MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 30 September 2018

YORUBA ACTRESS BUKKY OLAOLUWAKIITAN DON TALK SAY,WEN SHE LOVE SHE DEY LOVE LIKE FOOL


I no dey surprise say Yoruba actress Bulky Olaolukiitan yarn say,if she love she dey love like fool.
Love itsef na fool to some pipo.
She say wen she dey in love she dey always like to please her bobo and displease hersef and at di end of di day,na she go kon suffer evritin wen dem break up.

Saturday 29 September 2018

NAFDAC DON ADVICE NIGERIANS MAKE DEM TRY TO DEY AVOID ROTTEN TOMATOES IF DEM NO WON CATCH CANCER WEY BE VERi BIG SICKNESS



Di National Agency for Food Administration and Control,NAFDAC,don advise all Nigerians make dem dey kiafu of rotten tomatoes.
One of dis deputi direktor Christiana Essenwa naim yarn dis one for Onitsha.
She say,rotten tomatoes get micro organism wey fit give cancer so fiafor,make we try dey avoid am.
I knocked say my frends wey go dey read dis one now go vex talk say,notin dey appun,disease no dey kill Blackman.

Thursday 27 September 2018

NO BE NEWS AGAIN SAY OBASANJO DEY TALK SAY "BUHARI MUST GO" BUT Di NEWS NOW BE SAY,OBASANJO PIKIN 'OLUJONWO' SAY "BUHARI MUST STAY TILL 2023"


Forma presido Olusegun Obasanjo pikin Abraham Olujonwo Obasanjo don throw him support behind Buhari to win di 2019 election even tho him know say him papa don widraw him support from Buhari. If you dey follow up,you go don know by now say Obasanjo don blast Buhari tire say,evritin don kpafuka since Buhari come back to pawa for 2015. Papa and pikin dey different camps. E be like say dis drama go sweet

Wednesday 26 September 2018

STRIKE NOTICE: THE NIGERIA LABOUR CONGRESS NLC,DON FIX TOMORROW AS Di DAY WEY STRIKE GO START FOR Di FULL NAIJA SINCE GOVMENT REFUSE TO INKRiZ WORKERS SALARY


Di Nigeria Labour Congress NLC don finish arrangement to go on strike tomorrow if gofment still refiuz to do something about workas salary wey oyibo call minimum wage.
Tomorrow naim go make am exatli two weeks wey NLC don give gofment strike warning if dem no shook mouth put for di mata.



Tuesday 25 September 2018

ONE JAMAICA MAN ON TOP INSTAGRAM DON YARN TORi PIPO SAY,E BETA MAKE DEM PUTAM FOR INSIDE PRISON FOR LIFE INSTEAD OF AM TO EAT AMALA


I no biliv say na good ting to disrespect anoda man culture as one Jamaica man on top Instagram just insult Yoruba pipo most popular food,Amala.
Di Jamaican bobo for di video wey don dey enta evriwia yarn say,instead of am to eat amala,e beta make he spend di rest of him life for prison.
He say for eye,Amala look like shiit.
Di guy also yarn say,from di way wey amala look, na di type of food wey babe go cook for her guy and her guy no go like go di girl house next time.


Monday 24 September 2018

SAD,SAD,SAD NEWS! THREE MONTHS AFTA REGGAE LEGEND 'RASKIMONO' DIE,HIM WIFE 'EFEMENA' DON DIE TOO



If you dey follow up,you go know say Reggae legend and Under Pressure singa Raskimono die three months ago at di age of 60 and dem bury am last month.
Anoda sad news don hit dia famili as him wife 'Efemena Okedi' die on di 23rd of September, 2018.
Dis news go put di famili for unda pressure as we here say,she die of high blood pressure.
Dis tori no swit for ear at all.
May her soul Rest in Peace... Amen.

Sunday 23 September 2018

ATIKU GO BE PRESIDENT FOR 2019 WEDA OBASANJO SUPPORT AM OR NOT ACCORDING TO 'TAHIR SHEHU' Di ADAMAWA STATE PDP CHAIRMAN


Some days ago,forma sivilian and khaki president Olusegun Obasanjo yarn tori pipo say,if him support Abubakar Atiku to bikom president, even God no go forgivam.
Now Adamawa PDP chpridon.,Tahir Shehu, don shook mouth put as he yarn say,Obasanjo don forget say,Atiku naim hepam if not,Abacha for kilam for prison.
Tahir Shehu also yarn say,since Obasanjo no be God,weda he soport Atiku or not, Atiku go bikom naija president come 2019.

Saturday 22 September 2018

BEN BRUCE AND ATIKU DON GIVE JOB AND 500K TO Di DELTA GIRL WEY HER PIDGIN ENGLISH SWEET DIE DURING WEN SHE DEY YARN TORi PIPO HOW FLOOD TAKE KILL HER 300 FOWLS



Wen God won bless you nobody fit stopam as pidgin inglish don open way for Kate Dekpe afta she yarn tori pipo how rain and flood take kill her ova 300 fowls for Oviri Agbaro,Delta state.
Reno Omokri,forma Goodluck Jonathan employi naim post di video of di girl as he praise her pidgin inglish langua say e swit wewell no be small.
Imidiatli afta di video, Senator Ben Bruce say him don redi job for di girl for silverbird anytime she redi.
Abubakar Atiku wey dey fight to be naija president don also come out to dash her 500,000 thousand naira.
God favour don arrive di babe doormot like magic or miracle depending on how u siam.
From disappointment to blessings,dis one loud.

Thursday 20 September 2018

FUNNY ACTOR MR IBU,DON YARN TORi PIPO SAY,HIM ENEMIES DEY TRY TO SPOIL HIM NAME AFTA ONE BABE YARN LAST WEEK SAY,IBU NA CORRECT KEREWA MASTER



Funny Nollywood actor John Okafor a.k.a Mr Ibu don yarn finalli afta dat babe yarn some days ago on top social media say,Mr Ibuna gentle lova and she enjoy Ibu kerewa lessons wen two of dem do di ting.
Mr Ibu don come out dey yarn say,e don tay wey pipo dey try skata him name no be today.
So diafor,di girl na one of dem.

Wednesday 19 September 2018

FEDERA GOFMENT SAY,DEM DON COMOT 10 MILLION NIGERIANS FROM POVERTY ACCORDING TO MINISTA OF BUDGET PLANNING 'UDO UDOMA'


Dem don start again.
Wish one be federal gofment don comot povati from 10 million Nigerians head?
Na di words of Budget and National Planning Minista,Udoma Udo Udoma and di kain yarns don shock many Nigerians wey I follow yarn for street.
One guy even say,di minista dey on codeine diet bicos IMF say povati won kill Nigerians of resent.
Nor be only dem don yarn konsigning naija ekonomi.
Even Brooking institution wey dey obodo oyibo also yarn afta dia investigation say,naija don ovatake India as di kontri wey get highest nomba of pipo wey strong povati lock down but now federa gofment dey yarn anoda ting.
Brooking say over 87 millions Nigerians naim povati use blanket kova.

Tuesday 18 September 2018

IF YOU KNOW ANYBODY WEY DEY WRITE DIS YEAR 'WAEC EXAM',TELAM SAY,WAEC DON POSTPONE ENGLISH LANGUAGE EXAM GO SEPTEMBA 29



West Africa Examination Council WAEC DON postpone English language exam from Septemba 22 to Septemba 29.
Dem yarn dis one on top dia twita page but dem no give reason why dem postpone am.
Some pipo dey see di postponement say na bicos of di Osun state gofnorship election wey go appun on Septemba 22.
Woteva di reason be,di tin be say,dem don postpone am.


Monday 17 September 2018

GOVNOR WIKE OF RIVER STATE DON BLAME HIM FORMA OGA ROTIMI AMEACHI AS Di CAUSE OF Di PROBLEM WEY APC DEY FACE FOR Di STATE


APC problems for River state don dey cause more kasala for di mind of di pipo wey dey di state.
Afta Rotimi Ameachi say na Gofnor Nyesom Wike dey sponsor di gbege wey Rivers state APC, Wike don fire back say,na na Ameachi be dia problem nor be him.
He yarn dis one thru him Komishona for information Emma Okah and he say na Ameachi dey treat him membas like him slave.

Sunday 16 September 2018

TANZANIA ACTRESS 'WEMA SEPATU' DON YARN TORi PIPO SAY,Di KIND MAN WEY SHE WANT NA MAN WEY GO DEY BEAT HER LIKE MIKE TYSON FOR HOUSE



Wema Sepatu,big name actress for Tanzania don yarn tori pipo say,na man wey go dey beat her like Mike Tyson she dey find.
Dis one weak me o.
Naim be say dis kain woman go do evritin wey go make her husband always dey vex.
She ready to burn soup steadi so dat di husband go vex beat her.
Dem be say to dey beat woman no good na.
Na wa o.

Saturday 15 September 2018

FELA DAUGHTER 'MOTUNRAYO' DON TALK SAY,SHE HATE DAVIDO AND SHE ALSO HATE Di TYPE OF MEANINGLESS MUSIC WEY HE DEY SING LIKE SHIT


 O boy,dis one loud o.
Fela daughta Motunrayo Anikulapo Kuti don yarn tori pipo say,she hate Davido like shit.
She say no be only dat one o,she say she hate di miuzik too bicos dem no dey make sense.
Akordin to Motunrayo she say,Davido dey always sing about money, love and girls and dat no be di type miuzik wey she like.
She say Davido don try to disrespect her one time for her papa shrine afta he sidon for her chair but she no waste time to telam say dem no be mate make Davido stand up.
She say Davido true true, stand up but di truth be say she no like di boy karata.

Friday 14 September 2018

BREAKING NEWS!!!TORi WEY DEY REACH OUR NEWS YARD BE SAY,KEMI ADEOSUN Di FINANCE MINISTA,DON RESIGN


Di minista of finance Kemi Adeosun don resign from her position.
She hersef neva confam am but dis tori dey fly from left,right and center say,she don comot bodi  from di Buhari gofment.
Argument bin dey ova her NYSC satifikate as some tori pipo bin talk say,na fake satifikate she get.
We go bring una more tori as e take concern dis mata as e dey drop.

Thursday 13 September 2018

COMEDIENNE 'LEPACIOUS BOSE' DON PRAISE GHANA PIPO SAY DEM NO DEY BLEACH LIKE NAIJA PIPO WEY CARRY BLEACHING FOR HEAD LIKE DANDRUFF


Woman comedian 'Lepacious Bose' don yab Nigeria pipo wey carry bleaching for head like gala.
She say anytime wey she travel go Ghana,she dey dey kampe and feel at home bicos she and dem dey black togeda.
But she say if she dey naija,diferen diferen colors of human being naim she dey see.
Some yellow,some green,some color na blue but e no be like dat for Ghana as dem no get time to bleach dia skin.

Wednesday 12 September 2018

WIZKID BABY MAMA 'BINTA' FOR AMERICA DON TALK SAY,HE NO DEY TAKE CARE OF DIA PIKIN AND WIZKID FAMILY BEG HER MAKE SHE NO CARRY AM GO COURT IF NOT,WIZKID FOR CRY BLOOD



Binta Diallo,di mama to Wizkid second son 'Ayo' don yarn say,di Ojuelegba star na yeye papa to dia son.
She say di only ting wey make am neva carry Wizkid go court make dem kuku settle di mata na bicos,Wizkid famili beg her make she no do am if not,Wizkid for don cry blood tire.
If she sue Wizkid ova di child support mata,na big ploblem for America as dem go almost finish Wizzy money just to dey take care of di son.
America laws different from Nnewi laws or Sokoto laws.
Dia laws fit put big hole for your pocket ova some kain problem.

Tuesday 11 September 2018

OBA OF BENIN DON GIVE ORDER MAKE DEM DESTROY IGBEKHUEN VILLAGE SHRINE AND MARKET BICOS DEM NO GET APPROVAL FROM PALACE BIFOR DEM BUILD DEM


Pawa good o.
Ogue-Odion di shrine of Igbekhuen village shrine for Orhionwon local govment area for Edo state don hear ram as di Oba of Benin don say make dem destroy di shrine and dia market bicos palace no approve vam bifor dem build am.
He yarn dis one for di palace wen him dey settle all di wahala and cases wry dem carry come palace.
For di Igbekhuen judgement, di Oba say make dem destroy di shrine afta elders of di shrine report say, some pipo build second shrine for di village for no reason.

Monday 10 September 2018

LIBYA COACH DON TELL NIGERIA 'SORRY' AFTA HE TALK SAY,NA JUJU WE DEY USE WIN MATCH


Libya coach Adel Amrouche,don dey beg naija make dem no vex say him yarn di whole world say na juju we dey use win our football matches.
He yarn dis one for South Africa afta Libya play zero zero wit di Bafana Bafana for di nations cup qualifier.
Di coach dey ansa tori pipo queshons base on di match wey dem go come play wit Nigeria next month.
Adel Amrouche don write on top him twita page say make we no vex say na joke him dey joke wen he say,Nigeria biliv in juju but Libya biliv in God.

Sunday 9 September 2018

RASAQ OLAYIWOLA a.k.a OJOPAGOGO DON CRY OUT SAY,HIM DON TIRE TO DEY ACT SO SO BABALAWO ROLE FOR INSIDE FILM





Anytin wey dey put food for your table,no use am joke at all,at all.
Babalawo work for inside Yoruba film don dey put food for di table of Rasaq Olayiwola for plenti years now.
But Rasaq a.k.a Ojopagogo don yarn say him don tire to dey act di Babalawo part for movie evri time.
He say make film producers try dey givam oda roles as dem no born am wit Babalawo work.
Wen tori pipo askam which role him go like apart from di Babalawo role.
Rasaq kon yarn say,if dem givam badboy part all dis krimina role, dat kain role wey him go dey give pipo wahala for inside film,him go like am.
Oga Ojopagogo,i no see any difference bitwin Babalawo and badboy roles.

Friday 7 September 2018

HARRYSONG DON PUT FEAR FOR HIM FANS MIND AFTA HE YARN SAY,MAKE ANYBODY NO CRY IF HE DIE


On top Instagram wey lots of pipo dey show dis lifestyle, Harrysong don yarn somtin wey put fear for pipo mind for him Instagram page.
Di reggae blues singa yarn say,if him die make anybodi no cry foram.
Di last pesin wey talk and sing about dis kain tin for him miuzik na Dagrin and true true,di boy later die for accident.
Although Harrysong manager don confam say di bobo dey pass thru some difficult moments.
Many of Harry friends, fans and famili membas don dey call am to pray witam base on dis one.

Thursday 6 September 2018

SOWORE DON YARN SAY,IF HE BECOME PRESIDENT FOR 2019,MARIJUANA FARMERS GO ENJOY BICOS NIGERIA GO DEY MAKE MILLIONS FROM SELLING IGBO (MARIJUANA) TO FOREIGN COUNTRIES


I biliv say Smokers of igbo and igbo farmers don get who dem go vote for next year for di election of who go be president for 2019 for Naija.
Sahara reporters Oga,Omoyele Sowore don yarn say if he win di 2019 election,di selling of igbo or marijuana go be one of di bizness wey Nigeria go dey make millions from.
If you dey follow up you go sopose know say,dem dey use igbo as drugs and merisin to cure some kain sickness.
Now Sowore don come out to yarn say,no need for NDLEA to dey arrest di igbo farmers bicos no be bad bizness.

Wednesday 5 September 2018

MAMA OF 3 CHILDREN 'RONKE OLANREWAJU' DON YARN SAY,IF Di OJA-OBA CUSTOMARY COURT FOR MAPO,OYO STATE NO SCATTA SHE AND HER HUSBAND MARRIAGE,SHE GO POISON Di HUSBAND


No be small drama for Oja-Oba customary court for Mapo,Ibadan Oyo state as di mother of three pikin Ronke Olanrewaju don threaten to poison di husband for house if di court no stop dis marriage.
Akordin to Ronke her husband Sunday Olanrewaju don turn her to punching bag for house as he dey beat craze comot for her bodi evri time.
She say if di husband just siam wit man customers for her bizness,na beating she dey resiv bicos he say she dey do something wit dem.
She say no be di husband only sin be dat o,as he also dey beat her mama like small pikin.
Now she want make court skata di marriage if not, she go poison di man for house.
Di husband don dey beg court say make dem no do like dat bicos he love him wlove and she be like mama toram.
President of di court Chief Henry Agbaje don fix September 18 for judgement and he say room still dey for settlement.

Monday 3 September 2018

AFTA HE RULE NAIJA FOR 6 YEARS,FORMA PRESIDO 'GOODLUCK JONATHAN' DON TALK SAY,HIM READY TO GO BACK TO HIM TEACHER WORK IF HE GET Di JOB



Forma naija Presido Goodluck Ebele Jonathan,don yarn tori pipo say,if any school espeshali The Ignatius Ajuru Univasiti of Education, Port Harcourt givam work he go like am.
Uncle Jona say,him readi to go back to classroom.
He yarn dis one during Ignatius Ajuru Nomba 35 and 36 convocation serimoni.
He also thank dem for di 'icon of democracy' award wey dem givam for di ground.

Sunday 2 September 2018

PAWPAW FRIEND 'CHINEDU IKEDIEZE' a.k.a 'AKI' DON YARN SAY,HIM NA BIG BASKETBALL FAN BUT HIM SHORTNESS NO ALLOW AM PLAY Di GAME



Evribodi get dat one ting wey dem dey regret say dem no fit do or fit dey do.
To some pipo e fit be say dem rili like to bikom doctor but jamb no gree,why some go say,e pain dem say dem no come from Dangote famili.
Nollywood star,Chinedu Ikedieze a.k.a 'Aki' don talk dat one ting wey dey pain am enta bone.
He say him na big basketball fan but bicos him no tall him no fit follow up wit him basketball dream.
He say bicos of him height dia is nothing he fit do about am.
Sorry bros,God get reason for evritin.

Saturday 1 September 2018

COMEDIAN 'SEYI LAW' DON YARN SAY,AFTA HE BUY HIM HOUSE NA ONLY N63,000 KON REMAIN FOR HIM BANK ACCOUNT


Seyi Law,one of di comedians wey dey crack pipo ribs wit jokes,don tell tori pipo say,na N63k remain for him account balance afta he buy him house.
He yarn dis one afta one tori pesin say make police investigate how he take make money buy house of millions.
He say,him shows dey givam money so diafor,no need to dey tink about dis and dat.
Seyi also say,since he bigin him komedi karia, no politician don eva dasham money.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...