MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 31 July 2017

FORMA EDO STATE GOFNOR,OSHIOMOLE SAY,EKITI STATE GOVNOR AYO FAYOSE OF PDP DEY ALWAYS YARN NONSENSE AND HE DEY TALK LIKE MADMAN


Wen two pipo wey get bad mouth start to yab demsefs,di ting go mad o.
PDP bad boy and Gofnor of Ekiti state Ayo Fayose don resiv ogbonge insult from forma fellow Gofnor Adams Oshiomole of Edo state.
Fayose always dey curse Buhari so dis one kon make Oshiomole say he dey always talk like madman.
Akordin to Oshiomole he say,Fayose remind am of one Igbo provab wey talk say,if pesin wey hin head koret go baff for local bathroom,he go hang him clothes to baff.
So one madman come carry di clothes take off.
If di man wey dey baff run out from bathroom dey porshu di madman,villagers go bigin say,two mad men.
Oshiomole say sometimes u get allow di madman go wit ya clothes instead of to join am for madness.
We dey wait bicos we know say Oshiomole must ansaram.

Sunday 30 July 2017

LOCAL RAPPER WEY HIM NAME NA 'REMINISCE' DON YARN SAY,Di TING DEY PAIN AM ENTA BONE AS HE NO GRADUATE FROM SCHOOL


Samsung ambassador and rapa, Reminisce don yarn say,graduate wey him no be still dey pain am for bodi like mad.
He kon give one ogbonge advice for pipo wey won bikom miuzishan say,if u won do miuzik,you need to sabi Di ting wella and your talent must dey pure,if not,you get face school be dat.

Saturday 29 July 2017

FOR Di FIRST TIME FOR 10 YEARS,NIGERIA NAME DON COMOT FOR Di LIST OF THE 10 TOP COUNTRIES WEY CORRUPT PASS FOR Di WORLD


Nigeria name don finalli comot for di top ten most koropt kontris for di world afta 10 years.
Bifor Na so so first position we dey carry for koropshon but for 2016 akordin to 'Transparency intanashona ' di Association wey dey rate kontris,we carry nomba 28 dis time around.
Dat is to say,di koropshon fight wey Oga Buhari dey fight dey work true true but many Naija pipo nor send dat fight as hunga won kill pipo finish.
Di kontri wey carry gibiti bizness for head pass na Somalia as dem carry first position and di kontri wey dia leaders no get time for mago mago bizness at all akordin to Transparency intanashona na,Denmark.
Nice fight Buhari but make you try do somtin about di price of garri and fish as pipo don niali run mad finish for dis kontri.

Friday 28 July 2017

EBONYI GOVNOR,DAVE UMAHI,ONE OF Di SIX GOVNORS WEY VISIT BUHARI ON WEDNESDAY FOR LONDON SAY,Di SPEED WEY BUHARI TAKE RECOVER FROM SICKNESS,NA MIRACLE


Seeing is biliving as Dave Umahi di Ebonyi state gofnor say wetin him be dey tink about Buhari sickness differen from wetin him see wen him see Buhari on Wednesday for London.
Akordin to Dave Umahi wey dey among di six gofnors wey visit Buhari for di Abuja house for London,he yarn tori pipo say,Buhari bodi don dey strong kakaraka.
He say bifor today,pipo bin feel say di president be like who sickness won kpai but wen dem siam eye to eye,dem shock wit di speed wey Buhari don take rekova.
Oda gofnors wey dey dis joinbodi visit to London na di Gofnors of Akwa Ibom state,Emmanuel Udom,Zamfara Gofnor Abdulaziz Yari,

Thursday 27 July 2017

COURT DON FINALLY FREE JOE CHINAKWE,Di MAN WEY NICKNAME HIM DOG BUHARI AFTA DEM ARRESTAM FOR AUGUST LAST YEAR



Mr Joachim Joe Iroko Chinakwe,di man wey give him dog Buhari as guy name,don finalli free from di case wey bin dey court.
Dem bin arrest Joe for August 13,2016 and since dat time Na di wahala di man dey face.
Finalli yestaday di bobo don get freedom afta Sango Ota Chief Magistrate Court say case close bicos no beta evidence against am.
Weda he go change di dog name naim we neva know.

Wednesday 26 July 2017

LAGOS STATE GOFMENT DON MARK SOME HOUSES FOR 7 BIG ESTATES WEY DEM GO BREAK BICOS DEM BUILD DIA HOUSE ON TOP GUTTER WEY WATER SUPPOSE TO DEY PASS



Lagos gofment don tell pipo wey dia house block gutter wey water suppose to pass for 7 big estates make dem carry dia load and pack live dia house bicos dem won skata dem.
Dem say if dem no pack,gofment katapila go use force destroy di buildings.
Some of di estates wey go suffer ram na Dolphin estate,Osborne Foreshore,Lekki,Osapa London,Ikota,Ogombo and Ikoyi.
Since last month,rain water wey no see gutter flow pass,don cause heavy flood and e don destroy millions upon millions of propatis.

Tuesday 25 July 2017

NEW LAW: YOU MUST NOT SPEND MORE THAN N100,000 TO MARRY ANY WOMAN FOR OTUKPA COMMUNITY,BENUE STATE ACCORDING TO DiA TRADITIONAL RULER


Akordin to many pipo,dem say dis law wey di traditional ruler of Otukpa kominiti,di headkwota of Ogbadibo local gofment area na koret law.
If u get 100k u fit enta market go look for wife instead of di plenti plenti money wey some familis dey always ask for.
Dia King,Chief Sir Sunday Ekele JP,yarn dis one on top Joy Fm,Otukpo,Benue state.
He say,punishment dey wait anybodi wey brake di law.
He say make money no stop bobos from marriage for dia kominiti and from now,nobodi must spend more dan 100k to marry for dia land.

Monday 24 July 2017

GEORGE WEAH OF LIBERIA,FORMA WORLD BEST PLAYER SAY,NOBODY FOR AFRICA NOT EVEN ABEDI PELE, GET Di KAIN SKILLS WEY J.J OKOCHA GET

George Weah of AC Milan and Okocha for PSG some years ago
Forma World best player,George Opong Weah from Liberia,don join oda forma footballers and coach like Pele of Brazil,Arsene Wenger,Mitchel Platini,Roger Milla,Samuel Eto to call Okocha baddest football magician.
Weah say him dey learn for wia Okocha skills dey but if na to score swit goals him na baba.
He say anoda Africa and Ghana skillachi,Abedi Pele get skills but nobodi like Jay Jay for Africa.

Sunday 23 July 2017

COMEDIAN 'FUNNYBONE' DON TELL DADDY SHOWKEY SORRY AFTA HE CALL AM MOSQUITO BUT WE DEY WAIT TO HEAR WEDA SHOWKEY GO FORGIVAM


Dis one no funny at all as I dey feel say comedian Funnybone go resiv slap lastlast afta he call Daddy Showkey mosquito for stage.
Last week Funnybone show take place for Lagos and wen he dey stage,he crack joke say,if dem fit call Tekno duck for intanet,naim be say Daddy Showkey na moskito.
Sombodi send di video to Showkey and Showkey kon talk on top twita say make pipo tellam weda di tin wey Funnybone talk na joke or insult and make he readi for wahala.
As Funnybone see di mata,he don rush dey beg Daddy Showkey say him dey veri sorry.
But dis Funnybone sef!
If your jokes don finish,u no fit give di microphone to pesin wey jokes stil plenti for him mouth?
I pray make di King of Ajegunle forgivam sha.
We dey watch.

Saturday 22 July 2017

AMERICA POLICE DON FORCE Naija BOYGIRL 'BOBRISKY' TO PAY OVA N30,000 TO Di BABE WEY MAKE HAIR FORAM AFTA HE REFUSE TO PAY


Dem say nor be who first reach police station must win case o.
Upon say Bobrisky run go carry police to come arrest di babe wey make hair foram for America,di policemen dem force her to pay di babe di $87 dollars wey be ova N30,000 for Naija money.
Bobrisky bin try arrest di babe bicos she do video of him dirty hair make di world see.
Bobrisky don finalli pay di 7 years old girl her money thanks to di America police pipo.

Friday 21 July 2017

FORMA BUS CONDUCTOR FOR LAGOS,MIKE OLU AKINLABI, DON FINISH FROM OBODO OYIBO UNIVERSITY TO BECOME PHD GRADUATE


Dreams dey rili come true if u work to make am appun and if God kon put hand,e don be be dat.
20 years ago akordin to Mike Olu Akinlabi,he say Na so so dream he dey dream to bikom dis and bikom dat wen he still dey hussle for Lagos as bus conductor but today God don sugar him tea as he don graduate to bikom PHD holder.
For 2006,he graduate as best student for him class,for 2010 he kolet di one wey dem dey call MSc,for 2011,he get MPhil from Univasiti of Cambridge,England and for 2016,he get PHD for Criminology and Criminal Justice from Griffith Univasiti,Australia.
Nice one and I hope say,wit dis him Criminal and Criminology degree as a forma conductor,he go come Nigeria hep us beg those agberos for Oshodi make dem stop to misbehave bicos dem can be like am tomorow.
Congratulations as dis one go give many pipo hope say,God dey alive.

Thursday 20 July 2017

BLACKFACE,FRIEND TO 2FACE B4 B4,DON TALK SAY,LIKE SAY FEDERA GOVMENT PUT LAW,MANY MUSICIANS FOR DEY PRISON BICOS NA PIPO SONGS DEM THIEF TAKE TURN SUPASTAR


Even blind man sef know say na 2face be di main pesin wey Blackface dey talk about.
You know say,two of dem get kwanta as Blackface bin attack 2face say naim miuzik he tiff take make am for life.
Dat mata no be like wetin don clear for Blackface head as he yarn say,if Federa Gofment bin put law for ground many miuzishans like 2face for dey prison by now bicos na pipo songs dem kramp take Hama.
He also yarn say na good ting say Faze dey try settle dia fight but make he no worry imsef again bicos who wear shoe naim know wia e dey pain am.
Blackface say naim write di songs no be Faze so diafor,he no go fit undastand di pains.
All dis Face boys,Abeg make una try settle dis una wahala,e don tire us.

Wednesday 19 July 2017

SALES GIRL FOR SHOPRITE,LAGOS DON THIEF N553 MILLION NAIRA AS SHE GET HER OWN PERSONA POS MACHINE WEY CUSTOMERS DEY PAY ENTA


Na only God fit save pesin bizness if not,devil go send him agents to run down ya market.
Just one month afta dem employ Mariam Mufutau for Shoprite Lekki,Lagos,di babe don use her own POS machine wey she dey carry Go work make customers use,take tiff  N553,956,000 million.
Dem don alreadi report di case for Ilasan division police station for Lekki,Eti Osa and as you dey read dis tori di mata dey court alreadi.
Bicos her pipo neva get N300,000 to bail her,Mariam sef dey kirikiri prison until July 28 wey she go appia for court again as she don alreadi yarn bifor say she no do anytin bad.
We go bring una more tori as e drop konsigning dis mata.

Tuesday 18 July 2017

TONTO DIKEH DON AGREE TO CLEAN TATTOOS FROM HER BODY AFTA HER FAN ADVICE HER TO CLEAN Di LUCIFER TATTOO WEY SHE DRAW




One dog face tattoo and anoda one wey dey her back don make one Tonto Dikeh fan advise her to remove di nonsense.
Akordin to di fan,he say di tattoo get lucifer spirit and e fit make men wey get di fear of God for bodi see her dey run.
Di bobo also yarn say,if na true say she don dey born again,e good make she remove dem.
Tonto Dikeh reply di bobo say yes,she dey do somtin about am and she go klinam.

Monday 17 July 2017

IF U NO WANT WAHALA WEY CARRY THUNDER,FORMA PRESIDO OBASANJO,DON GIVE WARNING SAY,MAKE YOU NO DO MISTAKE CALL AM ''MATHEW'' Di NAME WEY HIM PAPA AND MAMA GIVAM


Forma sivilian and khaki president of Naija,Olushegun Obasanjo a.k.a OBJ,don yarn tori pipo say,if you want make him use hin solja koboko for ya bodi,make u just try call am Mathew.
Dat name Mathew na di kristian name wey him papa and mama givam wen dem born am but he drop di name wen he bigin form big boy.
He say Mathew mean tax collector so diafor,dat name dey do am one kain for bodi.
I no undastand dis our forma khaki presido at all o.
Nor be tax payers money wey all of dem joinbodi collect,naim dem take make demsef rich?
Na wa o.

Sunday 16 July 2017

IF U NO WANT WAHALA WEY CARRY THUNDER,FORMA PRESIDO OBASANJO,DON GIVE WARNING SAY,MAKE YOU NO DO MISTAKE CALL AM ''MATHEW'' Di NAME WEY HIM PAPA AND MAMA GIVAM


Forma sivilian and khaki president of Naija,Olushegun Obasanjo a.k.a OBJ,don yarn tori pipo say,if you want make him use hin solja koboko for ya bodi,make u just try call am Mathew.
Dat name Mathew na di kristian name wey him papa and mama givam wen dem born am but he drop di name wen he bigin form big boy.
He say Mathew mean tax collector so diafor,dat name dey do am one kain for bodi.
I no undastand dis our forma khaki presido at all o.
Nor be tax payers money wey all of dem joinbodi collect,naim dem take make demsef rich?
Na wa o.

BEGGARS GO SOON START TO PAY TAX ACCORDING TO MINISTA OF FINANCE,KEMI ADEOSUN


E don red o.
Instead of Federa gofment to tink how dem go take comot beggars for street,dia plan na to make sure dem go dey pay tax veri soon.
If u be beggar and you dey read dis tori,market won cast be dat o.
Akordin to minista of finance,Kemi Adeosun,dem go soon dey collect tax for beggars hands too.
She yarn dis one for one joinbodi lesson for PWC Bizness School,Lagos.
Wen di time rish,make she try follow di tax collectors enta road so dat anytin wey go appun,she go siam wit her eyes too.

Saturday 15 July 2017

BSC GRADUATES FROM UNIVASITI AND HND GRADUATES FROM POLYTEKNIC,GO DEY RECEIVE EQUAL SALARY NOW AS FEDERA GOVMENT DON APPROVE AM


Weda na politeknik digri you get or na univasiti digri you get,Federa Gofment of Naija don yarn say,na di same salary una go dey collect now.
BSC or HND o,all na di same salary,No more wayo.
Akordin to one pesin wey I follow yarn di mata today,he say na di only good ting wey dis gofment don do be dat.
Nor be to talk am,make we see weda e go work.

Friday 14 July 2017

END OF Di ROAD AS ETISALAT NIGERIA DON CHANGE DIA NAME


Afta di main name Ownas pull out of Etisalat for Nigeria,dem don finalli change dia name to 9mobile.
Earlier dis week,dem give Etisalat Nigeria time to change dia name and true true dem no waste time to givam new name.
For some time now,dem bin get ploblem and dia debt don inkriz like mad bifor di Arab guys run live di market for dia Naija bizness patnas.

Thursday 13 July 2017

FINALLY,WIZ KHALIFA SONG 'SEE YOU AGAIN' DON BEAT 'GANGNAM STYLE' AS VIDEO WEY PIPO DON WATCH PASS FOR Di WORLD ON TOP YOUTUBE AS DEM DON WATCHAM 2.9 BILLION TIMES



Live record for pipo wey get record.
Di miuzik video wey pipo don watch pass on top YouTube bifor today na,Gangnam style wey South Korea Psy sing 4 years ago.
But as u dey read dis tori,Wiz Khalifa song 'See you again' wey he joinbodi sing wit Charlie Puth,don beat dat record as dem don watch di video 2.9 billion times to best Gangnam style wey dey 2.8 billion.

Wednesday 12 July 2017

TRADITIONAL RULERS FOR IMO STATE MUST SPEAK IGBO LANGUAGE FOR ALL PUBLIC MEETINGS AS DIA GOVNOR,ROCHAS,DON WARN DEM SAY HE NO WAN HEAR ENGLISH FOR DIA MOUTH


Punishment dey for any king or traditional ruler fir Imo state wey nor speak Igbo language giv him pipo during any meeting.
Dat na wetin Imo state gofnor Rochas Okorocha don tell all of dem for dat state.
Di Chief press seketri for di state,Mr Sam Onwuemeodo,naim yarn dis one from di mouth of di Gofnor during wen he dey give satifikate to di new 19 rulers for di state.

Tuesday 11 July 2017

SOUTH AFRICA TOP MUSICIAN,CASSPER NYOVEST SAY HIM RESPECT WIZKID AS E DON PUT NAIJA MUSIC FOR WORLD MAP AND HE PRAY SAY ONE DAY DIA MUSIC GO TRAVEL FAR TOO



Dem say pipo no dey value prophet for him own area.
If u dey among pipo wey no value Wizkid waka wit Naija miuzik to di outside world,South Africa rappa,Cassper Nyovest dey beg u to change ya mind.
Di top Sauti rapa say him get lot of respect for Wizkid for wetin him don do wit Naija miuzik for obodo oyibo and him dey dream to see dat day wey South Africa hip hop miuzik go travel enta di world.

Monday 10 July 2017

KEREWA LOVERS,BE KIAFU BICOS GONORIA DEY VERY STUBBORN TO CURE NAWADAYS-DAT NA WETIN 'W.H.O' Di ORGANIZATION OF STRONG AND HEALTHY BODi TALK


W.H.O di joinbodi association for kakaraka bodi don dey warn kerewa lovers to dey kiafu bicos gonoria don dey turn somtin else.
Akordin to di tori,gonoria don dey veri stubborn to cure nawadays so make u shine ya eye welwell and dey kiafu.
Hmm,na wa o.
Di way wey I dey see di mata,e be like say ogbu ogbu don shook eye enta di mata o.
Ogbu ogbu abeg,let my pipo go.

Sunday 9 July 2017

NA ABACHA GIVE POISON INJECTION TO SHEHU YAR'ADUA AND MKO ABIOLA WEY KILL DEM ACCORDING TO OBASANJO


Di ogbonge tori wey play enta our tori room dis morning be say,na forma khaki and Ogakpatakpata for Aso Rock,Sani Abacha,naim giv injection wit poison wey kill Shehu Yar'Adua and MKO Abiola akordin to Obasanjo.
Obasanjo say na di three of dem Abacha plan to kill but na God save am.
Abacha bin put dem for prison and akordin to OBJ,he say sombodi from Abacha camp naim tellam say di late Abacha don swear say none of dem go come out from prison alive but hin own case diferent.

Saturday 8 July 2017

HARRYSONG NO SABI ROAD TO OBODO OYIBO AND HE NO GET VISA FOR HIM PASSPORT BIFOR WE HELP AM,KCEE DON YAB HARRYSONG AGAIN


Two best frends bifor,Kcee and Harrysong don dey blast demsefs again as dia kworel don take anoda turn.
Afta Harrysong live Five star music,he go back afta Daddy Showkey settle dia kworel.
But afta sometime,dem don finally break up again.
Right now,dia fight don kontiniu again as  Kcee don blast Harrysong say na dem givam first visa to travel go abroad bicos dem want to tritam like king since they demsef dey live like king.
But today,Harrysong dey bite if fingers wey Feed am akordin to Kcee.
Just yestaday hia,Harrysong reliz one jaminjamin wey him call 'Arabanko' and for inside dis song,he blast shege comot for Harrysong head.

Friday 7 July 2017

SAD NEWS AS SUPER EAGLES NUMBER ONE GOALKEEPER,CARL IKEME,DON GET ONE BIG SICKNESS "LEUKEMIA" WEY FIT STOPAM FROM PLAYING FOOTBALL AGAIN




Dis one na veri sad news as Super Eagles nomba one goalkeeper Carl Ikeme akordin to him club don get one wicked sickness "Leukemia" for him bodi afta dem do test foram.
Leukemia na one useless sickness wey dey affect di white blood cells for bodi and Na dis cells sopose to dey help dey fight against disease.
Him club Wolves na dem bring dis news out yestaday and di ting pain dem welwell as dem say dem go stand gidigba for Carl back for dis tough piriod for him life.
Except God do him miracle as usual if not,Dis sickness fit make am no play ball again.
As you dey read dis tori,Abeg pray to God to heal am.
Notin dey inposibo for God to do.

Thursday 6 July 2017

"YOU GET FROG VOICE",DAT NA WETIN WIZKID DON TELL DAVIDO AS DIA FIGHT OF WHO TOO MUCH PASS NO LOOK LIKE WETIN GO STOP SOON


Davido and Wizkid don use intanet take do playground as na so so insult dem dey insult demsef now.
If u rememba, Wizzy tell Davido say him na local champion bicos he try bizness for Yankee and e no favoram.
Davido now kon use tru Olamide jam wey dem joinbodi do take ansa Wizkid say "Wit Yankee passport dem say we local,you beta catch up I go see u later".
Wizkid do hear wetin Davido yarn for di song and he don attack am back.
Akordin to Wizzy he say,"Make pipo rememba say Yankee passport no be baba blue bicos he no dey cure frog voice".
E clear say Wizkid don blast Davido back say he get frog voice.
Trust Davido,di bobo go don dey tink Wetin he go yab hin forma frend wit.
Wen dis dia fight go stop sef?

Wednesday 5 July 2017

LILLE FOOTBALL CLUB,DON SACK FORMA SUPER EAGLES CAPTAIN AND GOALKEEPER VINCENT ENYEAMA AND 10 OTHER PLAYERS AND NA THRU TEXT MESSAGE DEM TAKE LET DEM KNOW


Lille football club for France,don sack Vincent Enyeama and 10 oda players afta dem send dem text message just to let dem now.
Dis one mean say,dem no want dem again for di club for dis new season wey dey come so.
Di new coach,Marcelo Bielsa naim sack dem.
Enyeama just sign new kontrat wey sopose kipam for di club till 2019.
Just last month hia,Enyeama welkom Koffi from Burkina Faso,di new goalkeeper wey Lille just sign.

Tuesday 4 July 2017

SINGA,'RUNTOWN' DON YARN SAY NA BIG LIE IF ANYBODi TELL YOU SAY NAIM SELL DAT SONG WEY DEM DEY CALL 'AYE' TO DAVIDO


Mad over you singa,Runtown,don deny say naim sell dat Aye song to Davido.
Rumors don dey fly for evriwia say he sell di song make Davido for joinbodi witam sing Galardo some years ago but di bobo say Notin like dat appun.
He say he nor dey sell miuzik,hin own na just to write him song.
He say if na true say he sell dat song give Davido,wot of di oda ogbonge songs wey Davido don sing?

Monday 3 July 2017

DOYIN OKUPE,FORMA SINIOR ADVISER TO GOODLUCK JONATHAN,DON COMOT FOR PDP AS HE SAY PDP NO GET DAT KAIN SWAGA WEY FIT MAKE DEM STAND GIDIGBA AGAIN


Forma sinior advisa to Goodluck Jonathan,Doyin Okupe,don resign from PDP wit imidiate effect.
He say PDP no dey united again as dem don cast.
Akordin to Okupe,he yarn tori pipo say him no fit kontiniu wit PDP again bicos dia mata don tire ram and di reason why he nor write letter be say,since PDP nor dey united again,him no know who him go address di letter to.

Sunday 2 July 2017

COMEDIAN,'LEPACIOUS BOSE' DON TELL TORi PIPO SAY,WEN SHE FAT SHE DEY MAKE BETA MONEY FOR COMEDY BUT NOW WEY SHE DON SLIM DOWN,Di BIZNESS GET AS E BE


One of Naija top female komedian,Lepacious Bose,don yarn tori pipo say,wen she be orobo she bin dey make money wen she dey stage dey make pipo laff but now wey she don slim down,bizness don be as e get.
She say dat time wen she fat,e easy foram to dey crack joke about her fat bodi but now,di mata don tie wrapa.
Lepacious na simple sontin.
Make sure ya jokes funny weda na about fat pipo or slim pipo and pipo go still take u sirios.

Saturday 1 July 2017

SINGA WAJE,WEY BLOW AFTA SHE SING 'DO ME i DO YOU' WITH PSQUARE,DON TALK SAY,BIFOR SHE TURN MUSICIAN,SHE BE CHIN CHIN SELLER


Dreams dey come true Na so dem talk am.
Bifor Waje turn one of Di big miuzishan for Naija,she be chin chin seller.
She say she and her frend Ijeoma bin dey make chin chin dey sell for court yard for Onitsha dat year.
She yarn tori pipo say,dem dey sell small can like N600 dat time bifor God kon later change her stori.
Akordin to Waje,she say di first money wey dem pay her for miuzik na 500 hundred and di first big money wey she resiv na 300,000 tazan and di money niali make her run mad bicos she no biliv her eyes.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...