolet tax and revenue from towns and villages wey dem don kapchor so dat dem go dey give dem sikioriti make dem fit dey sleep wit dia two eyes close.
Dia oga wey dey kolet dis money na Abu musab Al-barnawi wey be di pikin of Boko Haram founder Mohammed Yusuf.
Akordin to one herdsman or malu boy wey tori pipo follow yarn he say,dis pipo dey kolet N2,500 for malu and N1,500 for small small animals.
Afta dem kolet dis tax from dem,dem go kon gidem seeds and fatalaiza to use for dia farm and bush.
Na wa for dis kontri.

Saturday 28 April 2018

NOLLYWOOD STAR AND ACTRESS 'BLESSING OFOEGBU' DON YARN SAY,SHE GO LIKE MARRY MAN WEY RICH PASS BILLIONAIRE 'MICHAEL OTEDOLA'



Evribodi wit wetin dia prayer point be.
Your prayer point fit different from my prayer point.
One pesin wey don tell tori pipo about her prayer point na Nollywood star Blessing Ofoegbu.
She say she go like marry husband wey rich pass billionaire Michael Otedola.
But wetin we no know now be say weda she add fasting join di prayers bicos you fit count billionaires wey dey naija.
Dem no pass 30.
Evritin na faith for dis life aftaraw faith fit move mountain.
We wish her goodluck for dis trillionaire search.

Thursday 26 April 2018

ONE OF Di ZULE-ZOO MEMBA, Di GUYS DEM WEY DAT SONG 'KEREWA' MANY YEARS AGO,DON RUN MAD ACCORDING TO HIM PARTNER,IBRO ZULE-ZOO


Ibrahim Hassan a.k.a Zule-Zoo one of di two guys wey sing Kerewa many years ago don tori pipo say him second parna Mike don run mad.
He say na wetin make pipo no dey hear from dem for some time be dat.
Akordin to Ibro he say,dem wake up one day just see di guy bigin behave like madness and dem be feel say na joke.
He also yarn say di ting dey pain am bicos Mike be like him blood broda bicos na since primary de turn frends.
Oya watch di video yasef hia...


Wednesday 25 April 2018

NEW TORi: ETHIOPIA DON BECOME Di COUNTRY WEY DiA ECONOMY DEY GROW FAST PASS FOR AFRICA ACCORDING TO INTERNATIONAL MONETARY FUND,IMF


Ethiopia,one of di kontris wey hunger dey pass for di world don dey win many pipo heart as dem don bikom di kontri dey grow fast pass for Africa akordin to Intanashona Monetri Fund,IMF.
Na only God know di position wey naija dey right now.
Four years ago,na we bin dey carry first for kontris wey dia ekonomi dey grow fast pass.
Now hunger won finish us.

Tuesday 24 April 2018

FEDERA GOVMENT DON FINALLY TALK SAY,DIFFERENCE NO DEY AGAIN BITWIN BSC FROM UNiVASiTi AND HND CERTIFICATES FROM POLYTHECHNIC,NA Di SAME LEVEL DEM DEY NOW


If you graduate from Politeknik wit HND satifikate  no worry yasef again say you no dey di same level wit pipo wey get dia BSC satifikate from univasiti bicos federa gofment don yarn say,all di satifikate na di same now.

Monday 23 April 2018

CHARLY BOY DON TELL GOVMENT TO BAN BIG BROTHER NAIJA BICOS Di SHOW NO GET ANY BETA TING WEY DEY TEACH


Area fada Charly boy don yarn tori pipo say make gofment ban Big  Broda Naija bicos e no dey add value to di youth lifes.
He call di show crap bicos di prezent wahala wey di kontri dey face di show no join to solve am.

Sunday 22 April 2018

NEW MILLIONAIRE GO COME OUT FOR NAIJA TODAY WEN Di 2018 BIG BROTHER NAIJA END TODAY AS ANYBODY WEY WIN GO GET N45 MILLION ALERT FOR HIM ACCOUNT


Di 2018 Big broda naija go end today and di winna go win N45 million naira.
Di game dey bitwin Cee C,Tobi,Nina,Miracle and Alex.
Dem be 12 wey start di battle but na di last 5 standing naim be dat.
Goodluck to all of dem.

Saturday 21 April 2018

DAVIDO DON TELL TORi PIPO SAY,NA ON TOP TWITA HIM MEET MAYORKUN BIFOR HE SIGN AM TO HIM GANG




Oga of Davido Music Worldwide,Davido imsef don yarn tori pipo say,na twita him for know Mayorkun wey be one of di biggest names for Naija miuzik industri right now.
Akordin to Davido joinbodi intaviu wit Cool Fm Dotun for Lagos he say,for good one month,him and Mayorkun dey talk for twita but Mayorkun no biliv until him siam face to face.

Friday 20 April 2018

PRESIDENT BUHARI TORi PESIN FEMI ADESINA DON YARN SAY,BUHARI NO TALK SAY NA ALL NIGERIA YOUTHS LAZY,HE ONLY TALK SAY NA SOME OF DEM LAZY


President Buhari don make naija youths dey para foram afta he say naija youths too lazy during one of him joinbodi sidon meeting for obodo oyibo.
No be small curse nigeria youths don curse am since he talk am.
Now,di man wey dey in charge of to soport Buhari weda he yarn puan or not,Mr Femi Adesina don talk say,Oga Buhari no talk say na all Nigeria youth dem lazy.
He say wetin di president yarn be say,na some nigeria youths dem naim lazy,na we no hear well.
Naim be say,di same ear problem wey Buhari bin get dat year,all nigerians don getam since dem no fit hear exactli wetin presido yarn.


Thursday 19 April 2018

KADUNA GOVMENT DON SACK 4,562 NEW TEACHERS BICOS DEM SAY,NA WURUWURU WAY DEM TAKE GET Di WORK


Tori wey dey rish our tori room right now be say,Kaduna state gofment don sack 4,562 new tichas wey dem just give work sake of say,na wuruwuru way dem take get di work.
Dis one weak me o.
Afta dem don selibrate bifor say food don come.

FULL VIDEO OF HOW THUGS TAKE THIEF 'THE MACE' FOR Di NIGERIA SENATE,ABUJA


No be small tin for di Nigeria senate yestaday as thugs and ogbologbos break enta di house and thief the Mace from table.
Many pipo don dey say na di handwork of Ovie Omo Agege sake of say dem suspend am from di house dis week.
Watch di video of how di mafia dem take enta di house tiff di mace..


KADUNA GOVMENT DON SACK 4,562 NEW TEACHERS BICOS DEM SAY,NA WURUWURU WAY DEM TAKE GET Di WORK


Tori wey dey rish our tori room right now be say,Kaduna state gofment don sack 4,562 new tichas wey dem just give work sake of say,na wuruwuru way dem take get di work.
Dis one weak me o.
Afta dem don selibrate bifor.

Wednesday 18 April 2018

NAIJA POLICE DON CONFIRM SAY,NA CRIMINAL OFFENCE TO DEY CARRY PEPPER SPRAY WAKA



Afta police arrest pesin bicos he carry pepper spray for bag,naim tori come from d mouth of Assistant Komishona of Police Mr Yomi Shogunle say na crime to carry pepper spray waka.
Akordin to Yomi on top twita,you no suppose carry any instrument to difend yoursef dey waka as e dey against di law.
Pepper Spray na offence?
Na wa o,i just dey hear dis one so o!

Tuesday 17 April 2018

FORMA KHAKI PRESIDO IBRAHIM BABANGIDA a.k.a IBB DON YARN SAY,NA YOUNG PESIN MUST RULE NIGERIA FOR 2019 BICOS OLD PIPO TURN DON PASS


Forma Khaki Presido,Ibrahim Babangida,IBB, don yan tori pipo say,na young pesin must rule nigeria for 2019.
He yan dis one for him house for Minna,Niger state afta di Yes Nigeria movement visitam.
He say him dey yarn dis one base on say him na forma president and pesin wey get naija for mind.
Make we see wetin go appun for 2019 afta IBB and Obasanjo don tell Buhari make he go rest make anoda pesin try him luck wen 2019 reach.

Monday 16 April 2018

SUPER EAGLES PLAYER JOEL OBI DON YAN TORi PIPO SAY,ITALY PIPO BEGAM TIRE TO PLAY FOR DiA COUNTRY BUT HIM NO GREE BICOS HIM KNOW SAY HIM NA NAIJA PROPERTY


Super Eagles playa and naija boy, Joel Chukwuma Obi don yarn tori pipo say, Italy begam tire to play for dia junior team but him no gree.
He say him always get hope to play one day for him papa land wey be Nigeria.
True true, God ansa him praya as him later enta Super Eagles team for 2011.
Di only ting wey make am no too dey show face for di team na plenti injuries wey him dey always get.
Joel Obi wey dey play club football for Torino of Italy right now, Don start to pray make God let Super Eagles coach Gernot Rhor fit pikam as one of di players wey go reprezent naija for di FIFA World Cup, Russia 2018 wey go start for June 14..

Sunday 15 April 2018

DIS NA SUNDAY TORi AS PASTOR ADEBOYE OF Di REDEEM CHURCH DON TALK SAY,ANYBODY WEY NO DEY PAY TITHE NOR GO GO HEAVEN IF HE DIE


Pastor Enoch Adeboye of The Redeemed Christian Church of God,RCCG,don yarn anoda one as he talk say,forget heaven if you no dey pay tithe for church.
Akordin to Adeboye,if you won enta heaven paradise,you must to dey drop steadi tithe for church.
If you rememba,anoda ogbonge pastor Tunde Bakare bin don talk say,to pay tithe akordin to di bible no be by force.
Na wa o,who will go come biliv now?

Saturday 14 April 2018

SUPER EAGLES PLAYER,ALEX IWOBI DON YAN SAY,ANYTIME WEY DEM DEY SING Di NATIONAL ANTHEM FOR FIELD,HIM DEY ALWAYS CHOP MOUTH MAKE PIPO FOR TINK SAY,HE SABI SINGAM


If u feel say na only you no sabi sing di national anthem of Nigeria,no think am again bicos Supastar Arsenal and Super Eagles Playa Alex Iwobi, no sabi am too. 
Akordin to di bobo he say, him dey always chop mouth anytime wey him dey sing di national anthem for match bicos him no too sabiam. 

Friday 13 April 2018

74 YEARS OLD WOMAN FOR ZAMBIA, 'GRANDMAMA MARIA', DON START PRIMARY SCHOOL FOR Di VERY FIRST TIME FOR HER LIFE AND SHE DON SABi DEY WRITE HER NAME NOW



74years old Grandma Maria for Zambia Don finalli learn how to hold pencil and write her name afta she start primary school for di first time for her life.
Dem force her marry wen she be 14 years and she neva go any school before for her life.
Grandma Maria say,if na only her name she fit sabi write bifor she die, her mind go rest and true true she don sabi spell her name now.

Thursday 12 April 2018

2FACE DON YAN SAY,HIM WAN JOIN POLITICS AND CONTEST FOR 2019 ELECTIONS BICOS WE NEED GOOD PIPO WEY GO RULE DIS COUNTRY


Supastar miuzishan 2face,don para,vex,cut rope and don readi to join politics for 2019.
Akordin to 2face,time don rish for good pipo to wake up and ends politics.
Well, we hope say if he join politics and win, make God letam rememba him pipo and rule dem well bicos, e be like say e get special ogogoro wey politicians dey drink wey make dem dey misbehave. 

Wednesday 11 April 2018

ACCORDING TO Di NATIONAL FILM AND VIDEO CENSORS BOARD OF NIGERIA, DEM MUST DO Di NEXT BIG BROTHER NAIJA FOR DiS COUNTRY IF NOT, WAHALA GO DEY


Big Broda Naija organisers go soon enta wahala wit Di Nigeria Censors Board if dem no take dia advice.
Akordin to Di National Film and Video Censor board (NFVCN), dem must do di next Big Broda naija for inside Nigeria bicos we get efritin for here.
Di exekiutive director of di board,Adebayo Thomas  naim yan dis one.
He say if MTN from South Africa fit dey do bizness 24 hours evriday for hia, to do big broda naija hia, no sopose be ploblem.
So diafor, dem must do di next one for naija except say dem no get plan to do am.

Tuesday 10 April 2018

FROM OCTOBER IF YOU BE TAXI DRIVER FOR ABUJA,YOUR TAXI MUST GET AIR CONDITION (A.C) ACCORDING Di TRANSPORT SECRETARY


If you dey stay Abuja and you dey use taxi welwell,you go soon dey enjoy air condition for all if taxi akordin to di transport seketri for dia.
Mr Kayode Opeifa di seketri,yan dis one for Abuja on Monday.
Trust naija,di taxi pipo go add somtin join di taxi fair on top dia A.C levels.

Monday 9 April 2018

AFTA HER PIKIN DIE, NOLLYWOOD SUPASTAR AND PASTOR EUCHARIA ANUNOBI DON TALK SAY, SHE DON READY TO GET ANODA MAN AND GET ANODA PIKIN BY GOD'S GRACE


Anunobi Eucharia, Nollywood supastar and pastor, don yan tori pipo say, di way wey di Mara be now,she don ready to get anoda man and even get belle foram.
Afta her only son die, she don dey feel veri bad as di ting still dey pain her enta bone. 
To move on, she say she dey wait for God order to enta anoda marage and get picking. 

Sunday 8 April 2018

FRESH TORi: NO HOPE TO GET YA MONEY BACK AS 'MMM' DON FINALLY CLOSE DOWN AFTA DEM BURY Di OWNER OF Di BIZNESS 'MAVRODI' WEY DIE FOR MARCH 26


If you dey among pipo wey dia money loss for MMM and you still dey expect say one day your money go come out,my broda, my sista, you are on your own as dem don finalli close MMM down.
Dem close am down afta di founda of di bizness Mavrodi imsef, die on March 26.
Di news dey dia website since on Friday.
Di tori of say dem close am down come out yestaday afta dem bury am.
If you dey follow up, you go know say, pipo wey Dia money loss for Mmm plenti pass sand.

Saturday 7 April 2018

COURT DON SEND POPULAR INDIAN ACTOR SALMAN KHAN GO JAIL FOR FIVE YEARS BICOS HE KILL ANTELOPE


Indian court don send Bollywood actor Salman Khan for 5 years to prison just bicos he kill antelope.
For India, law dey inside di kontri make dem no dey kill some patikula animals and antelope na one of di animal.
Salman na one of di bigest and richest India actor and many of him fans gada for court come soport am.

Friday 6 April 2018

KOGI STATE GOFNOR 'YAHAYA BELLO' DON TALK SAY,IF PRESIDENT BUHARI SAY MAKE HIM JUMP ENTA FIRE ,HIM GO JUMP ENTA Di FIRE QUICK QUICK BICOS HIM LOVE BUHARI WELL WELL


Di gofnor of Kogi state Yahaya Bello Don yan tori pipo say, di kain love wey him get for President Buhari no get mate. 
Akordin to do gofnor, if Buhari say make him jump enta fire, him no go waste time to jump enta. 
Na wa o. 
I bin tink say fire dey burn bifor o. 

Wednesday 4 April 2018

AFTA DEM VOTE TEDDY A COMOT FOR BIG BRODA NAIJA, FANS DON DEY DONATE FIVE 5K FORAM TO MAKE UP Di N45 MILLION WEY HIM SUPPOSE WIN FOR Di HOUSE


Di love wey Teddy A fans dey show am afta dem vote am comot for di Big Broda Naija house, dey strong kakaraka like olumo rock. 
Dem don dey donate  five 5k foram so dat  dem go gadaram givam to make up for di 45 million naira wey dem go give who carry first. 
Dis kain love sha. 
Even Iyanya and Olamide don promise to carry di bobo enta studio make dem do some ogbonge miuzik togeda. 

Tuesday 3 April 2018

IN Di SPIRIT OF LOVE FOR EASTER, KISS DANIEL ENTA MUSHIN FOR LAGOS GO SHARE FOOD TO BEGGARS TO CELEBRATE EASTER



Woju singa, Kiss Daniel don show say, him agree wit wetin Jesus Christ reprezent  as he enta Mushin during di Easter selibration to share food to beggars for street.
One of him fan naim suggest am toram and true true Kiss Daniel buy di idea.

Sunday 1 April 2018

OGA COMEDY ALI BABA DON YAN SAY,Di REASON WHY HIM NO CHARGE DANGOTE MONEY FOR HIM DAUGHTER WEDDING NA BICOS DIA FRENDSHIP STRONG WELL WELL


Big name comedian Ali Baba wey be di Mc for Dangote daughta wedding, don yarn tori pipo say,him no charge Dangote even one naira for di groove.
Di reason be say,dem be very good frends.
Ali Baba also yarn say for example,if pesin like Obasanjo call am for Mc work,him no go charge am anytin bicos dem be good frends but if baba dasham money,him go take am.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...