MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 24 June 2019

VICE PRESIDO YEMI OSINBAJO DON YARN TORi PIPO SAY,DIA IS NO WAY NAIJA NO GO BETA BICOS NAIJA PIPO NO DEY LAZY,DEM DEY VERY HARDWORKING


Vice Presido Yemi Osinbajo wey dey on a 4 day visit to America go see dia own Vice Presido Mr Mike Pence,don yarn tori pipo say,dia is no way wey tings no go beta for Naija as a kontri onto say Nigerians dey veri veri hardworking.
Dis na opposite of wetin Presido Muhammad's Buhari yarn about Naija pipo.
If you sabi rememba tings,Oga Buhari yarn say Naija youths dey lazy wen he visit London last year April.

Sunday 26 May 2019

FOR EBONYI,ONE MAN DON PUT FUEL FOR BODY BURN HIMSELF ONTO SAY HIM NO FIT DEY FEED IMSEF AGAIN


Dem don rush one man go hospital for tritment afta he turn fuel for bodi and light matches take burn imsef onto say pepper no rest and to feed imsef na big ploblem toram.
Dis one appun for corner of one classroom block for Saint Patrick's Primary School Kpirikpiri Abakaliki,Ebonyi state.
Bifor dat day dem say he don dey complain give him neighbors say life don tire ram since even to see bread and beans chop don turn World Cup.
Di way wey pipo take dey frustrate for dis kontri nawadays don dey pass be kiafu abeg make gofment dey play dia part if not,pipo go kontiniu to read different meaning to democracy o!

Monday 22 April 2019

COMEDIAN 'ZELENSKY' DON WIN ELECTION TO BECOME PRESIDENT OF EASTERN EUROPE COUNTRY WEY HIN NAME NA 'UKRAINE'


Di jokers kominiti around di world don dey selibrate dia fellow comedian 'Zelensky' afta dem declare am as di winna of Ukraine presidential election.
Volodymyr Zelensky difit di current president Petro Poroshenko wey also kip pride for one corner and congratulate Zelensky.
Bifor di election, Comedian Zelensky na also film maker and we hope say he no go take him new position take joke.

Saturday 20 April 2019

DEM DON CANCEL THE JUNE 1st FIGHT BITWIN NAIJA BADDEST BOXER ANTHONY JOSHUA AND JARELL MILLER AFTA DEM FIND OUT SAY MILLER DON PACK DRUGS FULL HIM SYSTEM BIFOR Di FIGHT


If you be boxing fan and you dey follow up,you go don know say Naija baddest fighter Anthony Joshua fight wit American Jarell Miller suppose take place on di 1st of June 2019.
As you dey read dis tori like dis,dem don cancel di fight afta dem find out say Jarell Miller don swallow drugs wey fit givam killa punch full him bodi bifor di fight.
Anthony Joshua promoter Eddie Hearn don yarn now say,dem go find anoda challenger wey go fight di Naija killa puncha.

Tuesday 16 April 2019

ONE PASTOR 'PASTOR GIWA' DON YARN SAY MAKE WE STOP TO PRAY FOR DEAD PIPO BICOS E NO MAKE SENSE, INSTEAD,MAKE WE DEY PRAY FOR PIPO WEY DEY ALIVE


Pastor Giwa of di 'Awaiting the Second Coming of Jesus Christ Gospel Church' don yarn say,if you like make you pray for pesin wey don die from now till tomorrow,e no make one single sense since di pesin no dey physical for dis world again.
He say instead,make we dey use our church mind dey PRAY for pipo wey still dey alive bicos na dem naim need di prayers.

Friday 12 April 2019

RIVERS STATE GOVERNOR NYESOM WIKE DON DEY SING PEACE SONG GIVE 'AMEACHI' SAY MAKE DEM NO FIGHT AGAIN BUT JOIN HANDS TO MAKE RIVERS STATE GREAT AGAIN


If you dey follow naija politiks espeshali di River state wahala as e take concern Rivers state,you suppose know say,for over five years now di gofnor Nyesom Wike and him forma oga Rotimi Ameachi turn dem sef to cat and rat.
Di fight to boss ova Rivers politiks na real but afta Wike win di election for di state,him don come out dey beg Amesch say,make dem join hands to develop and make Rivers state a beta place for efribodi.
If you ask me,dis one na good move.

Thursday 11 April 2019

TORi WEY DEY REACH US BE SAY,FOR GOTV TO STILL DEY NIGERIA, DEM MUST DO SOMETHING ABOUT DIA OPERATION LICENSE IF NOT,BYE BYE NA DIA NAME


One of di DSTV unit 'GOTV' wey many Nigerians dey use see front wen e come to cable television bizness,dey expiriens hard times right now as e take concern dia operation license for naija.
Dem get problem wit federal govment wey dem dey try to solve and if dem no solve am quick,you fit hear say dem no dey Nigeria again.

Saturday 6 April 2019

SIMI DON YARN HER FANS SAY,SHE DON BAN YAHOO YAHOO BOYS FROM BUYING AND LISTENING TO HER MUSIC


Singa babe Simi don yarn say she don ban yahoo boys from buying and listening to her miuzik.
She yarn dis one during her joinbodi yarns wit her fans on top Instagram.
Dis table wey she dey shake so,hope say if e break she go get money to take call kapenta to repair ram?

Friday 5 April 2019

'NA DIA PAPA GET STROKE' ---MR IBU DON REPLY PIPO WEY DEY CARRY RUMORS SAY SERIOUS STROKE DON PINAM DOWN


One ugly news bin come out yestaday say MR Ibu don get stroke sickness and e dey veri veri sirios.
Akordin to di tori,dem say dem carry Mr Ibu go native doctor ospita and he dey responde to tritment.
But e no reach one hour naim Mr Ibu say na stupid rumors wey him enimis dey spread.
On top di vidio wey him and him wife bring out,he say na di rumor pipo papa dem get stroke nor be him.
Watch di video for bottom hia...


Thursday 4 April 2019

RAPPER 'ICE PRINCE ZAMANI' SAY,TO DEY PLAY GIRLS KONI KONI LOVE DON TIRE RAM SO DIAFOR,HIM DON READY TO MARRY AND SETTLE DOWN

Ice Prince and former girlfriend Maima
Oleku singa dat year Ice Prince don yarn tori pipo say him don tire to dey break girls heart upandan.
He say right now him don readi to marry and settle down.
Ice Prince get one 7 years old son wey one baby mama born foram.

Wednesday 3 April 2019

DAVIDO UNCLE 'ADEMOLA ADELEKE' HOPE OF BECOMING OSUN STATE GOVERNOR DON HIT ROCK AS ABUJA HIGH COURT DON FIND FAULT FOR HIM WAEC RESULT


Davido uncle Ademola Adeleke of di PDP need sirios prayers if he won still bikom di Gofnor of Osun state afta Abuja high court don pass judgement say him no qualify to be PDP flag bearer for di Osun  election wey dem do last year.
Although na APC pedin win di election but two weeks ago,di election tribunal declare Adeleke as di winner unto say magomago full di election.
Right now we dey wait Ademola Adeleke next action.

Monday 1 April 2019

BLACKFACE DON TAKE HIM QUARREL WIT 2FACE TO ANODA LEVEL AS HE DON BLOCK 2FACE FROM HIM PAGE ON TOP INSTAGRAM


From friends to brodas,from brodas to enemies, na wa o dis Blackface and 2face fight na problem o.
If you dey follow up,you go don notice say dis two pipo no dey agree again afta Blackface accuse 2face of stealing him songs.
As we dey talk like dis,di mata sef dey court but bifor di next judgement, Blackface don vex block 2baba from seeing anything wey concern him Instagram as e don block am.
Who go settle dis pipo quarrel?
Di mata dey worse evriday by day.

Thursday 28 March 2019

THE MAMA OF EGYPT SUPERSTAR FOOTBALLER 'MOHAMMED SALAH' DON DEY PARA SAY,SALAH FALL HER HAND AFTA PICTURE OF WIA SALAH HUG ONE FEMALE FAN SHOW FACE FOR INTANET


Mohammed Salah mama don dey para foram base on di picture wey come out online wia evribodi see wia Salah hug one female fan.
Salah mama say like say Salah papa eva do dis kain ting,not in for make her no comot for di marriage.
You know say moslems no dey like all dat kain ting espeshali wen di pesin no be ya wife.

Wednesday 27 March 2019

HIGHLIFE SINGER FLAVOUR, DON BUILD SCHOOL FOR BLIND PEOPLE FOR LIBERIA TO TAKE CELEBRATE HIM BLIND FRIEND 'SEMAH'


Eva since Flavour Nabania turn friend wit dat Liberia small boy Semah G. Weifur,he neva look back to see how he go take add value to di boy life.
He dey go Liberia go visit di boy,sometimes he go carry di boy come Nigeria come stay witam.
But now,Flavour don close eye build school for blind pipo for Liberia.
Flavour post dis tori on top him Instagram page.
Why some don dey say,blind pipo no dey him kontri?some don dey praise am for di beta job.

Monday 25 March 2019

NAIJA SINGA 'WAJE' DON CRY OUT SAY,MUSIC DON MAKE HER BROKE AND SHE NO GET MONEY TO PUT FOR HER MUSIC BIZNESS AGAIN



Waje, di auntie wey sing 'Do me,Do me' for Psquare song dat year,don cry out say,miuzik don finish all her money.
She say she don broke on top miuzik mata and she no get money to dey push her miuzik bizness again.
For inside the video wey dem don dey play for evriwia she say,her daughter school fees alone dey givam headache so diafor,make miuzik dey one corner.
Watch di video for bottom hia...


Sunday 24 March 2019

PATIENCE OZOKWOR a.k.a 'MAMA G' DON YARN TORi PIPO SAY,E STILL DEY PAIN AM SAY HER FAMILY NO ALLOW HER MARRY Di MAN OF HER CHOICE WEN SHE YOUNG


If you dey follow up,you sopose know di no nonsense Mama G of nollywood base on di way she dey show pipo pepper for all her films.
Mama G wey her real name na Patience Ozokwor don yarn tori pipo say,she still dey bitter say dem no allow her marry di bobo wey she plan to marry wen she still dey young.
She say in those days na arranged marriage dey reign welwell as most times na ya famili dey choose who you go marry for you.

Friday 22 March 2019

DAVIDO DON YARN SAY,ONE DAY HIM GO TRY HIM ACTING SKILLS FOR INSIDE NOLLYWOOD AND NA JAGUDA ROLE HIM GO LIKE TO DEY ACT


Supastar Davido don yarn tori pipo him dey nollywood wit corner eye.
He say him get mind to enta film acting one day but sha him no say na bigina for dat kind mata.
He say if he finally get di chance,him go like to dey act jaguda part.

Tuesday 19 March 2019

MAKOSSA MUSICIAN 'KOFFI OLOMIDE' FROM CONGO DON RECEIVE 2 YEARS PRISON SENTENCE AFTA HE RAPE 15 YEARS OLD GIRL


One of di most popular voice for Makossa miuzik 'Kofi Olomide' don  enta wahala afta court find am guilty onto say he rape 15 years old girl.
Dem givam two years suspended jail sentence for France and dis one mean say,dem no go waste time to arrestam if he enta any kind of wahala again.
Koffi Olomide wey be graduate of matimatics, get many of kerewa case wey dey hang for him head.
Even di girls wey dey dance and sing foram don bin confess say di man dey force dem sleep wit dem.

Monday 18 March 2019

GOVMENT DON GIVE PROMOTION TO THE CUSTOM MAN WEY REJECT OVER N150 MILLION BRIBE FROM Di MAN WEY WAN SMUGGLE 41 CONTAINERS OF TRAMADOL ENTA NAIJA


As pipo wey bad plenti rish for naija,me and some few good ones still dey.
Di custom man from di Apapa area command Lagos,wey reject $420,000 bribe,don get promotion from gofment.
$420,000 for Nigeria naira na ova 150 millions.
Di bribe come from pipo wey bin won shift 41 containers of tramadol enta naija but dis man stand gidigba say no way! I can't allow una pass.
Many pipo don dey vex for di man say him for collect di money bicos di money too handsome.
Some say di money wey dem go add join him salary fit no pass 50k.
If na me be di man I for rejectam too.
I know say una no go won biliv.

Saturday 16 March 2019

VICE PRESIDO AND PRESIDENT BUHARI SECOND IN COMMAND 'YEMI OSINBAJO' DON YARN TORi PIPO SAY,OGA BUHARI DON POOR PASS Di WAY WEY HE POOR BEFORE FOR 2015


Vice presido Yemi Osinbajo don yarn tori pipo say, President Buhari poorness level don pass church rat own.
He yarn dis one during di joinbodi groove wey him arrange wit pipo wey carry 'vote for APC campaign' for head during di elections wey just finish.
Akordin to Osinbajo he say,Buhari don poor pass di way wey him poor for 2015 wen he turn president.
Na wa for politishans sef!
Weda you dey support APC or PDP,all of us know how Oga Buhari look like di first time wen he enta Aso Rock.
Even I Go Dye neck dey learn for wia him neck dey.
Fast forward to today,di man don fresh like fresh bons wey dem just fry finish.
So Mr Osinbajo we nor undastand you at all,
Abi yarns don finish for ya mouth like comedian wey dey start work new?

Friday 15 March 2019

FOR EKITI STATE,GOVNOR FAYEMI DON SIGN THE LAW WEY GO MAKE DEM PUT ANYBODY WEY THIEF NEPA PROPATiS FOR PRISON FOR TWO YEARS


If you be jankoliko and you speshalise to dey tiff NEPA equipment and propatis,my broda,na inside prison for two years dem go throw you put.
Akordin to Ekiti state gofnor Kayode Fayemi wey just sign dis law for di state,if dem gbab you for di state dey tiff NEPA wire,na inside prison you and moskitos go dey romance una sef.
Na di message wey di gofnor say make I yarn una be dis.

Wednesday 13 March 2019

VICTOR AD,THE BOBO WEY SING DAT OGBONGE JAM 'WETIN WE GAIN' DON YARN SAY BY DIS TIME LAST YEAR HIM NO GET PASSPORT BUT TODAY HE DEY GO DUBAI LIKE SAY NA BACKYARD


Wen grace of God arrive your life,e no get anytin wey anybodi fit do about am.
Dis na di stori of di bobo wey sing 'Wetin we gain' if we no make money.
Him name na Victor AD.
Last year dis kain time di guy say,him no even get travelling passport not to talk of to dey travel to obodo oyibo but today,him dey go Dubai anyhow like say naim backyard.
Baba we thank God for ya life as I dey beg evri naija pesin make dem kontiniu to pray for grace as one day na one day evriwia go stew.

Sunday 10 March 2019

FOR PARAGUAY,'LIBERTAD DE PARAGUAY' DON SACK DIA COLOMBIA COACH (LEONEL ALVAREZ) WEY SLEEP WIT HIM PLAYER (EDGAR BENITEZ) WIFE


As women plenti rish,na your player wife kon enta your eye!
Well,if you neva hear,Colombia born coach Leonel Alvarez wey dey coach Libertad de Paraguay of Paraguay don resiv sack leta just like dat afta dem find out say he dey sleep wit him player wife.
Edgar Benitez naim be di player wey di coach dey sama him wife but di wife don dey cry out say na lie say nothing like dat dey appun.
Na wa o,di thickness of dis tori dey give me fever.
Sirios ogberaga tori.

Saturday 9 March 2019

AKPAKO MASTER AND DADA BOY 'TERRY G' DON YARN SAY,UP TILL TODAY HIM PAPA AND MAMA STILL DEY VEX SAY HE CARRY DADA FOR HEAD


Terry G di bobo wey Naija know as Akpako masta,don yarn tori pipo say,him papa and mama still dey vex foram till today say he carry dada put for head like pineapple flawa.
Dem don buy scissors kip since but di way wey di mata dey go so,e be like say dem neva fit pin Terry G down to take di dada down once and for all.
Terry G parents bin want make di bobo be pastor but a Terry G head no carry am.

Friday 8 March 2019

DAVIDO DON BOAST SAY HIM DEY SPEND N36 MILLION EVERY WEEK


Omo babolowo imsef Davido don yarn say him dey spend nothing less than $100,000 dollars evri month.
For naija naira dat na about N36 million.
Davido wetin dey wida?
Dangote wey worth billions of naira can't come out come tell us say him dey spend 36 million evri week.
Di only ting wey go make biliv naim if he yarn day na salary for him workas.

Tuesday 5 March 2019

GOOD NEWS AS NIGERIA DON OVERTAKE EGYPT AS AFRICA NUMBER 1 RICE PRODUCER


Akordin to di Direktor-General,Africa Rice Center,Benin Republic,Dr Harold Roy-Macauley,Nigeria don ovatake Egypt as Africa nomba 1 rice producer wit 4 million tones a year.
Egypt bin dey produce 4.3 million a year but e reduce wit ova 40% afta Egypt gofment limit dia rice cultivation so dat dem go fit save water resources.
No be lie dis one be at all as na so so local and home rice without stones naim full our market but di only ting be say e neva rili cheap to buy.
To show say dis our overtakement no be scam,make dem try comot small money on top di price of rice.
E go make sense.

Monday 4 March 2019

PASTOR ADEBOYE DON YARN HIM RCCG CHURCH MEMBERS SAY,E GET ONE MORNING WEY HIM AND GOD DRINK TEA TOGEDA


The Redeemed Christian Church of God GO Pastor Enoch Adeboye,don yarn say,e get one morning wey him say make him drink tea,bifor he say make he start to shack di tea,God just appear from heaven and join am.
He say na two of dem kon drink di tea togeda laslas.
Hmmm,make I no yarn anytin.
Make I just kwayet.
Make me sef go find tea drink too,anytin can appun.

Sunday 3 March 2019

TOP COMEDIAN 'ALI BABA' DON YARN SAY,FROM NOW ON,NA THUNDER GO FIRE ANYBODi WEY THIEF NIGERIA MONEY AGAIN


Ali Baba don dey swear for naija politicians say thunder naim go fire any of dem wey thief our money from now on.
Afta di comedian post thunder wey skata tree on top him Instagram page,he kon yarn say na dat kain thunder naim go fire any politician wey go chop govment money again.
But Ali Baba,dis politicians dey contract you to do MC work for dem.
What if na stolen money dem take dey hire you since?

Thursday 28 February 2019

FEDERAL GOVMENT DON SHARE N610.36BILLION NAIRA GIVE FEDERAL SERVICE, STATE AND LOCAL GOVMENT AREAS FOR Di MONTH OF FEBRUARY


If you be civil servant and dem neva arrange your salary give you,naim be say tori don dey enta be dat.
Why be say,federal gofment don share N610.36 billion give both state and local gofments plus even the federal service too.
No need to fear sha as I biliv say di money go reach evri evri.

Wednesday 27 February 2019

PRESIDENT BUHARI DON FLAT ATIKU ABUBAKAR TO PIECES TO CONTINUE AS PRESIDENT FOR ANODA 4 YEARS FOR THE PRESIDENTIAL ELECTION RESULT WEY INEC RELEASE


President Muhammadu Buhari of APC don win Atiku Abubakar of PDP for di preidential election afta INEC announce say Buhari score 15,191,847 to win Atiku wey score 11,262,978.
Dat na ova 4 million votes naim Sai Baba take win Atiku but as e be so,PDP don come out dey spit fire say,na pure magomago naim APC do to take win dis election.
E be like say na court go end am as dem don reject di result.

Saturday 23 February 2019

2 SECONDS AS DAY BREAK,ELECTION DON START TODAY TO TAKE CHOOSE PIPO WEY GO RULE NIGERIA FOR Di NEXT 4 YEARS ESPECIALLY WHO GO BECOME PRESIDENT


Afta dem postpone di election from last Saturday to today,finally Nigerians don dey vote for who go rule dem for di next four years.
Today ns elections for house of reps,senate and presidential election.
Report wey dey enta our tori room be say,crowd rili come out to vote.

Friday 22 February 2019

FORMA SUPER EAGLES PLAYER 'OSAZE ODEMWINGIE' DON YARN TORi PIPO SAY,70% OF AFRICAN PLAYERS BILIV IN JUJU POWER


Forma Super Eagles winga Osaze Odemwingie don yarn say 70% of football players wey be Africans biliv say juju na evritin for football.
 He say Africa players biliv juju sotay if dem injure,dem biliv say na juju man medicine naim go cure dem.

Tuesday 19 February 2019

Monday 18 February 2019

GUN MEN DON KILL APC CHAIRMAN BONIFACE OKOLOHO OF IHIMINI LOCAL GOFMENT AREA FOR BENUE STATE


Elections neva rili start but killings don start.
APC chairman for Ihimini local gofment area for Benue state don die just like dat afta gun men kpai am.

Saturday 16 February 2019

DAVIDO TO WIZKID: YOU DEY JEALOUS ME BICOS I DEY MAKE PLENTi MONEY PASS YOU


Friends today enemies tomorrow,dat na di relationship wey Davido and Wizkid dey kip.
Afta dem settle dia quarrel ova a year ago,e be like say dem don wake dia beef up again.
If u dey follow up,you go don notice say Davido dey chook bodi for politiks nawadays since him uncle Senator Adeleke fight to be gofnor of Osun state.
Just last week,Davido join PDP big boy Atiku go campaign for Port Harcourt.
Unto dis kain selebritis campaign for politishians,Wizkid non yarn some days ago say,make naija pipo use dia own brain choose who dem biliv say,na beta leader wey we go need.
He say make una no do follow follow bicos selibritis don kolet politishians money put for pocket and bigin shout upandan.
Davido no kuku waste time to yab Wizzy back as he say bodi go pepper Wizkid die.
He say Wizkid dey jealous am bicos he dey make beta bar passam.

Friday 15 February 2019

THE SHORT BLACK BOY 'M.I ABAGA DON YARN TORi PIPO SAY, WIZKID REJECT VERi BIG MONEY DURING ONE JOINBODi MEETING WEY DEM ENTER WIT POLITICIANS WEY DEY FIND VOTES


Chocolate city and one of naija best rapper 'M.I' don yarn say,Wizkid reject one stupid big money wey politicians promise am.
He say for dat joinbodi meeting,him dey dia,Olamide and Wizzy dey plus oda pipo.
M.I say during di meeting na only Wizkis reject di big money wey dem promise.

Wednesday 13 February 2019

WIZKID DON ADVICE NIGERIANS SAY,MOST CELEBRITIES DON COLLECT POLITICIANS MONEY PUT FOR POCKET,MAKE U NO LET DEM DECEIVE U INSTEAD VOTE FOR WHO U BILIV SAY GO MAKE NAIJA BETA


Wizkid don call most of him fellow selibritis scam bicos dem don kolet politicians money put for dia big pocket to support dem.
Now he don dey beg fans of those kain selibritis make dem no jonz for di election mata wey dey ground and make dem no do follow follow but instead make dem vote for candidates of dis choice wey dem biliv say go make naija beta.
He say time don reach for us not to dey do follow follow but to use our brain.
Beta yarns Wizzy.

Tuesday 12 February 2019

NEWS WEY DEY REACH OUR TORi ROOM NA THE RUMOR SAY,2FACE AND ANNIE MARRIAGE DON DEY GROW K-LEG


Di way wey 2face dey write and delete tings for twitter konsigning marriage yarns don dey give him fans sleepless nights.
As if dat one no reach,even Annie Idibia him wife dey join dey write some kain tings wey dey worry dia fans.
Rumors dey come say dia marriage get problem but we Neva rili know weda truth dey di mata.

Monday 11 February 2019

SAD SUNDAY FOR CHELSEA FANS AS MAN CITY NEARLY BURY CHELSEA WIT GOALS AS DEM WIN DEM 6 KONDO


Manchester City don show say dia rise to di top of England football no be by luck as dem nearly use goals take spell Chelsea name.
Dem score Chelsea 6 wicked kondo and none of di goals sef be penariti. 
I no know wen Chelsea fans go rekova  from dis trashing bicos all Di players dey play like say dem soak dia legs for portorportor. 
Weda chairman Abrahimovic go tell him seketri to type sack letter today or he go sorry for Sarri wey be di coach, na dat one we neva know.
For now, make I go sidon for fence dey monitor my malam radio weda I go hia  any tori as e take konsign dis London club. 

Sunday 10 February 2019

APC NATIONAL CHAIRMAN ADAMS OSHIOMOLE DON YARN TORi PIPO SAY,BUHARI NA Di ONLY NAIJA PRESIDENT WEY NO PRIME MINISTER FOR BRITAIN DON CALL THIEF


Forma Edo state gofnor and prezent APC national chairman Adams Oshiomole don blast PDP say koroption dey dia blood.
He say na only Buhari naim all di prime ministas wey Britain don get neva call thief.
Akordin to Oshiomole PDP no dey dis class of beta leaders.

Friday 8 February 2019

HURRAY!!! AFTA THREE MONTHS,ASUU DON FINALLY CALL OFF DIA STRIKE MAKE UNiVASiTi STUDENTS FIT GO BACK TO SCHOOL


Di Academic Staff Union of Univasitis,ASUU don finally chop beans and rice for di same plate wit federa gofment as dem don call off dia strike.
Di union presido Biodun Ogunyemi naim announce dis one for Abuja yestaday afta dem settle dia money fight wit gofment.
Thank God,at lis our students fit dust di cobwebs wey don dey gada dem brain and go back to class and learn book.

Wednesday 6 February 2019

PDP MAN ATIKU WEY DEY TRY TO BE NAIJA PRESIDENT FOR NEXT WEEK ELECTION,DON CALL DAVIDO THE KING OF NIGERIA MUSIC


Abubakar Atiku di man wey dey try to bikom una president for next week election, don yarn tori pipo say, Davido naim be king of naija music.
He say wen him young him leg no dey comot for Fela shrine bicos Fela na di nomba one dat time but for now, na Davido dey wear di crown.
Davido imsef don thank Atiku as he call am di king.
Although many pipo don come out to say dem no surprise since Davido and Atiku na PDP dem two dey,dem get right to dey famz dem sef.

Tuesday 5 February 2019

FEDERAL GOVERNMENT DON ANNOUNCE SAY,BIFOR Di END OF THE YEAR, DEM GO STOP TO IMPORT OBODO OYIBO TIN TOMATOES ENTA NAIJA


Federal gofment don dey harsh anoda plan as e take konsign tomato farming mata.
Di minista of agriculture Mr Audu Ogbeh don yarn tori pipo during him visit to Dangote tomato processing firm for Kadawa,Kura local govment area for Kano state say,bifor di end of 2019,dem go stop to import obodo oyibo tin tomatoes enta di kontri.
Did one na to enkorage our own tomatoes wey we get for hia.
For di world,naija na numba two for tomato production.

Monday 4 February 2019

TUNDE TDOT,ONE OF THE MEMBAS OF THE GBEDU SQUAD 'STYL PLUS' DON YARN TORi PIPO SAY,GIRLS WEY GET BIG BAKASSI NO DEY TRIPAM



If you dey follow up,you sopose know the gbedu group 'Style plus' wey skata evriwia wit dia koret jams in those years wey gbedu wit yankee touch start for naija.
One of di memba of dat squad Tunde Tdot don yarn tori pipo say,di kain woman wey him like must get bakassi wey no too big and no too small.
He say girls wit big yansh no dey tripam at all.
Di bobo say,even bifor him marry him wife for 2010,he don dey avoid girls wit big ikebe like acid.
I biliv say Tunde dey speak for him sef not evribodi.
I know plenti guys wey fit die for big yansh mata.

Sunday 3 February 2019

IPOB OGA 'NNAMDI KANU' DON TELL TORi PIPO SAY NA CAMEROON ATIKU COME FROM BUT ATIKU IMSEF DON SAY NA BIG LIE


Nnamdi Kanu di IPOB Biafra oga,don yarn tori pipo say,PDP presidential pesin Atiku Abubakar na Cameroon man.
Nnamdi Kanu say di area wey Atiku come from for Adamawa state na inside Cameroon e dey.
But Atiku imsef don come out to say make Kanu shut up say y na big lie di man dey lie for him head.

Friday 1 February 2019

GHANA STAR ACTRESS 'YVONNE NELSON' DON SWEAR SAY,NOTHING GO MAKE HER RUN FOLLOW NAIJA MAN AGAIN AFTA IYANYA TAKE HER HEART ROB GROUND


One of Ghana top actress Yvonne Nelson don swear say ova her dead bodi say she date Nigeria man again afta wetin she don pass thru for dia hand.
Di mother of one say she dey find new boyfriend and she go prefa Ghana man.
If you dey follow up,you go notice say no be small ting iyanya use di girl heart see as he break her heart afta di girl don fall in love witam.

Wednesday 30 January 2019

TANZANIA STAR 'DIAMOND PLATNUMZ' DON DEY BEG DIA GOVMENT MAKE DEM DECLARE HIM MARIAGE PUBLIC HOLIDAY MAKE ALL HIM FAMILY MEMBERS FIT ATTEND



Diamond Platnumz don kneel down dey beg di Tanzania gofment make dem declare him marriage day as public holiday so dat him famili membas go fit liv work attend di marriage.
Although him bin don get Pikin wit him baby mama bifor but now him don decide to marry him Kenya model girlfriend Tanasha.
Him bin fix di marriage for Valentine day but bicos Tanasha mama go dey work dat day,him kon shiftam go front small make di babe mama fit show for di ground.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...