MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 30 November 2016

PRESIDENT BARACK OBAMA OF AMERICA DON TELL PiPO WEY DEY BEG HIM WIFE MICHELLE,TO CONTEST TO BE DiA PRESIDENT SAY,NO WAY! HIM NOR GO LET HER TINK DAT KAiN THING


AMERICA presido,Barrack Obama,don tell any pesin wey dey push hin wife to bikom president of dia kontri in di future,make dem forget dat kain tinking bicos,him nor go allow her.
Obama tell Rolling Stone Magazine dis one afta Donald Trump win Hilary Clinton for di elections of pesin wey go replace him imsef as America president for January 2017.
Nor dey soprise tomorow to see him wife Michelle dey campaign to be America president one day bicos politishans sabi change mouth.
Michelle Obama wey be lawyer,go pack all her load and follow her hosband comot for White House bifor Donald Trump go take ova.

NOLLYWOOD ACTOR,OSITA IHEME a.k.a PAWPAW,POSE WIT HIM DOG YESTADAY AND TWO OF DEM NA ALMOST Di SAME HEIGHT


Small,short but mighty,Osita Iheme a.k.a pawpaw,pose wit him dog and postam for us to see.
Di one tin wey soprise pipo be say,him and di dog na almost di same height as na small tin pawpaw take tall pass di dog.
IF di dog see beta food dey wack,who knows,bifor krismas e fit don tall pass di owna.
But di truth be say,nor let yor height,color,language decide who u go be for future.
Enta street,hussle and make yor money like pawpaw.
Pipo go worship you,kings go rekognaiz you,presidents go chop for di same table wit you.
Pawpaw Wit Him Police Escort

Tuesday 29 November 2016

GODDESS OF X AND NAiJA BAD GIRL MAHEEDA SAY,SHE DEY BOW AND WONDA FOR Di KAiN BEAUTY AND FINEness WEY HER DAUGHTER CARRY COME DIS WORLD



Giv Maheeda any bad name wey you like no wahala but you nor fit call her daughta worwor girl.
Akordin to Maheeda on top Instagram,she say her daughta fineness dey soprise her too.
Oboy,if you nor gree say di babe fine die,naim be say,its aida yor eye glass na fake or yor eyeballs need propa servicing.
Dis kain babe naim dem dey fight for.

SEE Di WHITE GUY WEY SPEAK PIDGIN PASS ALL WARRI BOYS


Warri boys nor rish!
Na only GOD know how many years dis white man wey dey speak pidgin inglish like mad don stay Naija.
Somtin dey tell me say,dis guy go don scam dem Yakubu Gowon in dose days wit dis pidgin langua.
For di vidio,wen di guy say "nor mind dem,dem be Yeye pipo, i shout!
As u dey watch di guy yarnings,u go even dey pray make di vidio nor end.
Di guy finish work nor be small.

Watch di vidio for yasef for bottom hia...
no long tori.


Monday 28 November 2016

RADIO GIRL,TOKE MAKINWA WRITE ONE SiKRiT FOR INSIDE HER NEW BOOK SAY,NA GOD SAVE HER FROM Di DISEASE WEY HER FORMA HOSBAND,MAJE AYIDA CARRY GIVE HER


Popular radio prezenta,Toke Makinwa,don lick one sikrit for her new book wey she just bring out say,her forma hosband,Maje Ayida waka kurukere waka and at di end of di day,di guy givam infection wen dem do kerewa.
She say na her Doktor come tell her about di merisin wey she drink to clear di disease from her bodi.
Maje Ayida and Toke marage break up afta di bobo giv Rita her forma babe belle.
We dey wait to hia from Ayida weda wetin Toke Makinwa yarn na true as di bobo neva yarn anytin yet.

Sunday 27 November 2016

TIMAYA DON TELL TORi PIPO SAY,E NOR GET ANYTIME WEN HE PROMISE ANY GIRL MARRIAGE,NOT EVEN TO Di MAMA OF HIM TWO DAUGHTERS


Timaya don yarn say,him neva ready yet for marage and dat na wetin he tell him baby mama wen she carry her first belle.
Di egberipapa 1 of Bayelsa say dat one nor mean say he nor go marry one day but for now make marage dey one kona first.
Although Timaya say di mama of him two daughtas askam dat time say,hope say him nor go do like some miuzishans wey get shidren for diferen doormot?
Di Bayelsa bobo kon promise her say,he nor go do like dat.

SEE LEVELS! DAVIDO HANG OUT WIT CHELSEA PLAYERS AFTA DEM WIN TOTTENHAM FOR DIA LATEST MATCH


I neva stil see wetin money nor fit do for dis world.
Money dey bring konekshon,he dey open doors.
For Davido to enta Chelsea football club dressing room go snap pishor wit some playas inkluding our own Victor Moses,dat na strong konekshon.
I biliv say na Victor Moses make am posibo.
Abi he pay dem appiarance fee?
More foto...




Saturday 26 November 2016

JESU! ONE CLUB FOR CHINA DON TELL MIKEL OBI SAY, "COMOT FOR CHELSEA and join us" MAKE WE DEY PAY YOU N66 MILLION A WEEK


How you go pay one pesin 66 million naira a week?
How much u kon dey pay yorsef?
Well,if you dey wonda,na wetin one club for China,Shanghai SIPG,don yarn Mikel Obi say dem wan to dey pay am if he fit carry him bag from Chelsea and join dem.
Abeg Abeg make dem kam down!
Wich tree dem for dey plock di money?
Abeg i won know make I fit plock too.

Friday 25 November 2016

BIG PROBLEM AS FOOTBALL STAR SAMUEL ETO'O OF CAMEROON GO SPEND 10 YEARS FOR PRISON IF COURT FIND OUT SAY,TRUE TRUE Di GUY NOR DEY PAY TAX WEN HE DEY SPAIN



Di same tax ploblem wey MESSi and him papa get for Spain,naim Africa and Cameroon football star Samuel Eto'o don dey face too.
Messi and him papa sopose enta jail but e be like say dem Don free one kain,one kain.
Now di latest pesin wey fit spend 10 years for prison on top Di same mata if dem find am guilty for Spain,na Samuel Eto.
Akordin to tori wey we gada,di bobo nor dey pay him tax during di piriod wen he dey play ball for Spain.
Na wa o.
Make God nor allow pesin see wetin he nor plan for o.

Thursday 24 November 2016

BREAKING NEWS!LAGOS GOFMENT DON STOP ENVIRNMENTA SANITATION EVRi LAST SATURDAY FOR Di STATE SO DAT PIPO GO FIT HUSSLE 24HOURS BiCOS HUNGRY TOO MUCH FOR DIS KONTRi


If u dey stay inside Lagos and you dey tink say dis Saturday na environmenta sanitation,my broda make u no worry again bicos Lagos state gofment don stopam.
Akordin to Mr Steve Ayorinde wey be di komishona for information and strategy for di state,he say,for mega city like Lagos to dey loose millions from 7am to 10am evri last Saturday of di month for dis piriod wey hunga wan kill pipo,nor go work again.
He say dem go arrange some laws wey go still dey kip Lagos state klin.
He yarn all dis ones for di joinbodi executive council meeting on Wednesday.
E Don red be dat for area boys as no more Saturday morning football for street.
Sorry,Make una take heart.

BREAKING NEWS!LAGOS GOFMENT DON STOP ENVIRNMENTA SANITATION EVRi LAST SATURDAY FOR Di STATE SO DAT PIPO GrO FIT HUSSLE 24HOURS BiCOS HUNGRY TOO MUCH FOR DIS KONTRi


If u dey stay inside Lagos and you dey tink say dis Saturday na environmenta sanitation,my broda make u no worry again bicos Lagos state gofment don stopam.
Akordin to Mr Steve Ayorinde wey be di komishona for information and strategy for di state,he say,for mega city like Lagos to dey loose millions from 7am to 10am evri last Saturday of di month for dis piriod wey hunga wan kill pipo,nor go work again.
He say dem go arrange some laws wey go still dey kip Lagos state klin.
He yarn all dis ones for di joinbodi executive council meeting on Wednesday.
E Don red be dat for area boys as no more Saturday morning football for street.
Sorry,Make una take heart.

Wednesday 23 November 2016

HURRAY! POPULAR 6 YEARS OLD COMEDIAN 'EMMANUELA',DON WIN AND RECEIVE AWARD FROM Di AUSTRALIA GOVERNMENT FOR OBODO OYIBO,AS DEM DON CROWN HER PRINCESS OF COMEDY




Wetin start as play play play play,don dey put 6 years old comedian Emmanuela for map as di Australia gofment don carry two awards givam during di Afro-Australia Music and Movie Awards (AAMMA).
Di two awards wey she win na,Best new comedienne and Princess of Comedy for di show wey shelle for Sidney,Australia.
Dem also honor her Uncle Mark Angel wit one Leadership award.
Just some weeks ago for di YouTube Awards,Emmanuela and Mark Angel Comedy also win, The Best Subsaharan Channel.
Like play,like play dis smallie don dey blow dey go.
Just biliv.

Tuesday 22 November 2016

BURNA BOY: DAT BOY NEED MANAGER WEY GO DEY CONTROL HIM HOT TEMPER AS HE NEARLY DESTROY ONE GUY FACE WIT KUNG-FU WEN HE DEY PERFORM FOR STAGE


Wen dem say pesin get beta talent,na Burna boy.
But doing anyhow nor make pipo value him talent too much again.
You can imagine di Kung fu wey di bobo do to one boy face for stage wen he dey sing him jam,run my race.
Na small tin dey make fans turn back against you.
Watch di vidio of Burna boy karat wit di fan for bottom hia:


Monday 21 November 2016

RADIO PRESENTA,FREEZE OF 'COOL FM' LAGOS SAY,IF YOU BE YORUBA MAN AND YOU WAN MAKE AM FOR LIFE,MAKE YOU MARRY IGBO WOMAN


Some pipo agree wit Freeze why some say he dey yarn anyhow.
Di Cool Fm,Lagos prezenta say,him na Yoruba man but he biliv say as a yoruba man if you wan make am for life,you gasto marry Igbo woman.
Akordin to Freeze,he say,as sombodi wey get xpiriens from running shows wit both yoruba and igbo girls for univasiti,Igbo girls dey more respectful,dem neat,dem dey trit dia hosband well,dem nor dey argue and giv ploblem too much,dem biutifu and sexy pass yoruba gehs,dem get time for famili,dem sabi prepia köret wackis and dem value marage pass yoruba women.
Freeze,Dis fight wey u start so,I hope say you go fit finisham?

Sunday 20 November 2016

MORE PROBLEM AS CENTRAL BANK OF NAIJA GOVNOR GODWIN EMEFIELE,DON KNEEL DOWN DEY BEG BUHARI TO DEY COLLECT TAX ON TOP ANY PHONE CALL WEY PASS 3 MINUTES


Nor be evribodi ogogoro good for hin system.
I nor undastand why any norma human being go dey advice gofment to suffer di pipo.
Central bank of Naija Gofnor,Mr Godwin Emefiele,don kneel down dey beg Buhari make dem start to kolet tax on top phone calls wey pipo dey make.
Akordin to Emefiele,he say Naija go make N100 billion if dem dey kolet tax for any call wey you make wey pass 3 minutes.
He say,sake of say federa gofment money don dey finish,gofment need introduce dis tax for phone calls.
He yarn all dis one for one joinbodi sidon wey dem call 'Bankers Dinner' on Friday for Lagos.
Nor be him fault.
Akordin to Fela,na craze talk be dat.

Saturday 19 November 2016

E BE LIKE NIGERIA MONEY DON DEY FINISH AS BUHARI NEVA PAY Di SALARY OF FORMA PRESIDENTS-GOODLUCK,SHAGARI,OBASANJO,BABANGIDA,SHONEKAN AND ABDULSALAM SINCE JANUARY


Reports wey dey rish our garden dis morning be say,President Buhari fit resiv insults veri soon from forma presidents Goodluck Jonathan,Obasanjo,Shagari,Abdulsalam,Yakubu Gowon,Babangida and Earnest Shonekan sake of say dem neva resiv any salari since January.
 Di seketri to Naija gofment,Babachir Lawal naim yarn dis one and he say di reason why dem neva pay dem for 10 months na bicos money don finish for Nigeria.
Dis presidents sef nor dey konplain bicos di money wey dem pinch during dia time,rish to take buy anoda kontri.
I know say many pipo prayer na to see dem dey fight demsef.
We dey wait.

Friday 18 November 2016

NOBODi DON LIVE REACH 70 YEARS FOR MY FAMILY BIFOR BUT THANK GOD I DEY CELEBRATE MY 70 YEARS BIRTHDAY..NA SO FORMA VICE PRESIDENT ATIKU ABUBAKAR TALK


Na wa o.
Dis one pass yokes as Atiku Abubakar di forma vice presido to Obasanjo,don tell tori pipo say,make una join am celebrate him 70 years birthday.
He say dis birthday dey spesha bicos nobodi for him famili don rish 70 years bifor.
He yarn dis one for one joinbodi sidon wey di students of America Univasiti of Nigeria Academy and Primary Schools oganaiz foram.
Atiku go be 70 years next week on di 25 of Novemba and at 70 years di man stil get plans to rule Naija.
We dey watch.

Thursday 17 November 2016

RESPECT TO Di KING MICHAEL JACKSON,WEY DIE 7 YEARS AGO AS HIM SISTA,JANET WEY GO BORN VERi SOON DON TELL TORi PIPO SAY,SHE GO NAME HER PiKiN "MICHAEL JACKSON"


Di KING of pop miuzik,di late Michael Jackson,go smile for hin grave as Janet Jackson wey be her junior sista,don yarn tori pipo say,wen she born di pikin for dis belle wey she get for one Arab billionaire,she go name am "Michael Jackson".
Akordin to di 50 years old Janet,she wan use am rememba and selibrate her sinior broda wey die seven years ago.
Bifor Michael die,him miuzik be like sugar for pipo ear.
Nice one Janet.

Wednesday 16 November 2016

AMERICA SUPASTAR,ALICIA KEYS DON REPEAT AM AGAIN SAY,"SHE LOVE WIZKID" LIKE SHUO, AND TWO OF DEM FIT DO COLLABO VERi SOON


Alicia Keys,One of di first miuzishan afta Chris Brown and Drake put jollof stamp for Wizkid miuzik,don yarn again say,she love Wizkid miuzik like Shuo!
She yarn dis one for one joinbodi intaviu wit Ebro for Beats 1 for Apple Music.
She and her hosband fit die on top Wizkid mata as dem don show us video of wen dem dey dance to Wizzy Ojuelegba song bifor.
Akordin to Alicia Keys,wen dem ask her about dropping jam wit Starboy,she say dat kain collabo dey veri posibo.
We kross our legs dey wait bicos even Wizkid imsef don yarn on top Instagram some time ago say,collabo bitwin him and Alicia dey for pipeline.

Watch di vidio of wen Alicia Keys yarn say she love Wizzy for bottom hia...


Tuesday 15 November 2016

FORMA OBASANJO NUMBER TWO MAN 'ATIKU' SAY,WHY OBASANJO HATE AM NA BICOS HE NOR SUPPORT AM TO RULE NAIJA FOR 12 YEARS INSTEAD OF 8 YEARS WEY DEY OUR LAW BOOK


Atiku Abubakar,di forma nomba 2 man to forma presido,Olusegun Obasanjo,don yarn di reason why OBJ givam many Yeye names like koropt man,bad pesin,tiff,na bicos he nor soport Obasanjo to bicom president of Naija for life.
Di nomba of times wey di law allow  president to rule, na two times and dis two times naim be 8 years.
But akordin to Atiku,he say Obasanjo won turn am to 12 years and from 12 he go kon rule Naija foreva.
Atiku say just bicos he nor soport OBJ on top dis mata naim make am siam as bad pesin.

Monday 14 November 2016

2FACE WEY BE SAY NA 3 DIFFERENT WOMEN BORN ALL HIM 7 SHIDREN,DON TELL TORi PIPO SAY,E DEY PAIN AM SAY,DiS SHIDREN NOR COME FROM ONLY ONE WOMAN


2face Innocent Ujah Idibia a.ka fada Abraham,wey three differen women born for,don dey bite hin fingas say,chai!
E pain say nor be only one woman born di seven shidren.
Di women,Pero Adeniyi,Sumbo Ajaba and Annie macaulay join muscle togeda to born 7 pikins for 2face.
Dis life wey we dey so,dey bring plenti tins so 2face take am easy.

Sunday 13 November 2016

GOODLUCK JONATHAN PADi,DOYIN OKUPE,DON YARN SAY,Di REASON WHY HILARY CLINTON LOOSE TO DONALD TRUMP FOR AMERICA ELECTION NA BICOS,SHE WON TURN Di BIBLE UPSIDE DOWN


One of di padi to forma Presido Goodluck Jonathan Mr Doyin Okupe,don blast Hilary Clinton on top say di woman still loose for di America elections to Donald Trump.
He say wetin make Hilary loose na bicos she won turn Bible upside down.
Dat is,she won turn di book of Genesis to somtin else and also turn di book of Zachariah to di way wey go take suit her.
Na wa o,evribodi don dey form soport for Trump bicos he win.
Okupe,I hope say if dem kanso di election today,you nor go change mouth?

Saturday 12 November 2016

DEM ROB PETER TO PAY PAUL AS MTV EUROPE MUSIC AWARD ORGANIZERS,DON COLLECT BACK AWARD WEY DEM GIVE WIZKID AND GIVAM TO ALIKIBA OF TANZANIA


Mtv Europe Miuzik Award organizers don show us say na devil dem dey serve as Dem dey disgrace diasef tinking say na Wizkid and Naija dem dey disgrace.
Can u imagine say di award wey dem carry giv Wizkid as di 2016 best African miuzishan five days ago,dem Don say na mistake dem make as Dem don giv di award to Alikiba of Tanzania.
Upon all wetin Wizkid achiv for 2016.
Sombodi wey him miuzik wit Drake "one dance" be nomba one for two months for di whole world,and yet you tritam like shit?
Sombodi wey him jam with Tinnie Tempah "mamacita" enta world chart and even reach 45 for U.K. Chart,una nor rekognaiz am?
Sombodi wey Jamaicans dey shout say,'who be dis boy? afta he reliz Shabba wit Chris Brown,French Montana and Trey Songz.
Alicia Keys wey Wizkid Ojuelegba song sweet Sotay she burn Indomie wey she dey cook for her hosband Swizz Beat.
So Alikiba wey be say na only Tanzania and dia famili compound dem for know am,una carry di award givam?
Thunda go fire una for dia!
Nebuchadnezzar shidren!

Friday 11 November 2016

IT IS A LIE! MTV EUROPE AWARDS ORGANIZERS DON COLLECT BACK Di AWARD WEY DEM USE DIA HAND GIVE WIZKID AND GIVAM TO ALIKIBA OF TANZANIA! CAN U IMAGINE?


Mtv Europe Miuzik Award organizers don show us say na devil dem dey serve as Dem dey disgrace diasef tinking say na Wizkid and Naija dem dey disgrace.
Can u imagine say di award wey dem carry giv Wizkid as di 2016 best African miuzishan five days ago,dem Don say na mistake dem make as Dem don giv di award to Alikiba of Tanzania.
Upon all wetin Wizkid achiv for 2016.
Sombodi wey him miuzik wit Drake "one dance" be nomba one for two months for di whole world,and yet you tritam like shit?
Sombodi wey him jam with Tinnie Tempah "mamacita" enta world chart and even reach 45 for U.K. Chart,una nor rekognaiz am?
Sombodi wey Jamaicans dey shout say,'who be dis boy? afta he reliz Shabba wit Chris Brown,French Montana and Trey Songz.
Alicia Keys wey Wizkid Ojuelegba song sweet Sotay she burn Indomie wey she dey cook for her hosband Swizz Beat.
So Alikiba wey be say na only Tanzania and dia famili compound dem for know am,una carry di award givam?
Thunda go fire una for dia!
Nebuchadnezzar shidren!

IMAGINE FOR DIS KAIN HARD TIMES,NAIJA BAD GIRL,MAHEEDA,CARRY N500,000 TAKE DO ARMPIT OPERATION SO DAT SHE NOR GO DEY SWEAT FOR ARMPIT AGAIN



For pesin to wake up say na armpit surgery naim she won do,make you know say soup full dat pesin pot.
Naija Bad geh,Maheeda,carry 500k go do armpit operation so dat she go stop to sweat for armpit.
Dat money go do plenti tins for some pipo on top dis kondishon wey gofment put us.
Well na her money if she like she use am cook mess chop.
Oya Watch di vidio for bottom hia...


Thursday 10 November 2016

CHiNEKE! ONE REGGAE MUSICIAN KINGSLEY ENO,DON BEG GOFMENT MAKE DEM STOP TO ARREST iGBO SMOKERS BICOS HE SAY,iGBO DEY CURE PARALYSIS,TUMOR AND OTHER SICKNESS


Winning Jah
Akordin to tori wey dey reach our table,Kano state born Reggae miuzishan,Kingsley Eno Osagie a.k.a 'Winning Jah', don yarn say smoking of igbo dey cure paralysis,tumor,depression and other sickness.
Bicos of dis one,him dey beg gofment make dem stop to arrest and jail igbo smokers.
Winning Jäh dey use him new song to preach to gofment say igbo good for di bodi.
Ok o we don hear.
But wait o..since wen Kano pesin don start to bear Kingsley Eno Osagie?
Anyway,di mesage wen he yarn,we don passam to our readers.

Wednesday 9 November 2016

JEALOUSY! AFTA WIZKID WIN MTV EUROPE BEST AFRICA MIUZISHAN AWARD,TANZANIA PIPO DON DEY VEX BETA VEX AS DEM SAY,NA DiA PESiN ALIKIBA,NAiM SUPPOSE WIN Di AWARD


Tanzania pipo won start wetin dem nor go fit finish as dia boys and gehs don dey para for intanet say na dia bobo Alikiba naim sopose win di award wey Wizkid win for di MTV Europe Music awards for Rotterdam,Holland.
Wizzy win two awards.
Best Africa miuzishan and the best Worldwide miuzishan but now Tanzanians don start to konplain say na Alikiba award dem carry give Wizkid.
If you rememba last month,Wizkid and Alikiba bin get one small gbege for Kenya wen dem go play one show togeda wit Americana,Chris Brown.
Alikiba say naim popular pass Wizkid for dat area so diafor,make Wizkid first go stage biforam.
As if dat one neva rish,Tanzania pipo don start anoda round of wahala.
Una won turn una bronze to GOLD ovanite?
Make una kpror and go sidon for wia kontain una bicos di Starboy and Golden boy Wizkid,work hard for dis awards.
Ask Drake.

Tuesday 8 November 2016

AFTA 10 YEARS WEY DEM STOPAM,MULTICHOICE NIGERIA DON ANNOUNCE Di RETURN OF ''BIG BROTHER NAIJA'' FOR JANUARY 2017


Na ten years ago naim dem do di first and last Big Brother Nigeria.
But now MultiChoice Nigeria don announce say dem Don readi to do anoda fresh one for January 2017 but dis time around na Big Brother Naija dem go call am.
Akordin to dem,na both DStv and GOtv go dey showam.
Wen di Genera Manager of MultiChoice Nigeria Mr John Ugbe yarn,he yarn say,dem don re-arrange di show afta dem sorsid for di arrangement of Big Brother Africa.
Dem also announce say,di audition for Big Brother Naija go appun for Lagos for 26 and 27 of Novemba.
Di money wey dem go win sef na gboah as na $100,000 dollars naim be di money wey dem win 10 years ago.
Katung Aduwak naim be di first winna.

Monday 7 November 2016

NOLLYWOOD STAR,MERCY JOHNSON DON YARN SAY,E GET ONE TIME WEY FILM MAKERS NOR DEY GIVE HER WORK BICOS OF HER BLACK COLOUR AND BICOS SHE NOR BE YELLOW PAWPAW


Nollywood big name and actress Mercy Johnson,don yarn tori pipo say,e get one piriod wey her black kolor make many film makers nor gree dey givam Film to act.
Even for blackman land too?
Na wa o.
Abi na crime to be black again.
Dis kain tritment naim dey make some gehs dey bleach dia skin.

Sunday 6 November 2016

Di OWNER OF COVENANT UNiVASiTi,BISHOP DAVID OYEDEPO,DON TALK SAY,NA GOD DEY IN SUPPORT OF Di HIGH SCHOOL FEES OF N814,500 WEY STUDENTS DEY PAY FOR Di SCHOOL


David Oyedepo,di bishop of di living faith church worldwide,don yarn say, God soport and approve di high school fees wey students of di school dey pay.
Akordin to wetin we find out,di shidren dey pay N814,500 as school fees and for one joinbodi sidon as e take concern Shiloh 2016 wey di bishop for talk,he say Baba God dey in soport ofam.
He also yarn say,make pipo wey dey yarn bad about di plenti school fees stopam if not,God go ponish dem.
Oyedepo say na so him heal one man of strong mouth odour and di man confess say he get dat mouth odour afta he yarn against di school fees.
Hmm..na wa for wire road.

LIE OR TRUE? AT 23 YEARS,DAVIDO DON TALK SAY HIM DEY MAKE OVER N35 MILLION FOR ONE WEEK


Abeg Davido,show me di babalawo wey do di jazz for you wey you take dey get 35 milla for one week.
I won dasham money.
Many pipo go soprise say di bobo yarn say,at di age of 23 him don dey make $100,000 America dollar dat is ova 35 million naira for Nigeria money.
Diaries God o!
I nor know weda make I biliv or not.

Saturday 5 November 2016

NA TO SERVE GOD NAIM SURE PASS,NO MORE SMOKING IGBO.. AKORDIN TO SINGA,RUNTOWN


Wen God dey see him shidren dey misbehave,di tin dey always dey pain am for bodi.
And wen you decide to savam,Baba God go just dey smile.
He go say Yes! my pikin don resiv sense.
One of naija finest miuzishan,Runtown,say him don stop to smoke igbo today as he won draw closer to God.
Who nor go nor know.
Bobos,ride on.
Na di way to go be dat.

Friday 4 November 2016

YORUBA WOMAN, LOLO 1 OF WAZOBIA FM LAGOS,AFTA HER FIRST MARRIAGE CRASH DON TALK SAY,IF SHE GO RE-MARRY AT ALL AGAIN,NA IBO MAN SHE GO MARRY


Omotunde David a.k.a Lolo 1 of Wazobia fm,don talk say,na Igbo man naim she go like marry dis time around if she marry again afta her first marage crash like pack of cards.
Lolo wey don born four pikins alreadi,tell tori pipo say na Ibo man naim sure pass now for her life but she neva tell us wetin Yoruba men do her.

ONE ASHAWO BABE DON RELEASE Di NAKED FOTO OF EDO STATE PDP CHAIRMAN,DAN ORBIH,AFTA Di CHAIRMAN FAIL TO PAY HER AFTA DEM DO KEREWA



See gobe!
Dem Don turn krismas season to season of relizing naked foto and kerewa vidios.
Days afta some pipo reliz di vidio of Miss Anambra 2015,Chidinma Okeke wen she and her frend dey use cocumba do kerewa,one ashawo babe don vex reliz di naked foto of Edo state PDP chairman,Dan Orbih.
Akordin to di tori wey sama salt enta our backyard,di babe vex reliz di pishor afta di chairman fail to pay her money afta he don do kerewa finish.
Di babe say na wen di man dey snor naim she snap di foto.
You see our politishans?
Make we sidon dey wait wetin dis chairman go yarn for di one wey dey ground.

Thursday 3 November 2016

AKORDiN TO TORi WEY DEY REACH OUR TABLE,SOME WORKERS DON DEY CELEBRATE DEY WAIT,AS DEM DEY HEAR SAY,OGA BUHARi WON iNKRiZ SALARY


If we say make we take di tori wey we dey hear take sirios,naim be say naija workas go soon smile as plans and meeting don start to inkriz dia salari.
We hear say Oga Buhari don ready to listin to cry wey workas dey cry since as dollar and price of tins  don go up.
Nigeria Labour Congress (NLC) bin don dey shout say na N56k dem want make be di lowest salari for workas from di 18k wey be di minimum wage right now.
Di meetings dem Don alreadi start.
So make we sidon dey watch wetin go appun.

Wednesday 2 November 2016

E DEY PAIN ME SAY,I NOR MARRY BIFOR i COME POPULAR..NA SO KUKERE MASTER,IYANYA TALK


Iyanya don yarn tori pipo say,if him fit rewind evritin go back,he for prefer to marry bifor him dey popular.
Akordin to di kukere masta,wen you don popular,di mata go kon tie wrapa bicos now,him get miuzik and marage to tink about di same time.
Iyanya wey just sign for Mavin record,say if you say make you go church go find woman marry,you fit go end up to marry devil,if you say make you marry dancer you fit go marry trouble.
Evribodi wit wetin dey do am for bodi.

Tuesday 1 November 2016

COMEDIAN GORDONS,DON USE STYLE YAB FORMA OGA MILITANT,ASARI DOKUBO SAY,SINCE BUHARI TURN PRESIDENT,ASARI NEVA MAKE ANY NOISE LIKE SAY DEM PADLOCK HIM MOUTH


Comedian Gordons don use style yab forma Niger-Delta militant oga,Asari Dokubo say since Buhari take ova pawa from Goodluck Jonathan last year,Asari bodi kon calm and he neva yarn anytin since like say dem padlock hin mouth.
Gordons yarn dis one as joke for one show for Port Harcourt.
If you rememba bifor di elections,Asari shout welwell say,if Oga Jona nor win,naija go turn upside down.
Since Buhari finalli win,Asari sef don run hide like say dem padlock 🔐 hin mouth troway di key for lagoon.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...